‘Go Make People My Disciple for The Whole World’
‘Go make people my disciple for the whole world. Dey baptize dem, dey teach dem to do everything wey I don command una.’—MATT. 28:19, 20.
SONG: 141, 97
1, 2. Which question fit come person mind because of wetin Jesus talk for Matthew 24:14?
TODAY people sabi Jehovah Witness as the people wey dey always preach about God Kingdom, even people wey no like us. You fit don meet people when you dey preach wey talk sey, dem like the way we dey preach even though dem no believe wetin we dey teach. Jesus don talk sey people go preach the good news about God Kingdom for everywhere for this world. (Matt. 24:14) But how we take know sey na wetin Jesus talk for Matthew 24:14 we dey do? And wetin make us feel sey na we be the people wey really dey do the work?
2 Plenty church people dey feel sey dem dey preach the good news. But wetin dem really dey do na to go church go talk about one better thing wey don happen for their life. Some dey preach for television, radio and Internet. Other people dey dash pikin wey no get mama and papa money. E still get some wey dey build school and hospital take help people for free. But when we really look am, na wetin Jesus talk sey make we do be that?
3. Wetin be the four things wey Jesus want make we do wey dey Matthew 28:19, 20?
3 You think sey Jesus disciple dem just sitdown for one place make people come meet dem before dem preach? No be so! After Jehovah don resurrect Jesus, e tell im disciple dem sey: ‘So make una go make people my disciple for the whole world. Dey baptize dem, dey teach dem to do everything wey I don command una.’ (Matt. 28:19, 20) This one show sey na four things we go do. We go make people dey follow Jesus, we go baptize dem and we go teach dem. But wetin be the first thing wey Jesus want make we do? E sey make we: “Go”! One person wey dey put eye for Bible matter well well talk sey: “Wetin this ‘go’ mean be sey everybody wey dey talk sey im na believer must do this work, whether the place near or far.”—Matt. 10:7; Luke 10:3.
4. Wetin Jesus mean when e talk sey e go show im disciples how to ‘catch people’ like fish?
4 The time wey Jesus dey talk about this preaching, you think sey wetin dey im mind na make im disciples dey preach one one as dem fit? Or e want make dem do am together? As e be sey one person no fit make people Jesus disciple ‘for the whole world’, e mean sey na many people go join hand do this work. Na wetin make Jesus tell im disciple sey e go show dem how to ‘catch people,’ like fish. (Read Matthew 4:18-22.) This fisherman work wey Jesus dey talk for here no be the one wey one fisherman go just dey with hook wey e don put worm dey wait make fish come chop am. But na net wey dem take dey catch fish e go use. And because to use this net no be small work, na plenty fisherman go gather do the work.—Luke 5:1-11.
5. Wetin be the four question wey we go answer, and why e good to know the answer?
5 To know the people wey really dey preach the good news wey Jesus talk about, we go answer this four question:
Wetin Jesus disciple suppose preach?
Why dem dey do this work?
How dem suppose preach?
Where dem go preach reach and when dem go stop?
The answer go help us know the people wey really dey preach as Jesus talk, and e go make us get the mind to continue for this work.—1 Tim. 4:16.
WETIN WE SUPPOSE PREACH?
6. Wetin make you believe sey na Jehovah Witness people dey preach the correct thing?
6 Read Luke 4:43. Wetin Jesus preach, na the ‘good news about God Kingdom’ and na wetin e want make im disciples preach be that. Which people dey preach about God Kingdom for ‘the whole world’? The answer clear—na only Jehovah Witness people. Even people wey no like us gree sey this one na true. For example, one church priest talk sey e don live for different different country. For this country dem, e don ask our brothers sey wetin dem dey preach. Wetin dem tell am? The priest talk sey: “To show sey dem no get sense, all of dem just dey talk one thing: ‘Good news about God Kingdom.’” This one show sey dem no get sense? No. But e show sey all the Jehovah Witness wey dey everywhere for this world, dey preach one thing and na so e suppose be for correct Christian. (1 Cor. 1:10) Na the same thing dey Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom. This magazine dey for 254 language, and for any magazine wey come out, na about 59 million we dey print. For the whole world, e no get any magazine wey dem dey print reach like this.
