LESSON 9
Wetin Your Family Go Do Wey Go Make Dem Happy?
1. Why e be sey if man and woman do marriage, e go make their family happy?
Jehovah want make all family dey happy. This good news come from Jehovah because im na happy God. (1 Timothy 1:11) Na im start marriage. E good make man and woman register their marriage because e go make dem and their pikin happy. For mariage matter, make Christian register as their government take talk.—Read Luke 2:1, 4, 5.
How God want make marriage be? E want make man and woman wey marry no leave theirself. Jehovah no want make husband follow another woman wey no be im wife, and e no want make wife follow another man wey no be im husband. (Hebrews 13:4) E no want make marriage scatter. (Malachi 2:16) Na only if one of dem go sleep with another person for outside, dem fit scatter the marriage, if dem want.—Read Matthew 19:3-6, 9.
2. Wetin husband and wife go dey do for theirself?
Jehovah make man and woman make dem dey help theirself if dem marry. (Genesis 2:18) Na husband suppose to dey bring wetin family need, and to dey teach dem about God, because na im be head for the family. The kind love wey husband go get for im wife na the one wey go fit make am do anything for am. Husband and wife must respect and love theirself. If husband and wife want make their marriage happy, dem go dey forgive theirself if dem make mistake.—Read Ephesians 4:31, 32; 5:22-25, 33; 1 Peter 3:7.
3. If wahala dey marriage, na to run leave the marriage?
If wahala dey your marriage, make two of una try settle am with love. (1 Corinthians 13:4, 5) Bible no talk sey make husband and wife leave theirself because of problem wey dem dey get for marriage.—Read 1 Corinthians 7:10-13.
4. Pikin, wetin God want make una dey do?
Jehovah want make una happy. E dey give una better advice wey go make una enjoy life as una dey grow. E want make una learn from una mama and papa because dem get sense pass una. (Colossians 3:20) Jehovah want make una dey happy as una dey try to do wetin im and Jesus want.—Read Ecclesiastes 11:9–12:1; Matthew 19:13-15; 21:15, 16.
5. Papa and Mama, how una go take make una pikin happy?
Make una try give una pikin wetin dem need, like food, house wey dem go stay and cloth wey dem go wear. (1 Timothy 5:8) If una want make una pikin dey happy, make una teach dem how dem go take learn about God and how dem go love am. (Ephesians 6:4) If your pikin see how you take love God, dem self go want love am. If you use Bible teach dem, dem go dey do the correct thing wey dem suppose do.—Read Deuteronomy 6:4-7; Proverbs 22:6.
Pikin go do well if una dey praise dem for the good thing wey dem do. E still good make una correct dem if dem do bad, and train dem so that dem no go spoil. (Proverbs 22:15) But if una want correct dem, make una no take am wicked dem.—Read Colossians 3:21.
Jehovah Witness people don write many book wey go fit help papa, mama, and pikin dem. All the things wey we write for our book, na from inside Bible we carry am.—Read Psalm 19:7, 11.