Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 June pp. 23-27
  • No Let People Mistake Make You Stop to Serve Jehovah

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • No Let People Mistake Make You Stop to Serve Jehovah
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • OTHER PEOPLE MISTAKE GO MAKE YOU STOP TO SERVE JEHOVAH?
  • NO STOP TO SERVE JEHOVAH
  • WETIN YOU GO DO?
  • Samuel No Stop to Dey Do Wetin Good
    Teach Your Pikin
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 June pp. 23-27
One young brother dey think about the mistake wey some people for im congregation make

No Let People Mistake Make You Stop to Serve Jehovah

‘No stop to dey forgive unaself.’—COL. 3:13.

SONG: 121, 75

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • Wetin make Jehovah Witness people different from other people?

  • How Bible take show sey all of us dey make mistake?

  • Wetin we fit do about our mistake and other people own?

1, 2. Wetin Bible talk about Jehovah people wey dey happen now?

E NO get any other people for this world wey be like Jehovah Witness people. Na true sey dem dey make mistake. But God still dey use im holy spirit bless im people because dem ready to do wetin e want. Make we see some of the better things wey Jehovah dey use dem do.

2 When last days start for 1914, Jehovah Witness people no too plenty. But Jehovah bless their preaching work. As time dey go, many people come dey join Jehovah Witness because of the truth wey dem learn from Bible. Jehovah don talk sey e go happen like that. E sey: ‘The one wey no reach anything go turn to one thousand and the one wey small go turn to big country. Me, Jehovah, go quick do am by myself when the time reach.’ (Isa. 60:22) Wetin Jehovah talk don really happen for this last days. Na im make Jehovah Witness people plenty pass people wey dey some country today.

3. How Jehovah people don show sey dem get love?

3 Love dey everything wey Jehovah dey do. Today, Jehovah don still help im people dey show sey dem get love well well. (1 John 4:8) Jesus wey get the kind love wey God get, tell people wey dey follow am sey: ‘I dey give una new command sey make una love unaself. If una love unaself, people go know sey una be my disciple.’ (John 13:34, 35) For our time, Jehovah people don show the kind love wey dem get, when different different country fight war. For example, around 55 million people die for only World War II. But Jehovah Witness no join kill anybody. (Read Micah 4:1, 3.) E show sey their hand clean.—Acts 20:26.

4. Why e fit surprise person sey Jehovah people dey plenty?

4 Jehovah people dey plenty more more even though sey dem dey this world wey Satan, the ‘god of this world,’ dey control. (2 Cor. 4:4) E dey control politics and news wey dey this world. But e no fit stop our preaching work. Because na only small time remain for am, e dey use different different style to make people stop to serve Jehovah.—Rev. 12:12.

OTHER PEOPLE MISTAKE GO MAKE YOU STOP TO SERVE JEHOVAH?

5. Why e be sey sometimes people dey do wetin dey pain us? (Go check the first picture.)

5 For our meeting, we dey learn why e good to love God and other people. Wetin Jesus talk show sey na so e go be. When one person ask am which commandment big pass, e talk sey: ‘“Make you use all your mind, all your body and all your sense love Jehovah wey be your God.” Na this command big pass and na im be the first. The second one wey be like the first one na: “Make you love your neighbor as you love yourself.”’ (Matt. 22:35-39) But Bible make us know sey all of us dey sin because of Adam. (Read Romans 5:12, 19.) Sometimes, somebody for congregation fit talk or do wetin pain us. Wetin we go do if this kind thing happen? We go still dey serve Jehovah with im people? Even Jehovah people for olden days do or talk wetin pain other people. Wetin we fit learn from dem?