7. How we take know sey the people wey dey lead for church today no dey preach the correct thing?
7 The people wey dey lead for church today, no dey preach about God Kingdom. Some wey dey try talk about am, dey talk sey God Kingdom na something wey dey person mind. (Luke 17:21) Dem no dey teach people sey God Kingdom na government wey dey heaven and sey na Jesus Christ be the King wey God don choose. Dem no even dey talk sey na this Kingdom go comot all the bad people and the problem wey dey this world. (Rev. 19:11-21) But for Christmas and Easter time, dem dey remember Jesus as one small pikin and as person wey don die. This one show sey dem no even know wetin Jesus go do the time wey e go rule people for this earth. As e be sey dem no know wetin Jesus sey make we dey preach, dem no fit know why dem suppose preach.
WHY WE DEY DO THIS WORK?
8. Wetin people wey dey follow Jesus no suppose get for mind as dem dey preach?
8 Wetin suppose make Jesus disciple dem do this work? Dem no suppose do this work because of money or because dem want build big big house. Jesus tell im disciple dem sey: ‘I give una free, so make una give free.’ (Matt. 10:8) God word no be wetin person go take dey make money. (2 Cor. 2:17, ftn.) People wey dey do this work no suppose dey find wetin go enter their pocket. (Read Acts 20:33-35.) Even though sey Jesus talk this thing, wetin church people still dey do na to dey collect money so that dem go fit pay their pastor and the plenty people wey dey work for church. This one don make many church leader get plenty money.—Rev. 17:4, 5.
9. Wetin show sey na the correct mind Jehovah Witness people take dey preach?
9 Dem dey pay Jehovah Witness people for their preaching work? No! Na the money wey people take their mind give, dem dey use support their work. (2 Cor. 9:7) And dem no dey collect offering for their Kingdom Hall or convention. But for only last year, dem take nearly 2 billion hour take preach; and e pass nine million people wey dem dey teach Bible for free every month. The one wey fit surprise person pass be sey, no be only sey dem no dey pay dem for this work but dem dey even happy to use their own money do the work. One man wey talk about this work wey Jehovah Witness people dey do, talk sey: “Wetin dey their mind na to preach and to teach. . . . Dem no get any person wey be leader or pastor, this one dey make dem fit save money.” Why we dey do this work? Na because we love Jehovah and our neighbor. Nobody dey force us do am. God don talk for Psalm 110:3 (Read am.) sey im people go get this kind mind.
HOW WE SUPPOSE PREACH?
We dey preach for anywhere wey we fit see people (Check paragraph 10)
10. How Jesus and im disciple dem take preach?
10 How Jesus and im disciple dem take preach? Dem dey go meet people for house and anywhere wey dem fit see people. (Matt. 10:11; Luke 8:1; Acts 5:42; 20:20) This one show sey dem want make everybody hear this good news. Dem no dey select.
11, 12. For preaching matter, how Jehovah Witness people take different from church people?
11 Today, church people dey preach like Jesus and im disciple dem? For where! Na only for inside church their pastor dey preach. Dem no dey go meet people. For their eye the member wey dem get don reach. And their members even dey happy to pay the pastor dem. But, e get sometimes wey dem dey tell their member make dem go preach. For example, for year 2001, Pope John Paul II talk for letter sey: “I don dey talk since sey make church people dey go preach and I go still talk am again . . . Make we get the kind mind wey apostle Paul get, when e talk sey: ‘Na bad thing I do if I no preach the Gospel.’” E come still talk sey, no be just some people wey church train suppose to preach. Na all the member for church. But how many church people don really follow wetin e talk?
