Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • fg lesson 6 ques. 1-5
  • People Wey Don Die, We Fit See Dem Again?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • People Wey Don Die, We Fit See Dem Again?
  • Good News Wey Come From God!
  • Similar Material
  • God Go Bring People Wey Don Die Back to Life!
    Wetin Bible Dey Teach Us?
Good News Wey Come From God!
fg lesson 6 ques. 1-5

LESSON 6

People Wey Don Die, We Fit See Dem Again?

1. Wetin be the good news about people wey don die?

Mary and Martha dey happy because Lazarus don come back to life

E don reach four days wey Lazarus die before Jesus come Bethany wey dey near Jerusalem. Martha and Mary wey be Lazarus sister follow Jesus go where dem bury Lazarus. Before you know, people don gather. See as body come dey sweet Mary and Martha when Jesus wake Lazarus up.—Read John 11:​21-24, 38-44.

Martha know for im mind about the good news wey God don promise, sey e go bring people wey don die come life again.—Read Job 14:​14, 15.

2. Wetin dey happen to people wey don die?

When God make Adam, and when e die

God tell Adam sey: ‘Na from sand sand you come, and na there you go go when you die.’​—GENESIS 3:19.

Na sand sand God take make us. (Genesis 2:7; 3:19) We no get anything inside our body wey no dey die. So, nothing dey comot for our body if we die. When we die, we no go fit think anything again because our brain don die. Even as Lazarus wake up, e no talk sey e go anywhere, or sey e see anything because people wey don die no sabi anything again.—Read Psalm 146:4; Ecclesiastes 9:​5, 6, 10.

When people die, God dey burn dem for fire? As Bible don tell us sey people wey don die no sabi anything again, e don show sey this hellfire wey people dey teach na big lie wey dey spoil God name. Bible even talk sey God never think am before to burn person for fire.—Read Jeremiah 7:31.

3. People wey don die fit follow us talk?

People wey don die no fit talk and dem no fit hear anything again. (Psalm 115:17) Some angel bad. Dem dey follow people talk like sey na person wey don die dey follow dem talk. (2 Peter 2:⁠4) Jehovah no want make we dey ask anything from people wey don die.—Read Deuteronomy 18:​10, 11.

4. Which kind people God go bring come life again?

One man wey God bring come back to life for Paradise dey learn about am. The man come dey teach other people wey God bring come back to life.

Many many people wey don die go come life again. Even people wey do bad thing because dem never hear about God before dem die go come life again.—Read Luke 23:43; Acts 24:15.

The people wey God go bring come life again, go get chance take learn the truth about God and do wetin Jesus tell dem make dem do. (Revelation 20:​11-13) If this people wey go come life again do wetin good, dem go enjoy life wey no go end.—Read John 5:​28, 29.

5. As people wey don die go come life again, wetin e teach us about Jehovah?

Because Jehovah send Jesus make e come die for us, na im make people wey don die fit come life again. This one show us sey Jehovah love us well well. When people wey don die come life again, who you go want see?—Read John 3:16; Romans 6:23.

If you want learn more about this topic, read chapter 6, 7, and 10 for this book What Can the Bible Teach Us?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share