Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • ypq question 7 pp. 21-23
  • Wetin I Go Do if Person Dey Worry Me Make I sleep With am?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin I Go Do if Person Dey Worry Me Make I sleep With am?
  • Answers to 10 Question Wey Dey Worry Young People For Mind
Answers to 10 Question Wey Dey Worry Young People For Mind
ypq question 7 pp. 21-23
One boy wey dey try toast one girl but the girl throwey face no gree for am

QUESTION 7

Wetin I Go Do if Person Dey Worry Me Make I Sleep With Am?

WHY E DEY IMPORTANT

Wetin you make up your mind to do about this matter fit affect your tomorrow.

WETIN YOU FOR DO?

Just think am sey: Heather and Mike don sabi theirself for only two months, but Heather dey feel like sey e don tey well well wey e know Mike. Dem dey always send text message to theirself, dem dey talk tey for phone, and before this one talk finish the other one go help am finish am! But Mike want make e pass like that.

For that two months, na only to hold hand and kiss small dem dey do. Heather no want make e pass like that. But e no want make Mike vex leave am, because na only Mike dey tell am sey e fine well well, and this one dey make im head big. No be only that one o, e don already tell imself sey, ‘Me and Mike don fall in love . . .’

If to sey you be Heather and you don old reach to marry, wetin you go come do?

WAIT! THINK AM WELL

Person dey use fine cloth take do rag

God want make only people wey don marry dey sleep together. If you sleep with person before you marry, you go be like person wey use the fine cloth wey person dash am take do rag

If person climb big tree, come dey think sey e go fly like bird come down, e go wound. Na so e be for person wey no follow wetin Bible talk, like the one wey dey 1 Thessalonians 4:3—wey talk sey: ‘Comot hand for all sex matter wey no clean for God eye.’

Wetin go happen if we no follow wetin that place talk? Bible talk sey: ‘Run from all sex matter wey no clean for God eye! All other sin wey person dey do na outside im body, but anybody wey dey put hand for sex wey no clean for God eye dey sin against e own body.’ (1 Corinthians 6:18) How that one take be true?

People wey dey do research don see sey many young people wey sleep with person before dem marry dey suffer am. Some of the things wey dem dey suffer na:

  • PAIN FOR MIND. Many young people wey don sleep with person before dem marry later sey dem for no do am.

  • NO TRUST. When dem don sleep with thierself finish, two of dem go come dey suspect theirself. And this one go come make dem dey think for their mind sey, ‘which other person e don even sleep with?’

  • WETIN DEM FOR LIKE. Girls really want person wey go protect dem, no be person wey go use dem. And wetin many boys dey like pass na girls wey no gree for dem quick.

  • Na the truth be this: If you sleep with person before you marry, you don throwey something wey dey important well well (Romans 1:24) Your body too dey important for you to just throwey am like that!

Show sey you get better character if you ‘comot hand from all sex matter wey no clean for God eye.’ (1 Thessalonians 4:3) If you marry, you go fit sleep with the person wey you marry. You go fit enjoy am well well, that time you no go dey worry, fear or dey regret as e for be if you sleep with person before you marry.—Proverbs 7:22, 23; 1 Corinthians 7:3.

WETIN I PLAN TO DO?

  • Any person wey really love you go like to scatter your life?

  • Any person wey really love you go want make you do wetin God no like?—Hebrews 13:4.

FOR ONLY GIRLS

One girl sitdown dey think

Many boys talk sey dem no go ever marry girl wey dem don sleep with. Why? Because na girl wey never sabi man before dem like pass!

E surprise you—or even vex you? Remember sey: Wetin dem dey show for film and TV dey make am be like sey, na enjoyment or better love for young people wey never marry to sleep together.

Use your sense! People wey dey use style decieve you to sleep with dem dey find their own gain.—1 Corinthians 13:4, 5.

FOR ONLY BOYS

One boy sitdown dey think

If you dey go out with girl wey you plan to marry, make you ask yourself, ‘I really like this girl?’ If your answer na yes, how you go take show am? You go fit show am if, you get the power to follow God law, the sense to avoid place wey fit make you do bad thing and love to do wetin go make the girl happy.

If you get this kind character, the girl wey you like go feel like Shulammite for Bible wey keep imself. E talk sey: ‘Person wey I love na my own, and I be im own.’ (Song of Solomon 2:16) The truth be sey, the girl go love you well well!

GET THIS ONE FOR MIND

If person wey want make you sleep with am use style tell you sey, “If you love me, you go do am,” Make you serious tell am sey, “If you love me, you for no talk am!”

One thing wey go help you behave well with boy or girl na: If you know sey wetin you want do na something wey you no like make your papa and mama see, make you no do am.

WETIN YOU THINK?

  • If person tell you to sleep with am, wetin you go do?

  • Wetin fit make am hard well well for you to sey no?

  • How you go take avoid am?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share