CHAPTER 26
‘I Don Forgive You’
MATTHEW 9:1-8 MARK 2:1-12 LUKE 5:17-26
JESUS FORGIVE ONE MAN WEY PARALYZE AND HEAL AM
People for everywhere don hear about Jesus. Many come from where you no go even expect, to listen to Jesus and see im miracle. But after some days, Jesus go back to Capernaum, the main place where e dey do im work. Everybody for Capernaum don hear sey Jesus dey come. This one make many people come the house wey e dey. Some na Pharisee and people wey dey teach the law, and dem come from Galilee, Judea and from Jerusalem.
People plenty for the room sotey space no come dey again to enter the room, so Jesus come start to dey teach dem. (Mark 2:2) Now one serious thing want happen! Na something wey go make us happy; to know sey Jesus get the power to remove wetin dey make us suffer, and e go fit forgive anybody wey e want.
As Jesus dey teach for inside the room, four men carry their friend wey paralyze come meet Jesus make e heal am. But dem no fit carry am reach where Jesus dey because people full the room. (Mark 2:4) Just think how dem go dey feel. Dem climb the roof of the house, open some part, and put the man inside the house.
Jesus vex for wetin dem do? No. E really like the kind faith wey dem get. E come tell the man wey paralyze sey, “I don forgive your sins.” (Matthew 9:2) But Jesus fit really forgive sin? The scribes and the Pharisees no like wetin Jesus talk. Dem sey: “Why this man dey talk like this? This na insult to God, who fit forgive sin apart from God?”—Mark 2:7.
Because e know wetin dey their mind, Jesus tell dem sey: “Why una dey reason like this for una heart? Which one easy pass to tell the paralyze man, ‘I don forgive your sins,’ or to talk sey, ‘Stand up, carry your bed and make you waka’?” (Mark 2:8, 9) Na true, because of the sacrifice wey e go soon do, e fit forgive the man sin.
Jesus show everybody wey dey there sey e get the power to forgive sin. E turn look the man, and tell am sey: “I sey, Stand up, carry your bed, and make you go your house.” For everybody front, the man get up, carry im bed and waka comot. E surprise everybody! Dem come dey praise God sey: “We never see this kind thing before.”—Mark 2:11, 12.
From wetin Jesus talk, e dey clear sey sin get hand for the sickness wey human being dey suffer, and forgiveness dey give good health. Bible teach sey na because of the sin wey we carry from Adam and Eve, we dey sick and die today. But for God Kingdom, Jesus go forgive everybody wey love God and serve am. That time sickness no go dey again at all at all!—Romans 5:12, 18, 19.