Help Your Pikin Make E Get Faith
‘Young man and young woman, make dem praise Jehovah.’—PS. 148:12, 13.
SONG: 88, 115
1, 2. (a) Wetin be the hardest work wey papa and mama go ever do, and wetin go fit help dem? (b) Which four things we go talk about?
ONE husband and wife for France talk sey: “Because we believe sey Jehovah dey, no mean sey our pikin go believe. Faith no be wetin you fit give person. Na small small our pikin go take get faith.” One brother wey come from Australia write sey: “The hardest work wey you go ever do, na to help your pikin get faith. You go need to use everything wey you get. You fit dey think sey you don answer the question wey your pikin ask you well. But e fit surprise you sey after, the pikin go still ask you the same question again! The answer wey you give am today fit no be wetin e need tomorrow. E get some question wey una go need to talk about many times.”
2 If you be papa or mama, you dey feel sometimes sey you no reach to fit train your pikin make dem be people wey get faith? True true, if we use our own sense, we no go fit do am! (Jer. 10:23) But if we let God direct us, we go fit. Make we see four things wey fit help you: (1) Know the kind pikin wey you get. (2) Teach your pikin wetin you know about Jehovah. (3) Use better example. (4) Make you take am easy with dem and make you dey pray about the matter.
KNOW THE PIKIN WEY YOU GET
3. How papa and mama fit follow Jesus example when dem dey teach their pikin?
3 Jesus no fear to ask im disciple wetin dem believe. (Matt. 16:13-15) E good make we follow im example. The best time to know wetin dey your pikin mind na when you and dem dey play or do things together. Una fit talk about anything wey dey worry dem or wey dey make dem fear. One brother for Australia wey dey 15 years write sey: “My papa dey always help me to sabi why I believe wetin I believe. E go ask me: ‘Wetin Bible talk?’ ‘You believe wetin e talk?’ ‘Why you believe am?’ E want make I talk wetin dey my mind no be just wetin im or my mama talk. As I come dey grow, the way I take dey answer the question come dey better.”
4. Why e good make papa and mama no take their pikin question play? Give example.
4 If e get something for Bible wey your pikin no too believe, make you no vex for am or force am to believe am. Make you sofri help am think about the matter. One papa talk sey: “No take your pikin question play, or take am as small pikin talk, and no run from any question wey your pikin ask you because you no too like the question.” E good make you take am sey your pikin dey ask all this question because e really want learn. Even when Jesus dey 12 years, e ask question. (Read Luke 2:46.) One boy for Denmark wey dey 15 years talk sey: “When I talk sey I no sure whether our religion na the correct one, my papa and mama no vex for me, even though sey wetin I talk fit dey worry dem for mind. Dem come use Bible answer all my question.”
5. How papa and mama go take show sey dem want make their pikin get faith?
5 Know your pikin well. Know how e dey think, how e dey feel, and the things wey dey worry am for mind. No think sey because dem dey follow you go meeting for Kingdom Hall or preaching, dem get faith. Add Bible matter join wetin una dey talk about every day. Dey pray for your pikin, whether dem dey with you or dem no dey. Try know anything wey fit make their faith weak, and help dem make dem strong.
TEACH YOUR PIKIN WETIN YOU KNOW ABOUT JEHOVAH
6. When papa and mama know the truth wey dey Bible, how e fit help dem teach their pikin?
6 Wetin Jesus teach people, touch their mind because Jesus love Jehovah, Bible and the people wey e dey teach. (Luke 24:32; John 7:46) If papa and mama get this kind love, e go make wetin dem dey teach their pikin, touch im mind. (Read Deuteronomy 6:5-8; Luke 6:45.) So, papa and mama, e good make una know the truth wey dey Bible and wey dey our publication. Make una take una time try know about the many things wey Jehovah don make and dey read any topic for our book wey dey talk about dem. (Matt. 6:26, 28) If una dey do this one, una go sabi many things, una go love Jehovah more and una go fit teach una pikin well.—Luke 6:40.
7, 8. Wetin go happen when the things wey dey Bible dey for papa and mama mind? Give example.
