LESSON 13
Wetin God Go Do People Wey No Dey Worship Am the Way E Want?
1. Na all the different different way wey people take dey worship God good?
People dey serve God for different different place with the mind sey dem go fit sabi God. Na better thing sey God dey see this kind people wey really want serve am. But the bad thing be sey, people wey pretend sey dem dey serve God dey use God name take dey do bad things. (2 Corinthians 4:3, 4; 11:13-15) As dem dey talk for news, people wey pretend sey dem dey serve God dey support war, and many bad bad things wey dey happen for the world today. This kind thing no dey make the people wey want serve God happy.—Read Matthew 24:3-5, 11, 12.
People wey dey worship God the correct way dey make am happy. But people wey no dey worship am well no dey make am happy, because wetin dem dey teach no dey Bible. Dem dey teach wetin no be true about God and about people wey don die. But Jehovah want make people know the truth.—Read Ezekiel 18:4; 1 Timothy 2:3-5.
2. Wetin God go do to the people wey no dey worship am the way e want?
The thing be sey, people wey dey pretend sey dem dey serve God no go fit deceive am. (James 4:4) Bible call the people wey dey pretend to serve God ‘Babylon the Great.’ After God use water destroy bad people for Noah time, e get one place wey dem dey call Babylon, na for this place all the bad bad way wey people take dey serve God take start. The time don near when Jehovah go destroy all the people wey dey use im name dey deceive people.—Read Revelation 17:1, 2, 5, 16, 17; 18:8.
Better news still dey o! Jehovah never forget all the people wey really want serve am even if dem never start to dey serve am the way e want now. E dey gather this kind people together and e dey teach dem wetin dey inside Bible.—Read Micah 4:2, 5.
3. Wetin people wey want really serve God go do?
People wey dey serve God the correct way get one mind
Jehovah dey help people wey want really know wetin Bible talk. E dey warn dem sey make dem comot from where dem no dey serve am well. People wey love Jehovah ready to do anything wey go make am happy.—Read Revelation 18:4.
When Jesus apostle preach to people wey want really serve God that time, dem happy well well. This people come learn how to live better life wey go give dem hope. Wetin dem hear help dem serve Jehovah well. E go good make we be like dem.—Read 1 Thessalonians 1:8, 9; 2:13.
Jehovah dey happy as e dey see people wey stop to dey follow the bad way to serve am. E go sweet Jehovah for mind if you join the people wey really dey serve am. If you join people wey dey serve Jehovah, you go be Jehovah friend and you go enjoy life wey no go end.—Read Mark 10:29, 30; 2 Corinthians 6:17, 18.
4. How God go take make people for everywhere happy?
Na good news sey God go soon remove people wey dey pretend to serve am. Everybody go get rest of mind. People wey dey pretend to serve God no go dey again, and everybody go be one family. Na only Jehovah everybody go dey worship.—Read Revelation 18:20, 21; 21:3, 4.