SONG 65
Make We Dey Grow!
(Hebrews 6:1)
1. Make we try to dey grow till we go mature!
Make we try all our best to dey help make people see
Sey the hope we dey share na hope wey dey sure.
Make we teach dem make dem know.
Na the work from Jesus we dey do,
If we go tell people the good news.
Trust Jehovah because e go dey with you.
Try your best, dey try dey grow.
2. Make we try to dey grow, make we no dey fear!
This good news be like light, we go teach am make e clear.
Make we join praise Jehovah God wey dey care.
We go try dey spread the news.
But we know some people no go gree,
Dem go try make us fear to go preach.
But we no go dey fear, we go still dey preach
Sey God Kingdom don dey rule.
3. Make we try to dey grow, and make e dey show!
Make we try ev’ry day,
to continue to dey grow.
Make the way we dey teach, dey grow ev’ry day,
As the work we get plenty.
We go love the people wey we find,
We go try help dem make dem fit stand.
Dem go grow when the truth don dey touch their heart,
So the truth go make dem free.
(Still check Phil. 1:27; 3:16; Heb. 10:39.)