7 When the things wey you dey learn for Bible dey your mind, you go want teach your family. Use any chance wey you get take teach dem, no be only when una dey prepare for meeting or when una dey do family worship. One thing be sey, no force your family make dem listen. But make the way you dey teach dem, be like the way una dey talk every day. One husband and wife for United States dey like talk about Jehovah when dem see something wey Jehovah make wey fine well well or when dem chop better food. Dem talk sey: “We dey help our pikin dem think about the kind love wey make Jehovah give us all this things.” One husband and wife for South Africa talk sey when dem carry their two girls go farm, dem use the chance talk about how seed take dey grow. Dem sey: “We try help our pikin make dem see the many things wey make us dey enjoy life and why dem no suppose take am play.”
8 One papa for Australia use the time wey e carry im pikin go museum teach am wetin go help am get strong faith for God and the things wey God make. That time the pikin dey ten years. E sey: “We see some animal wey dey stay inside water before before, but wey no dey again. E really surprise us sey dem fine well well, get different different part and everything for their body complete like the animals wey we dey see today. So, if na true sey life start from something wey get only one part wey come dey form different different part, why e be sey this olden days animal don already get different part wey complete? Na something wey really touch me and I tell my pikin.”
USE BETTER EXAMPLE
9. Wetin make better example dey touch person mind and how one mama take do am?
9 Jesus use example well well when e dey teach. E use example wey go make people think, wey go touch their mind and wey dem fit remember. (Matt. 13:34, 35) Because picture or story dey stay for pikin head well well, e good make papa and mama dey use am teach their pikin. Na wetin one mama for Japan do. The time wey im two boys be eight and ten years, e teach dem about this earth and how Jehovah take make am. E use milk, sugar and coffee take teach dem. E give two of dem separate separate milk, sugar and coffee, come sey make dem use am make coffee for am. E sey: “Dem sofri do am. When I come ask dem why dem sofri do am, dem sey dem want do am the way I go like am. I come tell dem sey na so Jehovah take make this earth. E sofri do am, so that e go good for us.” Because of their age, that example no hard dem to understand. Dem understand am pass if to sey I just talk am for mouth. True true, e no comot for their mind!
You fit use wetin your pikin dey see every day, help am get faith and teach am about the things wey Jehovah make (Check paragraph 10)
10, 11. (a) Which example you fit use help your pikin make e get faith? (Go check the first picture.) (b) Which other example you don use?
10 When you and your pikin dey cook, na another chance wey you fit use help am get faith. How? If una fry something like akara, let am know sey na because una follow how dem take dey make Akara, na im make the Akara be like this. After that one, give am any fruit, like apple and ask am: “Wetin make if you see apple, you know sey na apple?” Cut the apple into two, give am the seed. Tell am sey wetin dey make apple dey always be apple dey inside the seed. But person no fit know how to make apple, the way person take dey know how to make akara. So, ask am: “If na human being dey make akara, who you think sey na im make apple?” If the pikin don grow, you fit tell am sey wetin dey make apple seed become apple tree , still dey inside the seed. Una fit go check the picture wey dey page 10 to 20 for inside our brochure The Origin of Life—Five Questions Worth Asking.
11 Many people dey like follow their pikin talk about “Was It Designed?” wey dey Awake! Or if the pikin small well well, dem fit use the picture take explain am for dem. For example, one husband and wife for Denmark use aeroplane and bird teach their pikin. Dem ask their pikin sey: “Aeroplane resemble bird no be so? But una don see where big aeroplane dey born small aeroplane? If bird want fly come down, dem dey arrange special place for am to land? The kind sound wey aeroplane dey make if e dey pass and the one wey bird dey make when e dey sing, which one you like pass? So, which person get sense pass, na the person wey make aeroplane or the person wey make bird?” This kind question fit help our pikin to get the ‘power to think’ and help dem get faith.—Prov. 2:10-12.