High Priest Eli dey work for temple and im pikin dem dey carry women

If you dey stay Israel that time wey Eli and im pikin dem dey, wetin you for do? (Check paragraph 6)

6. How e be sey Eli no correct im pikin dem?

6 For example, Eli wey be High Priest get two pikin wey no dey follow Jehovah law. Bible talk sey: ‘Eli pikin dem bad well well; dem no dey respect Jehovah.’ (1 Sam. 2:12) Even though sey their papa na High Priest for tabernacle, the two pikin dey do things wey bad well well. Eli know wetin dey happen but e no correct dem well. Na im make God punish Eli family. (1 Sam. 3:10-14) As time dey go, Jehovah no gree make anybody for Eli family be high priest again. If to sey you dey that time, wetin you for do as Eli no fit correct im pikin? You for let am stop you to serve Jehovah?

7. Which bad things David do, and wetin God come do?

7 Jehovah like David well well, Jehovah even talk sey David na ‘person wey dey do wetin sweet am.’ (1 Sam. 13:13, 14; Acts 13:22) But David still do bad; e sleep with Bath-sheba and e come get belly. This thing happen the time wey Bath-sheba husband, Uriah, go war. The small time wey Uriah dey house, David try to make am sleep with Bath-sheba so that e go be like sey na Uriah get the pikin. Uriah no gree do wetin David tell am; so David make dem put Uriah for where dem go kill am for the war. David and im family suffer well well because of this bad thing wey e do. (2 Sam. 12:9-12) But God pity David because of the ‘clean and better mind’ wey David take serve am. (1 Ki. 9:4) If to sey you dey that time, wetin you for do? You for let wetin David do make you no serve Jehovah again?

8. (a) Wetin happen wey show sey apostle Peter no do wetin e talk? (b) Why Jehovah still continue to use Peter, even with the mistake wey e do?

8 Apostle Peter na another example for Bible. Jesus select Peter make e be im apostle; but sometimes Peter still do or talk wetin e later regret. For example, one time wey things hard for Jesus, all im apostle run leave am. Peter don first talk sey even though sey everybody run, e no go run. (Mark 14:27-31, 50) But when people come arrest Jesus, all the apostle run leave am—even Peter! Peter no even gree sey e know Jesus. (Mark 14:53, 54, 66-72) But after, Peter come regret wetin e do and Jehovah come still dey use am do im work. If you be one of the disciple that time, you for stop to serve Jehovah because of wetin Peter do?

9. Why you believe sey Jehovah go always do the correct thing?

9 Wetin we just talk about na some example of Jehovah servant wey do wetin bad and wetin pain other people. E still get other example wey don happen before and for our time. But the question be sey, if na you e happen to wetin you go do? You go let their mistake make you stop to go meeting and even stop to serve Jehovah? Or you go remember sey Jehovah fit dey give dem time to change and e go correct the problem? But e fit be sey, people wey do wetin bad well well no gree change so that Jehovah go forgive dem. If e be like that, you believe sey when time reach Jehovah go handle the matter, even if na to disfellowship the person?

NO STOP TO SERVE JEHOVAH

10. Wetin Jesus know about wetin Judas and Peter do?

10 Bible tell us story about people wey no stop to serve Jehovah even when other people do wetin bad well well. For example, Jesus choose im 12 apostle after e don pray to im Papa, till day break. Judas Iscariot na one of dem. When Judas come later sell Jesus, Jesus no stop to serve Jehovah because of wetin Judas do. And e no still stop to serve im Papa because of wetin Peter do. (Luke 6:12-16; 22:2-6, 31, 32) Jesus know sey no be Jehovah and im people make Judas and Peter do wetin dem do. Jesus still continue to do the good work wey e dey do, even though some of im disciple do wetin e no like. Jehovah resurrect am, come make am King for im Kingdom wey dey heaven. This na the better thing wey Jesus get from Jehovah hand.—Matt. 28:7, 18-20.

11. Wetin Bible talk about people wey dey serve Jehovah for our time?

11 The trust wey Jesus get for Jehovah and im people no shake that time and even now. True true, when we see the things wey Jehovah dey use im people do for this last days, e reach to make person open mouth. E no get any other group wey dey preach the truth wey dey Bible for everywhere for this world. Why? Because Jehovah no dey with dem as e dey with us. Isaiah 65:14 talk about the better things wey God people dey enjoy: ‘See! My servant dem go happy well well because their mind dey sweet dem.’

