SONG 105
“God Na Love”
(1 John 4:7, 8)
1. God love us and e don show us
How we fit follow am well.
When we love God and our neighbors,
We go share good news with dem.
Love go help us live better life,
And do things wey dey Bible.
We want try make we dey show love,
Yes, the love wey no dey fail.
2. If we get deep love for God Word,
E go make us do good things.
Even when problem dey face us,
With Jehovah we go win.
Love go help us get the power
Wey fit help us dey endure.
Make we try dey show our brothers
Sey we love dem from our heart.
3. Things wey people do fit pain you,
No dey keep am for your mind.
Trust Jehovah, e go guide you,
E go help you do your part.
We go try make we dey copy
How Jesus Christ dey show love.
Even when things no dey easy,
Make we try show love like God.
(Still check Mark 12:30, 31; 1 Cor. 12:31–13:8; 1 John 3:23.)