12. How example wey dey touch mind fit help pikin get faith for wetin dey Bible?
12 Example wey dey touch mind fit still help your pikin believe sey wetin dey Bible na true. For example, make we check wetin dey Job 26:7. (Read am.) How you fit teach your pikin sey na God spirit help the person wey write this verse for Bible? You fit just talk am the way e be. But, you no think sey e go better to help your pikin use im brain? Help am know sey for Job time, wetin dem take dey see far (telescope) no dey. Your pikin own fit be to talk why e fit hard some people to believe sey something wey big well well like this our earth dey ontop nothing. E fit use ball or stone as example, because ball or stone need to stand ontop something before e go fit stand. But that time, people no know sey nothing dey hold this earth because telescope no dey. This one go help your pikin know sey even though sey e don tey wey dem write Bible, na Jehovah get am. Because when people check the things wey dey Bible, e always dey correct.—Neh. 9:6.
TEACH YOUR PIKIN WHY E GOOD TO FOLLOW WETIN DEY BIBLE
13, 14. How papa and mama fit teach their pikin why dem suppose follow wetin dey Bible?
13 E good well well to teach your pikin why dem suppose follow wetin dey Bible. (Read Psalm 1:1-3.) E get many way to do this one. For example, you fit tell your pikin make dem think am sey dem want go stay for one island wey far and dem go need to choose some people wey go stay with dem. Then ask dem sey, “Which kind character you think sey everybody wey go live for that island suppose get so that peace go dey and dem go fit do things together?” You fit even follow dem talk about wetin dey Galatians 5:19-23.
14 This one fit help dem learn two things. One, sey wetin dey Bible fit make peace dey and make people dey do things together. The second thing be sey, the things wey Jehovah dey teach us now, dey help us ready to live life for paradise. (Isa. 54:13; John 17:3) You fit even use one of the story wey dey any of our book help am. You fit use the one wey dey inside Watchtower wey be “The Bible Changes Lives.” Or if e get person for una congregation wey Bible don change im life, you fit invite am, make e tell una about im story. That kind example go help am sabi wetin e mean to follow wetin dey Bible!—Heb. 4:12.
15. Wetin be the main thing wey you suppose get for mind as you dey teach your pikin?
15 The thing be sey: When you dey teach your pikin, no dey talk one word plenty times because e go make the pikin tire. Try think of different different style wey you fit use. Help dem make dem use their brain, but no forget their age. Help dem to enjoy wetin dem dey learn, and make their faith strong. One papa talk sey: “No tire to find new new way to teach old topic.”
GET FAITH, TAKE AM EASY WITH DEM AND DEY PRAY EVERYTIME
16. Why e good make papa and mama take am easy with their pikin when dem dey teach dem? Give example.
16 Na God spirit dey help us get strong faith. (Gal. 5:22, 23) As seed no fit use one day grow, na so faith be. E dey take time before e grow. That one mean sey papa and mama suppose take their time and no tire to teach their pikin. One papa for Japan wey get two pikin talk sey: “Me and my wife dey spend time with our pikin dem well well. From when dem small, I dey use 15 minute every day to study with dem. But na only the day wey be our meeting, I no dey study with dem. That 15 minutes just good for us and for dem.” One circuit overseer write sey: “When I dey about 13 to 19 years, I get many question wey dey my mind. But as time dey go, I come dey learn about many of dem for meeting, family worship or my personal study. Na wetin make e good make papa and mama no tire to teach.”
To teach your pikin well, wetin dey Bible must first dey your mind (Check paragraph 17)
17. Why papa and mama example good, and how one husband and wife take show am?
17 One thing wey dey important well well na your own example wey show sey you get faith. Your pikin dey look wetin you dey do, and that one go affect how their own life go be. So, papa and mama make una continue to dey make una faith strong. Make your pikin see sey you really trust Jehovah. One husband and wife for Bermuda talk sey when anything dey worry dem, dem dey follow their pikin pray make Jehovah help dem. Dem go still tell their pikin make dem pray by theirself. “We still tell our senior pikin sey, ‘Use all your mind trust Jehovah, dey do im work, and make you no too worry.’ When e see the result, e know sey na Jehovah dey help us. This one done make im faith for God and Bible strong well well.”
18. Wetin papa and mama suppose know?
18 For the end, na the pikin go choose whether e go serve Jehovah. As papa and mama, your work na to plant and to put water. But na only God fit make am grow. (1 Cor. 3:6) So pray make God give you im spirit, and make you try to dey teach your pikin. Na when you don do this one, Jehovah go fit bless your work.—Eph. 6:4.