Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • fg lesson 2 ques. 1-5
  • Who God Be?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Who God Be?
  • Good News Wey Come From God!
  • Similar Material
  • Who God Be?
    Wetin Bible Dey Teach Us?
  • How You Go Take Near God?
    Good News Wey Come From God!
Good News Wey Come From God!
fg lesson 2 ques. 1-5

LESSON 2

Who God Be?

1. Why e good make we serve God?

Na God make everything. God no get start and e no go get end. (Psalm 90:2) Na im give us the good news wey dey inside Bible. (1 Timothy 1:11) Make we worship only am because na im give us life.—Read Revelation 4:11.

2. Which kind person God be?

Nobody don see God before because e be Spirit. (John 1:18; 4:24) If we look all the things wey God make, we go know the kind person wey e be. For example, all the different different food wey we get show sey God love us well well. Even as heaven big reach dey show us sey God get power well well.—Read Romans 1:⁠20.

Bible dey tell us wetin God like and wetin e no like. Bible still dey tell us how God dey treat people and how e take dey pain am when people dey do bad thing. So if we want know the kind person wey God be, make we dey read Bible.—Read Psalm 103:​7-10.

3. God get name?

God name, Jehovah, for different different language

Jesus pray sey: ‘Our father wey dey heaven, make your name dey holy.’ (Matthew 6:⁠9) Na only one name God get. For every language, the way dem dey call the name dey different different. For Pidgin na ‘Jehovah’ we dey call am. But some people dey call am ‘Yahweh.’—Read Psalm 83:18.

Today, some people wey translate Bible don remove God name from inside come put Lord or God. But that time wey dem write Bible, e pass 7,000 place wey God name show for inside. Jesus tell all the people wey e teach God name.—Read John 17:26.

4. E dey pain Jehovah for mind as people dey suffer?

One papa and mama dey care for their pickin wey dey sick

Like this papa wey love im pikin well well, God go do am make our tomorrow better

Jehovah like am as people dey suffer so? Some people dey talk sey na God dey test us with all this suffer suffer wey we dey suffer. But this one na lie.—Read James 1:⁠13.

As God don give us chance make we choose wetin we want, e no go good make we use am serve God? (Joshua 24:15) Wahala full everywhere today because some people dey make other people suffer. This one dey pain Jehovah for body.—Read Genesis 6:​5, 6.

Jehovah like us well well and e want make we enjoy life. Na small time remain, e go comot all the people wey dey make us suffer. For now, e get wetin make am never comot dem. For Lesson 8, we go know why.—Read 2 Peter 2:9; 3:​7, 13.

5. Wetin we go do to near God?

One woman wey dey pray to God

Jehovah want make we dey talk to am for prayer make we fit near am. God get all of us for mind. (Psalm 65:2; 145:18) Jehovah ready to forgive us because e know sey we dey try to make am happy. So we fit still be Jehovah friend, even if we dey make mistake sometimes.—Read Psalm 103:​12-14; James 4:8.

We suppose love Jehovah pass anything because na im give us life. (Mark 12:30) As we dey learn about God and dey do wetin e sey make we do, e show sey we love am. This one go make us near God well well.—Read 1 Timothy 2:4; 1 John 5:3.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share