LESSON 3
Na True Sey the Good News Come From God?
1. The message for inside Bible, who get am?
The good news wey dey inside Bible be sey people go get life wey no go end. (Psalm 37:29) Na 66 small small book dem join together take form Bible. Na 40 people God use write am. E don near 3,500 years wey Moses write the five book wey start Bible. E don pass 1,900 years wey apostle John write the last book for Bible. The message wey dey Bible, who get am? God use holy spirit take tell the people wey write Bible wetin dem go write. (2 Samuel 23:2) Na wetin dey God mind dem write, no be wetin dey their mind. So na Jehovah get the message wey dey inside Bible.—Read 2 Timothy 3:16; 2 Peter 1:20, 21.
2. How we go take know sey wetin dey inside Bible na true?
We know sey Bible come from God because everything wey e talk about our tomorrow na true. No man fit do that one. (Joshua 23:14) Na only God get the power to see everything wey go happen tomorrow.—Read Isaiah 42:9; 46:10.
Bible different from any other book. Dem don share am give many people wey dey speak different different language. Some of the things wey science talk don dey for Bible tey tey. Another thing be sey, even though sey na 40 different different people write Bible, wetin one person write gree with wetin the other person write.a Na only Bible fit tell us the kind love wey God get, and e still get the power to change people life from bad to good. Na this one make many many people believe sey na God get Bible.—Read 1 Thessalonians 2:13.
3. Wetin really dey inside Bible?
Bible dey tell us the better better things wey God go do for us. And e still tell us how Adam and Eve take lost that better life wey God give dem and how e go take bring am come again.—Read Revelation 21:4, 5.
Bible get better law and advice. E still tell us how God take do things with people before before—this one tell us the kind person wey God be. So Bible dey show us how we go take sabi God and how we go take be im friend.—Read Psalm 19:7, 11; James 2:23; 4:8.
4. How you go take sabi wetin dey inside Bible?
As Jesus take tell people God word, come even tell dem wetin e mean one by one, na so this book go take help you sabi wetin Bible talk.—Read Luke 24:27, 45.
As this good news sweet reach, some people no want hear am. E even dey vex other people. No let that one spoil your mind. Before you go fit get that life wey no go end, you must learn about God.—Read John 17:3.
a Read the book wey dem dey call A Book for All People.