Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • yc lesson 8 pp. 18-19
  • Josiah Get Many Better Friend

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Josiah Get Many Better Friend
  • Teach Your Pikin
  • Similar Material
  • Josiah Love God Law
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Teach Your Pikin
yc lesson 8 pp. 18-19
King Josiah hear wetin im friend Jeremiah talk

LESSON 8

Josiah Get Many Better Friend

You think sey e hard to do wetin dey good?— Many people think sey e hard. Bible tell us about one boy wey do good even when e hard. Im name na Josiah. But e get many better friend wey help am. Make we learn about Josiah and some of im friend.

Josiah papa na king for Judah, im name na Amon. Amon bad well well, and e still dey serve juju. When e die, na Josiah come be king. Na only eight years Josiah be when e be king! You think sey e bad like im papa?— E no bad like am.

Prophet Zephaniah tell judah people wetin Jehovah send am

Zephaniah warn the people make dem no serve juju

Even when Josiah dey small, e ready to do wetin Jehovah want. So na only people wey dey do wetin Jehovah want, na im e take as im friend. And dem help Josiah do wetin good. Who be some of im friend self?

One of Josiah friend na Zephaniah. Zephaniah na prophet wey warn the people for Judah sey bad thing go happen to dem if dem serve juju. Josiah hear wetin Zephaniah talk. E no serve juju, na Jehovah e serve.

Another person wey be Josiah friend na Jeremiah. Jeremiah and Josiah want be the same age, dem grow up for the same area. Dem be better friend sotey when Josiah die, Jeremiah write one special song about how e take miss Josiah. Jeremiah and Josiah help theirself to do wetin good and to do wetin Jehovah talk.

Josiah and Jeremiah help theirself do wetin good

Wetin you learn about Josiah example?— Even when Josiah na small boy, e ready to do wetin good. E know sey na people wey love Jehovah e go be friend with. Try to choose friend wey love Jehovah and wey fit help you do wetin good!

READ AM FOR YOUR BIBLE

  • 2 Chronicles 33:21-25; 34:1, 2; 35:25

QUESTION:

  • Who be Josiah papa? Na good thing e do?

  • Even if Josiah na small boy, wetin e want do?

  • Wetin be the name of Josiah two friend?

  • Wetin you learn about Josiah example?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share