CHAPTER 17
Jesus Teach Nicodemus for Night
JOHN 2:23–3:21
JESUS DEY TALK WITH NICODEMUS
WETIN E MEAN TO BE “BORN AGAIN”
For 30 C.E., when Jesus come do Passover for Jerusalem, e do many miracle. Many people come begin get faith for am. One Pharisee wey im name na Nicodemus, na one of the Jew people leader for their high court wey dem dey call Sanhedrin. E really like the things wey Jesus dey do, and e want learn more. E come go meet Jesus for night. Maybe na because e dey fear sey if people see am, e fit spoil im name.
Nicodemus tell Jesus sey: “Rabbi, we know sey you be teacher wey come from God, because nobody fit do all this things wey you dey do unless God dey with am.” Jesus come answer am sey before person go fit enter God Kingdom, the person must be “born again.”—John 3:2, 3.
But, how dem go take born person again? Na im Nicodemus come ask Jesus sey: “E no go fit enter im mama belle the second time, make dem born am again, e go fit?”—John 3:4.
No, no be wetin born again mean be that. Jesus talk wetin e mean, e sey: “person wey dem no use water and spirit born, no go fit enter God Kingdom.” (John 3:5) The time wey Jesus baptize, holy spirit come down on top am. Na that time dem use “water and spirit” born am. After Jesus baptize, one voice from heaven come talk sey: “Na my Son be this, wey I choose. I like am well well.” (Matthew 3:16, 17) Na so God take tell everybody sey Jesus na im Son and sey e go enter the Kingdom for heaven. After, for Pentecost 33 C.E., other people wey baptize, go get holy spirit, and na that time dem go be born again, and come be God sons wey e choose with im spirit.—Acts 2:1-4.
E hard Nicodemus to understand wetin Jesus dey teach am about God Kingdom. So Jesus come tell am some things about the special work wey e come do for this earth as God Son. Jesus tell am sey: “Just as Moses take raise the snake up for wilderness, na so dem go take raise the Son of man up, so that everybody wey get faith for am go get life wey no go end.”—John 3:14, 15.
That time wey snake dey bite Israel people, anybody wey look the copper snake no go die. (Numbers 21:9) Na so e still be with Jesus, anybody wey show sey e get faith for am, go get life wey no go end. Jesus come tell Nicodemus something wey show the kind love wey Jehovah get, e tell am sey: “God love this world well well sotey, e come send im only special Son, so that anybody wey continue to get faith for am no go destroy, but e go get life wey no go end.” (John 3:16) About six months after Jesus start im preaching work for Jerusalem, e make am clear sey na im go save everybody wey dey live for this earth.
Jesus still tell Nicodemus sey: “God no send im Son make e come judge this world.” E mean sey God no send Jesus make e come judge people for this earth, e no send am come destroy people. But, as Jesus talk, God send am “make e come save the world.”—John 3:17.
Since na fear make Nicodemus come meet Jesus for night, the way Jesus take end the discussion really make sense. E tell am sey: “This na wetin God go take judge people: the light [na Jesus life and the things wey e dey teach people] come this world, but people like darkness pass light, because wetin dem dey do bad. And anybody wey dey do bad no dey like light, e no dey come where light dey, so that people no go correct am for wetin e dey do. But anybody wey dey do wetin good dey come where light dey, make people fit see wetin e dey do, because e dey do am well as God want am.”—John 3:19-21.
Na true sey Nicodemus na Pharisee and na teacher for Israel, but now, e dey im hand, to think about everything wey e don hear about this special work wey Jesus come do for God.