LESSON 10
How You Fit Know the Correct Way to Serve God?
1. Na only one correct way dey to serve God?
‘Make una shine una eye, because of fake prophet.’—MATTHEW 7:15.
Jesus teach the people wey dey follow am sey na only one way to serve God dey. That way be like road wey you go follow take get life wey no go end. Jesus talk sey people wey dey the road no plenty. (Matthew 7:14) Jehovah like only the worship of people wey dey follow wetin Bible talk and na one believe this people get.—Read John 4:23, 24; 14:6; Ephesians 4:4, 5.
2. Wetin Jesus talk about people wey dey pretend to be Christian?
‘Dem dey talk like sey dem know God, but wetin dem dey do show sey dem no sabi am at all.’—TITUS 1:16.
Jesus don warn us sey make we shine our eye because people wey dey pretend to be Christian go spoil people wey be better Christian. If you see dem, you go think sey dem be better Christian. Dem dey talk sey na dem be the correct Christian but you fit know the kind people wey dem be. How you go take know dem? Na their character go tell you the kind people wey dem be.—Read Matthew 7:13-23.
3. How you go take sabi better Christian?
See five way wey you go take sabi dem:
Correct Christian believe sey Bible come from God. Dem dey try well well to do wetin Bible talk. Na im make correct Christian no be like all this people wey dey pretend to be Christian wey dey use only their sense take dey teach. (Matthew 15:7-9) Better Christian dey do wetin dem dey preach.—Read John 17:17; 2 Timothy 3:16, 17.
Correct Christian dey respect God name wey be Jehovah. Jesus show sey e respect God name because e tell people the name. E help people sabi God. E even teach dem make dem pray sey make God name dey holy. (Matthew 6:9) For where you dey stay, which people you know wey dey teach people about God name?—Read John 17:26; Romans 10:13, 14.
Correct Christian dey preach about God Kingdom. God send Jesus make e come tell people good news about God Kingdom. Na this Kingdom be the only hope wey we get. Na this same Kingdom Jesus talk about till e die. (Luke 4:43; 8:1; 23:42, 43) E talk sey people wey dey follow am go preach about the Kingdom. If people come preach to you about God Kingdom, who you go think sey dem be?—Read Matthew 24:14.
Correct Christain no dey put hand for this wicked world matter. You go fit sabi dem as dem no dey put hand for politics matter and dem no dey fight because sey dem want make things change for their country. (John 17:16; 18:36) Dem no dey follow the bad bad things wey people dey do.—Read James 4:4.
Correct Christian love theirself well well. Dem dey respect everybody no matter where dem come from, na so Bible take teach dem. Even if people wey dey pretend to be Christian dey support war, correct Christian no dey join dem. (Micah 4:1-3) Instead make dem join dem, correct Christian dey use their time and money take dey help other people.—Read John 13:34, 35; 1 John 4:20.
4. If you see the correct Christian, you go know dem?
Which people dey teach wetin dey inside Bible? Which people still dey respect God name and use am? Which people wey you know wey dey preach sey na God Kingdom be the only hope wey we get? Which people dey show love? Which people no dey fight war? Wetin you think?—Read 1 John 3:10-12.