‘God word dey alive’
Question From People Wey Dey Read Our Book
Wetin be that ‘God word’ wey Hebrews 4:12 talk sey ‘dey alive and e get power’?
Wetin Paul talk for this verse show sey na the message wey dey Bible or wetin God get for mind to do, this place dey talk about.
Many times for our book we dey use Hebrews 4:12 take show sey Bible get power to change people life. And the way we dey explain am, correct. But if we check from verse one, e go really help us. Paul dey tell Hebrew Christian make dem support wetin God get for mind to do. And many of this things don dey Bible. Paul use Israel people, wey Jehovah save from Egypt as example. Dem get hope sey dem go enter the land wey God promise dem, land wey milk and honey dey flow. And na for there dem go really rest.—Ex. 3:8; Deut. 12:9, 10.
Na wetin God talk sey e go do be that. But Israel people no hear word and dem no come get faith, na im make many of dem no enter God rest. (Num. 14:30; Josh. 14:6-10) But Paul come talk sey we still get ‘the promise to enter God rest.’ (Heb. 3:16-19; 4:1) That ‘promise’ na part of wetin God talk sey e go do. Like the Hebrew Christian, we go fit read about wetin God promise and support am. Paul talk some things wey dey Genesis 2:2 and Psalm 95:11 to really show sey Bible support this promise.
This promise suppose touch our mind because we still get hope to enter God rest. We believe wetin Bible talk sey we go fit enter God rest, and we dey try do things wey go make us enter. This things wey we dey try do, no be to follow Moses law or to do other things wey we feel sey go make Jehovah like us. But because of our faith we dey happy to support wetin God want do, and we go continue to dey support am. As we talk before, many many people for this world don start to dey study Bible. And dem don dey learn about all the better better things wey God talk sey e go do. Many of dem don change how dem dey live their life, come get strong faith, come even baptize. This one really show sey ‘God word dey alive and e get power.’ Wetin Bible tell us sey God go do don make our life better, and e go continue to dey give us power.