12. If some of God servant make mistake, how we go behave?

12 Jehovah people dey happy for the good things wey dem fit do because na Jehovah dey help dem. But people for this world wey Satan dey control no dey happy because things dey bad more more. E no go make sense if person come dey blame Jehovah or im people because of the mistake wey some of God servant do. Make we no stop to serve Jehovah. Make we dey support im work. And make we know wetin we suppose do if other people make mistake.

WETIN YOU GO DO?

13, 14. (a) Why e good make we take am sofri sofri with other people? (b) Which promise we no want forget?

13 So wetin we go do if brother or sister for congregation talk or do wetin vex us? Bible advise us sey: ‘No dey quick vex, because na im you go take know person wey no get sense.’ (Eccl. 7:9) Make we no forget sey e don reach around 6,000 years since Adam and Eve sin and since that time, all of us dey make mistake. So e no go good for us to think sey our brothers and sisters no suppose make mistake. Because that kind thing fit make us no serve Jehovah with sweet mind again for this last days. And the one wey bad pass na if we come let other people mistake make us leave Jehovah and im people. If that kind thing happen, we no go fit serve Jehovah again and we no go enter paradise.

14 To fit keep the sweet mind and hope wey we get, make we no forget wetin Jehovah don promise us, e sey: ‘See! I dey make new heaven and new earth; and una no go remember the things wey happen before, and dem no go come una mind again.’ (Isa. 65:17; 2 Pet. 3:13) No let other people mistake make you no get this blessing.

15. Wetin Jesus talk sey make we do when other people make mistake?

15 But as e be sey we never enter that paradise now, e good to remember wetin Jehovah want make we do when person do or talk wetin vex us. For example, Jesus talk sey: ‘If una forgive people the bad things wey dem do una, na so una Papa wey dey heaven go still forgive una; but if una no gree forgive people the bad things wey dem do una, una Papa no go still forgive una the bad things wey una do.’ Remember the time wey Peter ask Jesus whether we go forgive ‘reach seven times,’ Jesus tell am sey: ‘I dey tell you, no be seven times, but make e reach 77 times.’ E clear sey Jesus want make we dey forgive people every time; make this one be the first and main thing wey suppose come our mind.—Matt. 6:14, 15; 18:21, 22.

16. Which better example Joseph show us?

16 Joseph wey be the first pikin wey Rachel born for Jacob show us good example for this matter. Joseph papa wife get ten pikin wey hate am because na Joseph their papa like pass. Because of that one, dem come sell am make e be slave. After many years, Joseph come be the second oga for Egypt, because of the better work wey e don do. When food finish for the whole place, Joseph brother dem come buy food for Egypt but dem no know am again. Joseph for use im power take punish dem because of the bad things wey dem do am before. But e no punish dem, e try see if dem don change the kind bad mind wey dem get. As e see sey dem don change, e come let dem know sey na im be Joseph their brother. E later tell dem sey: ‘Make una no fear. I go dey give una and una pikin dem food.’ Bible still talk sey: ‘Na im e come make their mind strong and e tell dem wetin make their mind come down.’—Gen. 50:21.

17. Wetin you go do if other people make mistake?

17 E good to remember sey since na all of us dey make mistake, we fit do wetin go make other people vex. If we come know sey we don do wetin make another person vex, Bible advise us sey make we go meet the person, settle the matter with am. (Read Matthew 5:23, 24.) We dey like am if person no carry wetin we do am for mind? If na so, make we still do like that. Colossians 3:13 tell us sey: ‘No dey carry wetin una do unaself for mind and no stop to dey use all una mind forgive unaself, even if na wetin suppose make you vex for the other person. As Jehovah take all im mind forgive una, make una still dey do like that.’ If we love our brothers and sisters we no go dey count how many times dem do us bad, na so 1 Corinthians 13:5 talk. If we dey forgive other people, Jehovah go forgive us. When e reach wetin we go do about other people mistake, the best thing na to copy the way our Papa take dey forgive us if we make mistake.—Read Psalm 103:12-14.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share