Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • ypq question 6 pp. 18-20
  • How I Go Fit Stand My Ground When My Mate Want Make I Join Dem Do Bad Thing?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • How I Go Fit Stand My Ground When My Mate Want Make I Join Dem Do Bad Thing?
  • Answers to 10 Question Wey Dey Worry Young People For Mind
Answers to 10 Question Wey Dey Worry Young People For Mind
ypq question 6 pp. 18-20
One boy wey im school mate dey try give am ciga

QUESTION 6

How I Go Fit Stand My Ground if My Mate Want Make I Join Dem?

WHY E DEY IMPORTANT

If you stand your ground, you go fit dey control your life, instead of other people to dey control am for you.

WETIN YOU FOR DO?

Just think am sey: Brian dey fear as two of im school people dey come near am. Dem don try to give am cigar two times make e smoke. For only this week, na the third time be this.

The first boy sey:

“Na only you again? Make I show you something.”

Brian still dey think wetin e talk as the boy put hand for pocket bring something come out and to give Brian.

As Brian see the cigar wey dey for the boy hand, im mind cut.

Brian come sey: “But, I don tell you before sey I no want . . .”

The other boy no let Brian talk finish, before e tell am sey: “You be fear fear!”

Na im Brain gather mind tell am sey: “I no be fear fear.”

The other boy put im hand for Brian shoulder. Come sofri tell am sey: “Just take am.”

The first boy stretch the cigar near Brian face come talk for im ear sey: “We no go tell anybody. Nobody go know.”

If you be Brian wetin you for do?

WAIT! THINK AM WELL

This boys wey dey disturb Brian don really think about wetin dem dey do? Dem really want do wetin dem dey do? No! The truth be sey, na other people deceive dem. Dem no want make their friend dem hate dem, so dem allow other people to dey control dem.

If to sey na you this kind thing happen to, wetin you for do to show sey you dey different and wetin you fit do to stand your ground?

  1. PREPARE YOUR MIND

    Bible sey: ‘Person wey get sense go see danger and e go hide imself, but person wey no know go waka enter am and e go suffer.’—Proverbs 22:3.

    Many times, you fit see trouble before e happen. For example, you fit see your class mate for one corner dey smoke. If you prepare how you go take handle the problem before you reach there, you go fit stand your ground.

  2. THINK

    Bible sey: ‘Make una get clean mind.’—1 Peter 3:16.

    Ask yourself, ‘How I go later feel if I join people do wetin no good?’ Na true sey, you fit dey feel sey you no want make your friend dem leave you. But how you go later feel? You ready to throwey who you really be and wetin you believe just to make your class mate happy?—Exodus 23:2.

  3. MAKE UP YOUR MIND

    Bible sey: ‘Person wey get sense dey use sense sofri do something.’—Proverbs 14:16.

    Whether now or later, we go choose wetin we want do and face wetin go come out of am. Bible tell us about Joseph, Job and Jesus wey choose to do wetin good. Bible still tell us about Cain, Esau and Judas wey choose to do wetin bad. Wetin you go do?

Bible talk sey: ‘Serve God well.’ (Psalm 37:3) If you don think wetin go come out of wetin you choose and you make up your mind, that one go make am easy for you to stand your ground—and na you go gain am.

No worry—You no need to talk too much. Just tell dem NO and mean am. Or to show sey you no go change your mind you fit sey:

  • “My hand no dey!”

  • “I no dey do that kind thing!”

  • “You suppose don know the kind person wey I be now!”

The point na make you quick answer dem and mean wetin you talk. If you do am, you go surprise sey dem go stop to dey worry you.

WETIN YOU GO DO IF DEM DEY LAUGH YOU

One boy wey dey use remote control another boy

If you do wetin your friend dem want make you do, you go be like person wey dem dey use remote control

What if your mate dem dey laugh you? What if dem tell you sey: “You too dey fear—wetin dey worry you self?” This na example of wetin dem fit talk to make you vex. Wetin you go do? See two things wey you fit do.

  • You fit no mind wetin dem talk. (“Na true you talk, I dey fear!” Quick tell dem wetin dey make you fear.)

  • You fit talk wetin go touch dem for mind. Tell dem why you sey no, and tell dem wetin go make dem think. (“I think sey person like you no go fit smoke!”)

If dem continue to dey find your trouble, waka comot! Remember sey, the more you stay there, the more dem go dey try make you do am. You go show sey you no want make people change who you be, if you waka comot.

The truth be sey, your mate go trouble you make you join dem do bad thing. But na you go choose wetin you want do. Stand your ground and no let dem control you. Later, you go see sey na your hand everything dey!—Joshua 24:15.

WETIN I PLAN TO DO

  • I fit sey no to wetin no good if I . . .

  • If my mate try to make me join dem do wetin no good, I go . . .

LEARN MORE!

No follow your mate dem do wetin no good

Watch the cartoon wey dem dey draw for white board. The name na Stand Up to Peer Pressure! for www.pr2711.com. (Look under BIBLE TEACHINGS > TEENAGERS)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share