LESSON 10
Jesus Dey Do Wetin Im Papa and Mama, and Jehovah Talk
Everytime wey your mama and papa tell you make you do something, e dey easy for you to do am?— E dey hard sometimes. You know sey Jesus do wetin Jehovah, im mama and im papa talk?— Jesus example fit help you do wetin your mama and papa talk even if e no easy. Make we learn more about im example.
Before Jesus come this world, e don dey heaven with Jehovah, im Papa. But when e come this world, e still get papa and mama. The name of im papa na Joseph and im mama na Mary. You know how dem take be im papa and mama?—
Jehovah do miracle. E make Jesus grow inside Mary belle as other pikin dey grow for inside their mama belle. Around nine month, Mary born Jesus for this world. Na so Mary take come be Jesus mama, and Joseph come be im papa for this world.
Jesus do something wey show sey e love Jehovah im Papa, even if na 12 years e be. This one happen when Jesus and im family dey travel go Jerusalem go do Passover. Passover na the day wey Israel people dey remember how Jehovah save dem from Egypt. When Jesus family dey road dey go house back, Joseph and Mary no see Jesus, dem come dey find am. You know where Jesus go?—
Wetin make Jesus dey for temple?
Joseph and Mary rush go Jerusalem back go find Jesus. Their mind no rest because dem no see am. After three days wey dem don dey find am, dem see am for inside temple! You know wetin make Jesus dey for inside temple?— Na because sey na for there e go fit learn about Jehovah. Jesus love Jehovah and e want learn how e go take do wetin e want. Even when Jesus don big, e still dey do wetin Jehovah want. Jesus do wetin Jehovah want even when e go suffer. You think sey Jesus still dey do wetin Joseph and Mary want everytime?— Yes, Bible talk sey e do wetin dem want.
Wetin you learn from Jesus example?— Even when e hard for you, e good make you dey do wetin your mama and papa tell you. You go do wetin dem tell you?—
READ AM FOR YOUR BIBLE
Luke 1:30-35; 2:45-52
Ephesians 6:1
Hebrews 5:8