Continue to Fight Make Jehovah Bless You
‘You don follow God and men fight, and at last, you don win.’—GEN. 32:28.
SONG: 60, 38
1, 2. Wetin be the things wey Jehovah servant must fight with?
PEOPLE wey serve Jehovah well, from Abel time come reach our time don fight for their faith. Wetin apostle Paul write give Hebrew Christian show sey, even though sey dem suffer, dem still fight well well for their faith. Dem do am, to make Jehovah happy so that e go bless dem. (Heb. 10:32-34) Paul talk sey the fight wey Christian dey fight be like the one wey people wey dey run and do boxing for Greece dey do. (Heb. 12:1, 4) Today, the kind run wey we dey run na to get life. But we get some enemy wey want make us comot mind for wetin we dey do. Dem want spoil our mind, make us tire, fall, and make us no get wetin God don promise us.
2 The number one enemy wey we get serious fight with na Satan and im wicked world. (Eph. 6:12) E good make we no let ‘things wey don get root’ for this world affect us. Things like, wetin people believe and how dem dey think. Other things wey fit still affect us na the kind bad life wey people dey live. Dem dey smoke cigar, igboo, take snuff, over drink, and put hand for sex wey no clean for God eye. Make we continue to dey fight the sin wey dey our body and anything wey fit make us tire to serve Jehovah.—2 Cor. 10:3-6; Col. 3:5-9.
3. How God take dey train us to fight our enemy?
3 You think sey we fit win all this strong enemy? Yes, but we must fight well well. Paul use the example of person wey be boxer for im time, when e talk sey: ‘The way I take dey target my blow no be to dey blow breeze.’ (1 Cor. 9:26) As boxer take dey fight im enemy, make we self fight all our enemy comot. Jehovah dey train us and help us to fit win our fight. For Bible, Jehovah dey teach us wetin fit help us get life. E still dey use our book, meeting, assembly, and convention dey help us. You dey do wetin you dey learn? If you no dey do am, e go be like sey you dey ‘blow breeze,’ and you no dey fight your enemy well.
4. Wetin we go do if we no want make bad thing win us?
4 Our enemy fit come fight us, when we no think am. Dem fit come when we no even get power at all, so make we ready our self every time. Bible warn us sey: ‘No let bad thing win you, but continue to dey win bad thing with good thing.’ (Rom. 12:21) This advice ‘no let bad thing win you’ show sey we go fit win bad thing. We go fit, if we continue to fight am. But if we tire and we stop to fight, e mean sey Satan, this wicked world and the sin wey dey our body fit win us. No let Satan put fear for your body, make your hand weak sotey you no go fit fight am again!—1 Pet. 5:9.
5. (a) Wetin fit help us continue to fight so that we go fit enjoy God blessing? (b) Which people example we go talk about?
5 If person dey fight and e want win, wetin e go do? E go dey think about wetin make am start that fight. Na so e still be today, anybody wey want enjoy God blessing and be im friend, go carry this correct word wey dey Hebrews 11:6 for mind, e sey: ‘Anybody wey want near God must believe sey e dey, and sey na im dey bless the people wey dey use all their mind find am.’ The Greek word wey dem translate as ‘use all their mind find am’ show sey na all our power we go use and e go come from our mind. (Acts 15:17) Bible tell us example of some men and women wey use all their power and mind find Jehovah. Jacob, Rachel, Joseph, and Paul suffer many things wey make dem weak, but dem bear am and God later bless dem. Their example show sey if we fit bear suffer, we go gain. How we go fit copy their example?
GOD GO BLESS US IF WE NO TIRE TO FIGHT
6. Wetin help Jacob continue to fight, and how God take bless am? (Go check the first picture.)
6 Jacob continue to fight and e no tire to serve Jehovah because e love Jehovah. Everything about Jehovah dey make am happy, and e use all im mind believe wetin Jehovah promise, sey e go bless all the people wey go come from am. (Gen. 28:3, 4) Na this one make us know why Jacob even as e don nearly reach hundred years, still follow God angel fight, so that e go bless am. (Read Genesis 32:24-28.) Jacob fight with the angel from night till morning. You think sey na Jacob give imself the power wey e use? No! But Jacob na person wey ready to face anything, and e really show sey e no go run when problem come! And true true, God bless am because e no tire to fight. God give am name wey fit am, Israel (wey mean ‘Person Wey Fight With God’). Jacob get better gain, e come be God friend and God bless am. Na this kind gain we self dey find today, no be so?
7. (a) Wetin be the wahala wey Rachel face? (b) Wetin help am continue to fight and bear im problem till God bless am?
7 Rachel, wey be the wife wey Jacob love, be like Jacob. E wait to see how Jehovah go do wetin e don promise im husband. But e come be like sey one wahala wey pass im power dey. Wetin be that? E no get pikin. That time, na serious problem if woman no born. But wetin help Rachel continue to fight and bear this problem? E no tire, e get hope sey God go help am. E continue to pray make God help am. Jehovah later answer Rachel prayer, and e born. Na im make e talk sey: ‘I don really use all my power fight. And I don still win!’—Gen. 30:8, 20-24.
8. Which kind problem Joseph come get, and how im example fit help us today?
8 Jacob and Rachel show Joseph their pikin better example. And this one help Joseph fit face the problem wey e later get. When Joseph dey 17 years, im life turn upside down finish. Im brothers sell am as slave because dem dey jealous am. After, for Egypt, e go prison for wetin e no do. (Gen. 37:23-28; 39:7-9, 20-21) Joseph no let this one make am tire to serve God; and e no carry am for mind sey e go do dem back. But, wetin dey im mind na the blessing wey God don give am because im na God friend. (Lev. 19:18; Rom. 12:17-21) Joseph example fit help us today. For example, even if bad thing happen to us when we small or our condition now be like sey hope no dey, make we continue to fight and bear the problem. We dey sure sey, if we no tire, Jehovah go bless us.—Read Genesis 39:21-23.
