LESSON 5
Wetin God Get for Mind for This Earth?
1. Why God make this earth?
Jehovah make this earth for us. God no make Adam and Eve make dem stay heaven—E don already make plenty angel put for there. (Job 38:4, 7) God make the first man, come put am for one fine place wey dem dey call garden of Eden. (Genesis 2:15-17) Jehovah give Adam and all the pikin wey e go born chance make dem fit enjoy life wey no go end.—Read Psalm 37:29; 115:16.
Na only the garden of Eden be paradise before. God want make Adam and Eve born pikin full the earth. As time dey go, dem suppose make the whole earth paradise. (Genesis 1:28) God no go let anything happen to this earth, na we e make am for.—Read Psalm 104:5.
2. Wetin make this world never be paradise now?
Jehovah pursue Adam and Eve comot for that paradise because dem no do wetin e tell dem make dem do. Na so paradise no come dey again. Since that time, nobody don fit bring am back. Bible talk sey: ‘Bad people don spoil this world.’—Job 9:24.—Read Genesis 3:23, 24.
Jehovah never forget wetin e get for mind for us o! Na im get power pass, e no dey fail. (Isaiah 45:18) E go make us dey for that paradise again.—Read Psalm 37:11, 34.
3. How this earth go take be Paradise again?
When Jesus go start to dey rule, e go make this earth paradise again. Jesus and the angel dem go kill all the people wey no dey God side for the war wey Bible call Armageddon. Jesus go come put Satan for inside prison for 1,000 years. People wey dey follow God no go die because, Jesus go help dem. Dem go enjoy life wey no go end for that Paradise.—Read Revelation 20:1-3; 21:3, 4.
4. Which time this suffer suffer go end?
Which time God go comot all this bad bad things wey dey happen for this earth? Jesus tell us ‘wetin go dey happen’ wey go show sey the time wey God go comot all this bad bad things don near. All this things wey dey happen today show sey ‘that time don dey reach.’—Read Matthew 24:3, 7-14, 21, 22.
For that 1,000 years, Jesus go do two things. (1) E go comot everything wey dey make us suffer, because im na King wey go rule this earth. (Isaiah 9:6, 7; 11:9) (2) E go forgive the sin of the people wey love God. God go use Jesus comot sickness, old age, and we no go dey die again.—Read Isaiah 25:8; 33:24.
5. Which kind people go enter Paradise?
For our Kingdom Hall, you go meet people wey love God and people wey want do wetin e like
Na people wey follow wetin God talk go enter Paradise. (1 John 2:17) Jesus send the people wey dey follow am sey make dem teach people wey want learn how dem go take serve God. Today, Jehovah dey teach plenty plenty people wetin go help dem stay for Paradise. (Zephaniah 2:3) For the place wey Jehovah Witness people dey worship, wey dem dey call Kingdom Hall, people dey learn how dem go take be better husband and wife. Mama, papa and their pikin dey learn how the good news go take make their life better.—Read Micah 4:1-4.