SONG 145
God Promise Us Paradise
(Luke 23:43)
1. Na Paradise Jehovah promise
Sey we go dey, E no fit lie.
Life go dey sweet, we no go suffer.
For Paradise, we no go die.
(CHORUS)
Na Paradise we don dey wait.
E no go late, we get strong faith.
Na Jesus Christ go rule as King,
Na this good news make us dey sing!
2. Now we dey cry, we still dey suffer,
People we love dey die leave us.
But we believe as Jesus promise,
Dem go come back for Paradise.
(CHORUS)
Na Paradise we don dey wait.
E no go late, we get strong faith.
Na Jesus Christ go rule as King,
Na this good news make us dey sing!
3. This Paradise dey give us strong hope.
Jesus our King, we want thank you.
Jehovah God, Papa wey love us,
We dey praise you, we too love you.
(CHORUS)
Na Paradise we don dey wait.
E no go late, we get strong faith.
Na Jesus Christ go rule as King,
Na this good news make us dey sing!
(Still check Matt. 5:5; 6:10; John 5:28, 29.)