Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • fg lesson 1 ques. 1-3
  • Wetin Be the Good News?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin Be the Good News?
  • Good News Wey Come From God!
  • Similar Material
  • Wetin God Get for Mind for This Earth?
    Good News Wey Come From God!
  • Who God Be?
    Good News Wey Come From God!
Good News Wey Come From God!
fg lesson 1 ques. 1-3

LESSON 1

Wetin Be the Good News?

1. Wetin be the news wey come from God?

People dey enjoy life for earth

God want make everybody for this world enjoy life. Because e love us well well, e make this world and everything wey dey inside. Na small time remain, God go make our tomorrow better. E go comot all the things wey dey make us suffer.—Read Jeremiah 29:⁠11.

No government don fit comot sickness, war, and die die wey full everywhere today. But better news dey o. Small time, God go use im Kingdom scatter all this government, and that Kingdom go remain. All the people wey support this Kingdom go enjoy better life, where wahala no go dey again.—Read Isaiah 25:8; 33:24; Daniel 2:⁠44.

2. Why we no suppose use the good news play?

When God go comot all the bad people for this world, suffer suffer go end. (Zephaniah 2:⁠3) Which time that one go take happen? Bible don talk am sey for our time, bad bad things go dey happen. Wetin dey happen for this world today show sey the time wey God go take comot all the bad bad people don dey reach.—Read 2 Timothy 3:​1-5.

3. Wetin we go come do?

E good make we learn about God from Bible, because e be like letter wey come from papa wey like im pikin well well. E tell us how we go take enjoy life now and how we go take get life wey no go end. True true, some people no go like am as you dey learn Bible. As God don promise us sey our tomorrow go better, e no go good make you let anybody spoil your chance to get that promise.—Read Proverbs 29:25; Revelation 14:​6, 7.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share