‘No Fear. I Go Help You’
THINK am sey you dey waka for road for night. As you dey waka, e come be like sey person dey follow you for back. You stop, the person stop; you waka fast, the person waka fast. Na im you start to run; you run go one of your friend house wey near there. As your friend open door make you enter, your mind just come down.
E fit be sey this kind thing never happen to you before. But e still get other things for life wey fit make person fear or worry. For example, e get any bad thing wey you dey try to stop but e dey hard you to stop? E don tey wey you dey find work but you never see? E dey worry you sey you don dey old and sey sickness wey dey follow old age fit come? Or e get another thing wey dey worry you?
No matter the kind problem, if you get friend wey you fit talk to about your problem and wey fit help you, you no go happy? That kind friend dey? Yes, e dey! Jehovah na that kind friend. Isaiah 41:8-13 talk sey na that kind friend Jehovah be to Abraham. For verse 10 and 13, Jehovah dey tell im servant dem sey: ‘No fear because I dey with you. No worry because I be your God. I go make you strong, yes, I go help you, I go really hold you with my right hand wey good. Because me, Jehovah your God, dey hold your right hand, the Person wey dey tell you sey, “No fear. I go help you.”’
“I GO REALLY HOLD YOU”
You no happy sey Jehovah talk this kind thing? Just think about wetin e mean. No be sey you and Jehovah dey waka together, even though sey that one na better thing. Because if una dey waka together, e go use im right hand hold your left hand. But Jehovah dey use im ‘right hand wey good’ take dey hold ‘your right hand,’ like sey e dey draw you comot for problem. As Jehovah dey draw you comot, e dey tell you sey: ‘No fear. I go help you.’
You dey see Jehovah as Papa and Friend wey love you and wey ready to help you when you get problem? Jehovah get you for mind and e want really help you. When you get problem, Jehovah no want make you worry yourself. Why? Because e really love you. And ‘e ready to help us anytime time when trouble dey.’—Ps. 46:1.
THE MISTAKE WEY YOU DO BEFORE STILL DEY WORRY YOU?
Some people too dey worry theirself about some of the mistake wey dem don do before. Dem dey worry because dem no sure sey God don forgive dem. If e dey do you like that, think about Job wey serve God well. E talk sey e do ‘bad things when e young.’ (Job 13:26) This kind thing self happen to David, wey make am beg Jehovah sey: ‘No remember the bad things and the mistake wey I do when I young.’ (Ps. 25:7) Because we no dey fit do wetin God want without mistake, na im make Bible talk sey all of us ‘don sin and we no fit reach God glory.’—Rom. 3:23.
Wetin dey Isaiah chapter 41 na something wey God tell Israel people. Their sin don plenty sotey Jehovah come talk sey e go punish dem. E go let Babylon people carry dem go Babylon as slave. (Isa. 39:6, 7) Even with that one, God dey think about the time wey e go save the ones wey go repent, come dey serve am again! (Isa. 41:8, 9; 49:8) Today, Jehovah still get that kind mind for people wey repent and wey really want do wetin e want.—Ps. 51:1.
Think about Takuya,a wey dey try to stop to watch film wey dey show naked people and e still dey try to stop to dey rub im private part. As e try reach, many times e still do am again. How e make am feel? “E just be like sey I don useless finish. But when I pray sey make Jehovah forgive me, e dey help me get up again.” How Jehovah take help am? The elders wey dey Takuya congregation come tell am sey make e call dem anytime wey e happen again. E talk sey: “E no easy for me to call dem, but anytime wey I call dem, e dey make me strong.” The elders come arrange make circuit overseer visit am. Circuit overseer tell am sey: “No be by mistake I take come here. I come here because the elders sey make I come. Na you dem choose sey I go visit.” Takuya talk sey: “Na me dey sin, but Jehovah use the elders take help me.” Takuya change, e stop the bad things wey e dey do and come even be regular pioneer. Today, e dey work for one of our branch office. As Jehovah take help this brother, e go help you when you fall.
YOU DEY OVER WORRY YOURSELF WHEN YOU NO GET WORK?
Many people dey worry well well when dem no get work. E dey hard some people wey get work before, to see another work. How e go be if you dey find work but nobody gree give you work? This kind thing dey make some people dey feel sey dem useless. How Jehovah go help you when this one happen? E fit no be sey you go get another work quick quick, but e go help you as e take help King David wey talk sey: ‘E get the time wey I young and now I don old, but I never see where God leave person wey dey serve am, or sey im pikin come dey beg for food.’ (Ps. 37:25, ftn.) True true, Jehovah love you well well and e go use im ‘right hand wey good’ take help you get wetin you need to still dey serve am.
How Jehovah fit help you if you no come get work again?
Sara wey dey live for Colombia see as Jehovah take help am. E dey work for one company wey dey pay am better money. But the thing be sey the work dey chop im time well well. Since e want do more for Jehovah work, e come stop the work, come start to pioneer. But e hard am to find the part-time work wey e need. So, e come start ice-cream business but money no come dey to continue. E come stop the business. Sara talk sey: “Three years pass and nothing-nothing, but I thank Jehovah wey help me bear am.” E make am sabi sey wetin e need different from wetin e want. E stll help am make e no dey worry about tomorrow. (Matt. 6:33, 34) At last, im former oga come call am, give am that work wey e dey do before. But e tell am sey na only if e gree make e do part-time work and if e give am free time to fit do God work, na im e go work for am. Even though dem no dey pay Sara the kind money wey dem dey pay am before, e still dey pioneer. E talk sey: “For everything I see Jehovah hand for my life.”
YOU DEY WORRY SEY OLD AGE DEY COME?
Old age na another big problem. Many people wey don reach the age to stop work dey fear. Na because dem no know whether the money wey dem get go fit reach dem to take manage life. And dem still dey worry sey sickness wey dey come with old age dey front. E be like sey na David beg Jehovah sey: ‘No trowey me when I don old; no leave me when I no get power again.’—Ps. 71:9, 18.
Wetin go help Jehovah people no worry sey dem don dey old? Make dem continue to believe sey God go give dem wetin dem need. The truth be sey some of dem wey dey live big man life before, go need to live simple life now. Dem fit see sey ‘to eat vegetable’ instead of ‘fat cow’ good for their body and dem go still enjoy am! (Prov. 15:17) If you put all your mind to make Jehovah happy, e go take care of you even when you don old.
José and Rose with Tony and Wendy
For example, e don pass 65 years wey José and Rose dey serve Jehovah. For many years, dem take care of Rose papa wey no well; dem no fit leave am because person need to dey with am every time. Another thing be sey, José need to bear cancer operation and cancer treatment. How Jehovah take help this husband and wife? E use Tony and Wendy, one husband and wife wey dey their congregation. Tony and Wendy give José and Rose free house to stay because na wetin dem get for mind to do for people wey dey pioneer full-time. Tony talk sey e remember when e still dey secondary school, many times when e look from im school window, e go see José and Rose dey preach. This one make am like dem well well. Because José and Rose use all their life take serve Jehovah, e make Tony and Wendy help dem. E don reach 15 years now wey José and Rose don dey stay with Tony and Wendy. Now José and Rose don pass 80 years. Dem talk sey na Jehovah give dem Tony and Wendy.
Na so God still dey give you im ‘right hand wey good’. You go gree give am your hand make e hold? No forget wetin e promise you: ‘No fear. I go help you.’
a No be im real name be that.