SONG 4
“Jehovah Na My Shepherd”
(Psalm 23)
1. Jehovah na you dey guide me.
Na you know wetin I need.
You be my Shepherd, I be your sheep,
I follow as you dey lead.
You lead me go where water dey,
You give me food make I chop.
As you care for me, you dey show me love,
E make me get peace of mind.
You show me the love wey no dey fail,
You help me get peace of mind.
2. Jehovah I really love you.
You love me since when I small.
You always dey do wetin correct.
God help me make I no fall.
You use your rod take protect me,
And you no dey leave me go.
O Jehovah, you be my God and Friend,
I safe for your hand, I know.
Jehovah, my Friend, my good Shepherd,
I safe for your hand, I know.
3. Jehovah God na my Shepherd.
E give me wetin I need.
Na im I go follow all my life,
Because e dey lead me well.
My God, I give you my whole life,
I trust you with all my heart.
O my God, you always dey care for me,
I no go forget your love.
Abeg no stop to dey care for me,
I no go forget your love.
(Still check Ps. 28:9; 80:1.)