CHAPTER 18
Jesus Work Dey Increase as John Own Dey Reduce
MATTHEW 4:12 MARK 6:17-20 LUKE 3:19, 20 JOHN 3:22–4:3
JESUS DISCIPLES BAPTIZE PEOPLE
DEM PUT JOHN THE BAPTIST FOR PRISON
After dem do the Passover for the year 30 C.E., Jesus and im disciples comot for Jerusalem. Dem no go direct to their house wey dey Galilee. But dem go inside Judea area. For there, dem baptize many people. Na the same work John the Baptist dey do for about one year, with some of im disciples. The place fit be the valley wey dey River Jordan.
Jesus no baptize anybody by imself—na im disciples do am, as Jesus dey direct dem. By this time for Jesus preaching work, Jesus and John dey teach Jew people wey don comot hand from the bad things wey dem dey do concerning God Law covenant.—Acts 19:4.
But John disciples no happy, so dem come start to complain to John about Jesus dem sey: “The man [Jesus] wey be dey with you . . . don dey baptize people and everybody dey go meet am.” (John 3:26) But, John no dey jealous. E happy to hear this result about Jesus work and e want make im disciples still dey happy. John remind dem sey: “Una dey there when I talk sey ‘no be me be the Christ, but dem send me go im front.’” E explain am to dem the way dem go take understand am, e sey: “Anybody wey get the woman wey dey marry, na im be the husband. But e dey sweet the friend of the husband well well when e stand dey hear the voice of the husband. So e sweet me no be small.”—John 3:28, 29.
John be like friend to the man wey dey marry, and e happy when e show Jesus to im [John] disciples. Some of John disciples come start to follow Jesus. As time dey go, God fit anoint dem with holy spirit. John still want make im disciples wey remain, start to dey follow Jesus. The truth be sey John work for life na to arrange ground for Jesus preaching work. John explain sey: “That one own must continue to dey plenty and my own must continue to dey reduce.”—John 3:30.
Later, another John, wey dey follow Jesus write about where Jesus come from and the work wey e do to save us. E sey: “The one wey come from up high pass everything. . . . The Father love the Son, and e don put everything for im hand. The person wey dey show sey e get faith for the Son, get life wey no go end; the person wey disobey the Son no go get life, and God anger go remain for im head.” (John 3:31, 35, 36) E dey important make people know this truth!
E never too tey after John the Baptist talk about im work and how that work go take reduce, King Herod come arrest am. Herod carry Herodias, wey be Philip wife come marry am, and Philip na Herod half brother. When John talk this bad thing wey Herod do for public, Herod come put John for prison. As Jesus hear sey dem don arrest John, e comot for Judea with im disciples and ‘move go Galilee.’—Matthew 4:12; Mark 1:14.