Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • yc lesson 9 pp. 20-21
  • Jeremiah No Stop to Dey Talk About Jehovah

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jeremiah No Stop to Dey Talk About Jehovah
  • Teach Your Pikin
  • Similar Material
  • Jehovah Send Jeremiah Go Preach
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Get Strong Mind Like Jeremiah
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
Teach Your Pikin
yc lesson 9 pp. 20-21

LESSON 9

Jeremiah No Stop to Dey Talk About Jehovah

People wey dey vex gather Jeremiah

Why this people dey vex for Jeremiah?

People dey draw Jeremiah comot for the deep hole wey potopoto dey

Jehovah save Jeremiah

Sometimes when we dey talk about Jehovah, some people dey laugh us, other people dey even vex for us. This one fit make us want stop to dey talk about God. E don happen to you before?— Bible tell us about one young man wey love Jehovah. But na small remain, e for stop to dey talk about Jehovah. Im name na Jeremiah. Make we learn more about am.

When Jeremiah still dey young, Jehovah tell am sey make e warn people make dem stop to dey do bad things. This one no easy for Jeremiah na im make am dey fear. E come tell Jehovah sey: ‘I no know wetin I go talk. Na small pikin I be.’ But Jehovah tell am sey: ‘No fear. I go help you.’

Na so Jeremiah start to dey warn people sey if dem no change, Jehovah go punish dem. You think sey the people do wetin Jeremiah talk?— No. Na so so laugh dem dey laugh am, dem still dey vex for am. Some even want kill am. How you think sey Jeremiah feel?— E dey fear, and e come talk sey: ‘I no go talk about Jehovah again.’ But na true sey e stop to talk about Jehovah?— No o, e no stop. The love wey e get for Jehovah no make am fit stop to dey talk about am. And because e no stop, Jehovah save am.

For example, e get one time wey bad people trowey Jeremiah inside one deep hole wey potopoto dey. E no see food chop, and e no see water drink. Those people want leave Jeremiah make e die for there. But Jehovah help am comot for the hole, e no die!

Wetin you learn from Jeremiah example?— Even if e dey fear sometimes, Jeremiah no stop to dey talk about Jehovah. When you dey talk about Jehovah, people fit laugh you or vex for you. This one fit make you dey shame or even dey fear. But no let that one stop you to dey talk about Jehovah. As Jehovah take help Jeremiah, na so e go take help you everytime.

READ AM FOR YOUR BIBLE

  • Jeremiah 1:4-8; 20:7-9; 26:8-19, 24; 38:6-13

QUESTION:

  • Wetin Jehovah tell Jeremiah make e do?

  • Why Jeremiah nearly stop to dey talk about Jehovah?

  • How Jehovah take help Jeremiah?

  • Wetin you learn from Jeremiah example?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share