12 What about Jehovah Witness people? Na only dem dey preach sey Jesus don be King since 1914. Dem dey do wetin Jesus talk and dem no dey take preaching play. (Mark 13:10) Hear wetin one book, Pillars of Faith—American Congregations and Their Partners, talk. E sey: “Jehovah Witness people no dey take this preaching work play. Dem dey always get am for mind.” The book still talk sey, when Jehovah Witness people see person wey dey hungry, person wey no happy, and person wey no well, dem dey try help the person. But that one no mean sey dem no go still preach to the person about wetin fit save am when the world go end because na wetin carry dem come be that. Jehovah Witness people still dey preach that message. And dem dey preach the way Jesus and im disciple take preach.
WHERE DEM GO PREACH REACH AND WHEN DEM GO STOP?
13. Where the good news go reach?
13 Jesus talk sey people go preach this good news for ‘everywhere for this world.’ (Matt. 24:14) People wey go follow am, go be people wey come from ‘the whole world.’ (Matt. 28:19, 20) This one mean sey the good news go reach everywhere for this world.
14, 15. Wetin show sey na Jehovah Witness people dey preach the good news for ‘everywhere for this world’? (Go check the first picture.)
14 Na who dey preach this good news for everywhere today, as Jesus talk? Na Jehovah Witness people! Why we talk like that? Na around 600,000 pastor dey for the different different church for United States. But Jehovah Witness people wey dey that country na around 1.2 million. Another one be sey, na small thing the Roman Catholic Church priests wey dey everywhere for this world, take pass 400,000. But Jehovah Witness people for the whole world dey around eight million and dem dey preach for 240 country. How you see am? No be small work Jehovah dey help im people do and na im we go thank!—Ps. 34:1; 51:15.
15 As Jehovah Witness people, wetin we want na to preach to everybody wey we fit preach to before this world go end. Na im make to fit do this work well, we dey translate our book, our magazine and other things wey we dey give people for language wey pass 700. And people no dey pay to get our book dem. E pass 200 million of our New World Translation Bible wey don dey for language wey pass 130. For only last year, the different different book wey dey talk about Bible wey we make na around 4.5 billion. Even our jw.org website get things wey dey for language wey pass 750. True true, we fit talk sey na only Jehovah Witness people dey preach this good news for ‘everywhere for this world’!
16. How we take know sey Jehovah Witness people get holy spirit?
16 Which time this preaching work go stop? Jesus talk sey im disciple dem go preach reach last days and na ‘after this one the end go come.’ Which other people you know wey dey do this work for this last days? Some people fit talk sey: “Na we get holy spirit but na una dey do the work.” Na true? If we no get holy spirit, we go fit do the work come reach this time? (Acts 1:8; 1 Pet. 4:14) Some people dey try copy how Jehovah Witness take dey preach but dem no fit. E get some wey dey do wetin dem call missionary work, but after small time dem go stop. E still get some wey dey go people house go preach, but no be wetin Jesus talk dem dey preach.
WHICH PEOPLE REALLY DEY DO THE WORK TODAY?
17, 18. (a) Wetin make we fit nack hand for chest sey na Jehovah Witness people dey preach about God Kingdom today? (b) Wetin dey help us fit continue for this work today?
17 So which people really dey preach about God Kingdom today? We fit nack hand for chest sey: “Na Jehovah Witness people!” Why we talk like that? Na because we dey preach the correct message wey be, good news about God Kingdom. The way we take dey preach na the correct way because we dey go meet people. Another thing be sey na the correct thing dey make us preach—the love wey we get for Jehovah and our neighbor, no be money. Na we don preach go far pass, we don preach go reach different different country and for different different language. And we no go tire or stop to do this work till this world end.
18 E really dey surprise us when we see all the work wey God people don do for this last days. Wetin dey help us fit do this work? See as apostle Paul take talk am for the letter wey e write give the brothers for Philippi. E sey: ‘Because God want make you do wetin e like, na im be the Person wey dey give you power, so that you go want do and you go fit do wetin e like.’ (Phil. 2:13) Make Jehovah our Papa wey love us dey give us power, so that we go do everything wey we fit do for this preaching work.—2 Tim. 4:5.