Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • yc lesson 4 pp. 10-11
  • E Make Im Papa and Jehovah Happy

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • E Make Im Papa and Jehovah Happy
  • Teach Your Pikin
  • Similar Material
  • Our Faith Go Make Jehovah Bless Us
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Jephthah Promise Jehovah
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • ‘Do Wetin You Promise’
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Teach Your Pikin
yc lesson 4 pp. 10-11
When im pikin small, Jephthah dey with am

LESSON 4

E Make Im Papa and Jehovah Happy

Jephthah dey pray to Jehovah at the same time, the Israelite army dey fight their enemy

Wetin Jephthah dey promise Jehovah?

As Jephthah dey come back from the war, e hug im pikin wey come out come greet am

E no easy for Jephthah pikin to do wetin im papa promise, but e do am

You see this girl wey dey this picture?— Na one man wey dem dey call Jephthah born am. Bible no tell us im name, but we know sey the girl make im papa and Jehovah happy. Make we learn about the girl and im papa.

Jephthah na better person. E dey teach im pikin about Jehovah everytime. Jephthah self na strong man and na better leader. Israel people come beg am sey make e carry dem go fight their enemy.

Jephthah come pray sey make Jehovah help am win. E promise Jehovah sey if e win, e go give Jehovah the first person wey come out from im house when e come back. The person go dey work for the tabernacle, and e go dey stay near there. Tabernacle na place where people dey go worship God that time. As e come be, Jephthah win the fight! You know who be the first person wey come out from im house when e come back?—

Na Jephthah pikin! Na only this pikin Jephthah born. And now Jephthah go come allow am comot for house. This one really pain Jephthah. But remember sey e don promise God something. Quick quick, im pikin talk sey: ‘Papa, you don already promise Jehovah, do wetin you promise.’

Jephthah pikin dey gather fire wood for the tabernacle; im friend don come visit am

Jephthah pikin friend dem dey go visit am every year

Jephthah pikin self no happy. For the tabernacle, e no go marry, and e no go born pikin. But e really want make im papa do the thing wey e promise. And e still want make Jehovah happy. Jephthah pikin know sey, that one better pass to marry and get pikin. Na im make am comot for house go work for the tabernacle.

You think sey wetin e do make im papa and Jehovah happy?— Yes, e make dem happy! If you dey do wetin dem tell you and you love Jehovah, you go be like Jephthah pikin. You self go make your mama and papa, and Jehovah happy well well.

READ AM FOR YOUR BIBLE

  • Deuteronomy 6:4-6

  • Judges 11:30-40

  • 1 Corinthians 7:37, 38

QUESTION:

  • Who be Jephthah? Which promise e promise Jehovah?

  • Why e dey hard for Jephthah pikin to do wetin im papa don promise?

  • Wetin Jephthah pikin want do wey better pass any other thing?

  • How you fit take be like Jephthah pikin?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share