Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • ypq question 5 pp. 15-17
  • Wetin I go do if dem dey find my trouble for school?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin I go do if dem dey find my trouble for school?
  • Answers to 10 Question Wey Dey Worry Young People For Mind
Answers to 10 Question Wey Dey Worry Young People For Mind
ypq question 5 pp. 15-17
One boy dey find another boy trouble for class

QUESTION 5

Wetin I Go Do if Person Dey Find My Trouble for School?

WHY E DEY IMPORTANT

Wetin you do fit make the matter better —or make am worst.

WETIN YOU FOR DO?

Just think am sey: Thomas no want go school again because people for im school dey talk im matter for back. Dem dey call am different different name. Sometimes person fit just hit the book wey dey im hand and do as if na mistake, or just push am for back, and when e turn back e no go know who push am because dem plenty. Na yesterday own worst pass, dem send am internet message wey make am fear . . .

If you be Thomas, wetin you for do?

WAIT! THINK AM WELL

You fit do something! The truth be sey, you go fit win person wey dey find your trouble even if you no fight am. How?

  • NO MIND AM. Bible sey: ‘Na person wey no get sense dey show everything wey vex am, but who get sense dey control imself.’ (Proverbs 29:11) If you try to control yourself well well—person wey dey find your trouble go leave you.

  • NO DO AM BACK. Bible sey: ‘No use bad thing pay anybody wey do you bad.’ (Romans 12:17) The matter go worse if you do the person back.

  • NO PUT YOURSELF FOR TROUBLE. Bible sey: ‘Person wey get sense go see trouble dey come and sofri hide.’ (Proverbs 22:3) Do wetin you fit do to make sure sey you no dey where people wey dey find trouble dey.

  • TALK WETIN THE PERSON NO THINK. Bible sey: ‘Answer wey person sofri give dey make person stop to dey vex.’ (Proverbs 15:1) You fit even try to make the person laugh. For example, if person wey dey find your trouble tell you sey you too fat you fit just tell am sey: ‘I fit slim small!’

  • WAKA COMOT. Nora wey be 19 years talk sey: “If you no answer person wey dey find your trouble e go show sey you get sense and strong pass am. E still show sey you fit control yourself—and that one na wetin the person wey dey find your trouble no fit do.”—2 Timothy 2:24.

  • NO THINK SEY YOU NO BE ANYTHING. Person wey dey find trouble know who dey fear and who no ready to fight am back. But the thing be sey person wey dey find your trouble go leave you if e see sey e no get power to control you.

  • TELL PERSON. One teacher wey dey teach before talk sey: “E good make anybody wey dem dey find im trouble go report. Na better thing to do be that because e fit help other people.”

One boy face person wey dey find im trouble because e know wetin e dey do

If you trust yourself, that one go give you the kind power wey the person wey dey find your trouble no get

YOU KNOW?

Apart from wetin we don talk before, another way wey person fit take find your trouble na:

  • Word wey be like fire dey comot from person mouth wey dey find trouble

    To use bad mouth. “I no go forget the bad name wey dem call me or the bad things wey dem talk about me. Dem make me feel like sey I no be anybody, I dey useless and nobody fit near me. E for better sey dem beat me pass wetin dem talk.”—Celine, 20 years.

  • One boy sitdown on e own when im mate dem no want near am again

    When all your friend run leave you. “My school people no dey near me again. When time reach to chop afternoon food, dem no go want make I sitdown near dem. For one year, na only me dey chop, and na so so cry I dey cry.”—Haley, 18 years.

  • One girl comot face for computer when e see how dem use computer take spoil im name

    To use internet spoil person name. “With small thing wey you type for your computer, you fit spoil person name for internet—or scatter im life. E be like joke, but e fit happen!”—Daniel, 14 years.

QUESTION ABOUT THIS MATTER

NA TRUE OR NA LIE

THE ANSWER

1 E don tey wey dem start to find person trouble.

1 Na true. For example, Bible tell us about some giant wey be Nephilim—this peolpe wicked well well.—Genesis 6:4.

2 To dey find person trouble no mean anything. E no too serious.

2 Na lie. Many young people today dey vex kill theirself because dem don tire for the trouble wey people dey find dem.

3 If you no want make person find your trouble again the only thing wey you go do na to fight am back.

3 Na lie. Sometimes, people wey dey find trouble dey get power pass who dem dey find im trouble. So to fight back na waste of time.

4 If you see where dem dey find person trouble e good to sey e no concern you.

4 Na lie. E no concern me no dey for this kind matter. If you see where dem dey find person trouble and you no talk, you fit add join the problem instead wey you go help.

5 Apart from the mouth wey dem dey make, who dey find trouble still dey fear.

5 Na true. Some people wey dey find trouble dey feel sey dem better pass other people, but many of them still dey fear. E dey sweet dem to make person feel sey e no be anything.

6 Person wey dey find trouble fit change.

6 Na true. If people wey dey find trouble see who help dem, dem fit change.

WETIN I PLAN TO DO

  • If person dey find my trouble, Wetin I go do or talk na:

LEARN MORE!

Wetin you go do if person dey find your trouble

Watch the cartoon wey dem dey draw for white board wey im name na Wetin You Go Do If Person Dey Find Your Trouble? for tv.jw.org/pcm. (Check CHOOSE VIDEO WEY YOU LIKE > YOUNG PEOPLE)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share