Wetin Dey Part 6
When Israel people enter the land wey Jehovah promise dem, na the tabernacle dem for dey worship Jehovah. Priest dey teach dem Jehovah Law and people wey dey judge dey guide dem. This part make us know sey wetin one person do fit affect other people. E show sey all Israel people one one, get wetin dem suppose do to make Jehovah and their neighbor happy. E still make us know sey people like Deborah, Naomi, Joshua, Hannah, Jephthah pikin, and Samuel do better things wey touch people mind for where dem stay. E still help us see sey people like Rahab, Ruth, Jael, and Gibeon people wey no come from Israel follow Israel people because dem know sey God dey with dem.