9. Like Jacob, Rachel, and Joseph wetin we go do so that Jehovah go bless us?
9 E fit be sey you get one problem wey dey worry you, wey fit make you want stop to serve Jehovah. For example, people fit no judge your matter well, dem fit no like you or dey laugh you because you dey serve Jehovah. E fit still be sey person lie about you because e dey jealous you. Instead make you let your hand weak, remember wetin help Jacob, Rachel, and Joseph to dey happy as dem dey serve Jehovah. God give dem power and e bless dem because dem no stop to dey do wetin e like. Dem continue to dey fight and do wetin dem pray for. Since this world go soon end, make we dey always put wetin Jehovah don promise us for mind! You ready to fight to do wetin good so that Jehovah go bless you?
READY TO FIGHT MAKE JEHOVAH BLESS YOU
10, 11. (a) Wetin be some things wey fit make us fight make God bless us? (b) Wetin fit help us choose wetin good and win our fight?
10 Wetin be some things wey fit make us fight make God bless us? Some of dem fit be bad character wey we get or sey we no too like to dey preach. E fit still be sey you dey struggle with sickness or sey na only you dey or e dey hard you to forgive person wey make you vex. So, whether e don tey wey we dey serve Jehovah or we just start, make all of us continue to fight any thing wey fit make us stop to serve Jehovah, so that e go bless us.
You dey fight make God bless you? (Check paragraph 10, 11)
11 The truth be sey, e no easy to choose wetin good and to dey live like Christian. This one come even hard more more because our mind fit deceive us to do wetin bad. (Jer. 17:9) If you know sey this kind thing don dey affect you, make you pray make Jehovah give you im holy spirit. Prayer and God holy spirit fit give you power to do the correct thing wey Jehovah go bless. Do wetin you dey pray for. Try to dey read Bible every day, and get time wey you go dey do personal study and Family Worship.—Read Psalm 119:32.
12, 13. Wetin help one young person and one sister control the bad thing wey dem dey think?
12 E get many example wey show how Bible, holy spirit, and our book don help our brothers and sisters to fight bad character. One young person wey dey 17 years read the topic “How Can You Resist Wrong Desires?” wey dey December 8, 2003 Awake! How e feel when e read am finish? E talk sey: “I dey try make I no dey think bad thing. Wetin I read from that topic show sey ‘e no easy for many people to comot bad thing for mind,’ e make me know sey I still be part of Jehovah people. I know sey no be only me dey.” This young person still gain from another topic wey be “Alternative Life-Styles—Does God Approve?” wey dey October 8, 2003 Awake! E talk sey for some people, dem dey fight wetin be ‘like chukuchuku for body.’ (2 Cor. 12:7) But as dem dey fight to get better character, make dem get am for mind sey dem fit win. E come sey: “Because of that one, I believe sey I fit dey serve Jehovah well every day. I thank Jehovah sey e dey use im organization dey help us do wetin e like every day even for this wicked world.”
13 Make we still see the example of one sister for United States. E write sey e thank Jehovah organization for wetin dem dey always teach us; the things dey come the right time and na wetin we need. E sey: “I dey always feel sey dem dey write all the topic for me. Many years don pass wey I don dey fight one thing wey Jehovah hate. Sometimes, e dey do me like sey make I just stop to fight. I know sey Jehovah dey pity person and e dey forgive. But because I no stop to dey think bad thing and I no see am as bad thing, I come feel sey God no go fit help me. This fight don affect everything for my life. . . . After I read the topic wey be ‘Do You Have “a Heart to Know” Jehovah?’ wey dey March 15, 2013 Watchtower, I come really know sey Jehovah want help me.”
14. (a) Wetin Paul talk about wetin e dey fight with? (b) Wetin go help us fit win our fight with any bad thing wey we dey do?
14 Read Romans 7:21-25. Paul know sey e no easy for person to fight with character and sin wey dey im body. But e still dey sure sey if e dey pray, trust Jehovah, and if e get faith for Jesus sacrifice, e go fit win this fight. What of us? We fit still win our fight with any bad thing wey we dey do. How? Make we do like Paul. Instead make we think sey we fit do am by ourself, make we trust Jehovah to help us and make we get faith for Jesus sacrifice.
15. Why e be sey prayer fit help us bear any problem and continue to serve Jehovah well?
15 Sometimes, God fit allow us show how we want something reach. For example, what if we (or person for our family) dey sick well well or if person lie about us? Make we pray to Jehovah make e give us power to continue to serve am well, so that we fit still be im friend. This one go show sey na only Jehovah we trust. (Phil. 4:13) Wetin don happen to many of God servant for apostle Paul time and for our time, show sey prayer fit give us power and strong mind to continue to bear any problem.
CONTINUE TO DEY FIGHT MAKE JEHOVAH BLESS YOU
16, 17. Wetin you don get for mind sey you go do?
16 Devil go want really make sure sey e make your hand weak, so that you go stop to serve Jehovah. Tell yourself sey you go ‘hold wetin good tight.’ (1 Thess. 5:21) Get am for mind sey you fit win Satan, im wicked world, and any bad thing wey you dey fight with. You fit win the fight, if you trust sey God go give you the power to win the fight.—2 Cor. 4:7-9; Gal. 6:9.
17 So, no stop to dey fight, continue to dey try, no tire. Get the mind sey Jehovah go ‘pour blessing on top una until una no come dey find anything again.’—Mal. 3:10.