LESSON 12
How You Go Take Near God?
1. Na all prayer God dey hear?
God want make everybody pray to am, make dem fit near am. (Psalm 65:2) But no be all prayer e dey hear. For example, God no dey hear the prayer of husband wey no dey treat im wife well. (1 Peter 3:7) When people wey dey Israel that time pray, God no gree hear their prayer because dem no stop to dey do bad things. Make we know sey, prayer no be play play thing. But if bad person repent, God go answer im prayer.—Read Isaiah 1:15; 55:7.
2. How we go take pray make God hear?
Prayer na one way wey we take dey serve God. Na only Jehovah wey make us we go dey pray to. (Matthew 4:10; 6:9) And because we dey make mistake, make we dey use Jesus name pray as e be sey na im die for our sin. (John 14:6) Jehovah no want make we dey repeat the same thing for one prayer. E no want make we dey cram our prayer or dey read am from book. Wetin e want be sey, make we dey pray from our mind.—Read Matthew 6:7; Philippians 4:6, 7.
Even when we no pray come out, God go still hear our prayer. (1 Samuel 1:12, 13) God want make we dey pray to am anytime, whether we want sleep, or when we wake up, whether we want chop and even when we dey for trouble.—Read Psalm 55:22; Matthew 15:36.
3. Why Christian dey gather to serve God?
Because sey we dey live with people wey no believe God, e fit hard for us to serve God. (2 Timothy 3:1, 4; 2 Peter 3:3, 13) But if we gather together with people wey dey serve God, we go fit help ourself.—Read Hebrews 10:24, 25.
We go fit near God well if we dey follow people wey dey serve am. If you follow Jehovah Witness people go their Kingdom Hall, you go learn from their example.—Read Romans 1:11, 12.
4. How you go take near God?
If you dey take time dey think about wetin you dey learn from Bible, e go make you near God. Make you dey think about wetin you fit learn from wetin God dey do, wetin e want make you do, and wetin e go do for you. If we dey pray and we dey think about wetin we dey learn, we go know sey God get sense and e love us well well.—Read Joshua 1:8; Psalm 1:1-3.
You fit near God if you believe am, and if you trust am. As pikin take need food to grow, na so our faith be. If you want make your faith grow, you go need to dey think about wetin make you get that faith.—Read Matthew 4:4; Hebrews 11:1, 6.
5. Wetin we go gain if we near God?
Jehovah dey do people wey love am well. E go still protect dem from anything wey fit spoil their faith and their chance to get life wey no go end. (Psalm 91:1, 2, 7-10) E don warn us make we comot hand for anything wey fit spoil our body, and wey no go make us happy. Jehovah dey teach us the better way to take live our life.—Read Psalm 73:27, 28; James 4:4, 8.