Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • fg lesson 4 ques. 1-5
  • Jesus Christ, Who E Be?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Christ, Who E Be?
  • Good News Wey Come From God!
  • Similar Material
  • Jesus Sacrifice Na The Best Gift Wey God Give Us
    Wetin Bible Dey Teach Us?
Good News Wey Come From God!
fg lesson 4 ques. 1-5

LESSON 4

Jesus Christ, Who E Be?

1. How Jesus life take start?

1. Jesus for heaven; 2. Mary and Joseph dey with Jesus when e be small pikin; 3. When Jesus dey teach children

Which kind person Jesus be wey make people near am?—MATTHEW 11:29; MARK 10:​13-16.

Jesus no be like us, na angel e be for heaven before dem born am for this earth. (John 8:23) Na im God first make, and e help God make other things. Na im be the only person wey God use im hand make, no wonder Bible call am ‘only special’ Son. (John 1:14) Bible call Jesus ‘the Word’ because na im God dey use talk to us.—Read Proverbs 8:​22, 23, 30; Colossians 1:​15, 16.

2. Wetin make Jesus come this world?

God carry im Son life comot from heaven, come put am inside one woman belle wey never sabi man before, the woman name na Mary. Na im make Jesus no get papa for this world. (Luke 1:​30-35) Jesus come this world (1) to teach people the truth about God, (2) to show us how we go take serve God even if things hard for us, and (3) make e come die for us.—Read Matthew 20:28.

3. Why we need person make e come free us from our sin?

Sometimes, when bad people kidnap person, dem go need big money wey dem go take free am make dem no kill am. (Exodus 21:​29, 30) God no get am for mind make people dey old and make dem dey die. How we take know? God tell Adam wey be the first man sey if e sin, e go die. So if to sey Adam hear wetin God talk, e for no die. (Genesis 2:​16, 17; 5:5) Bible talk sey na from Adam death ‘enter’ this world. So, Adam pass sin and death to all im pikin. Na im make we need person wey go comot us from the sin wey Adam put us.—Read Romans 5:12; 6:23.

Who go come pay to comot us from sin, make we no die? When person die, e don pay for im own sin. Person wey no dey perfect no fit pay for other people sin.—Read Psalm 49:​7-9.

4. Wetin make Jesus die for us?

Jesus dey die for the pole wey dem nail am put and God come bring am come back to life and e dey rule as King for heaven

Jesus no be like us wey dey sin, e dey perfect. So e no suppose die as e no get sin. But e come die for our sin. No be small love God get for us o! Na im Son come die for us. Jesus self show sey e love us well well, as e gree to come die for us.—Read John 3:16; Romans 5:​18, 19.

5. Wetin Jesus dey do now?

When Jesus dey this earth, e make sick people well, e bring people wey don die come life again, and e help people wey dey for trouble. All this things wey e do show wetin e go do for people wey hear wetin God talk. (Matthew 15:​30, 31; John 5:28) After Jesus die, God wake am up as spirit. (1 Peter 3:18) Jesus come sitdown for God right hand dey wait until God go give am power make e be King. (Hebrews 10:​12, 13) Now, Jesus don be King for heaven and people wey dey follow am, dey preach that good news for everywhere for this world.—Read Daniel 7:​13, 14; Matthew 24:14.

E no go tey again, Jesus go use im power comot all the wahala wey dey for this world and people wey dey cause am. Everybody wey show sey dem believe Jesus go enjoy life for paradise for this earth.—Read Psalm 37:​9-11.

If you want learn more about this topic, read chapter 4 and 5 for this book What Can the Bible Teach Us?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share