Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 October pp. 18-20
  • You Dey Show Sey You Get ‘Better Sense’?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • You Dey Show Sey You Get ‘Better Sense’?
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • WETIN BETTER SENSE MEAN?
  • HOW I GO TAKE GET BETTER SENSE?
  • HOW BETTER SENSE FIT TAKE HELP FAMILY?
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 October pp. 18-20

You Dey Show Sey You Get ‘Better Sense’?

E GET one story about one small boy wey dey stay one village. E no get money. The people for the village dey laugh am because dem think sey e no get sense. When visitor come, some of the people for the village dey use the boy do yeye for where their friend dey. Dem go show am two coins. The big one na silver and the small one na gold. One gold coin fit buy two silver coins. Dem go tell the boy sey, “Choose the one wey you like pass.” The boy go choose the big one, come run comot.

One day, one visitor come ask the boy sey, “You no know sey na the small coins wey dem make with gold better pass the other one? The small boy laugh, e come tell am sey “I know.” The visitor come ask am, “Why you come dey collect the big silver coins? You go get times two if you collect the small one wey dem use gold make!” But the boy tell am sey, “If I collect the one wey better pass, dem no go dey call me again to come choose. You know how many silver coins I don collect?” That small boy really show sey e get better sense. People wey don big fit learn something from this small boy.

Bible talk sey: ‘Keep better sense and the power wey you get to think. You go come fit waka go where you dey go, nothing go do you. And your leg no go nack anything.’ (Prov. 3:​21, 23) So, if we know wetin ‘better sense’ be and how to use am, e go help us stand well for Jehovah side, we no go fall.

WETIN BETTER SENSE MEAN?

To know something, to understand am, and to get better sense no be the same thing. Person wey know something dey fit learn things and remember am. Person wey understand something dey know how one thing take concern another one. Person wey get sense, when e don know something and understand am, e go come use am well.

For example, person wey dey study Bible, fit use small time take read and understand What Does the Bible Really Teach? When e dey study, e fit talk the correct answer. E fit even start to dey come meeting and answer question well for meeting. All this one fit show sey e dey do well. But that one mean sey e don really get sense? No! E fit be sey e dey quick sabi something. But, na when e start to do wetin e dey learn, e go show sey e don dey get sense. If e dey think well before e choose wetin e want do, and the thing come get head, that one show sey e don really get better sense.

For Matthew 7:​24-27 Jesus talk about two people wey build house. One of dem show sey e get sense. Before e build im house, e first sitdown think about wetin fit happen. E come build im house on top rock. Wetin e do show sey e dey think far and e know wetin fit happen. E no talk sey e go cheap to build the house on top sand sand. But the man think about wetin fit happen for front. So, when heavy breeze blow, nothing happen to im house. But how we go take get this kind better sense and keep am?

HOW I GO TAKE GET BETTER SENSE?

Make we first see wetin Micah 6:9 talk, that place talk sey: ‘People wey get better sense go fear [God] name.’ To fear Jehovah mean sey we go respect am. E mean sey we go know wetin im name really mean and wetin e want make we do. To fit respect person, you go first know how e dey think. That one go make you trust am, learn from am, and copy im better example. E good make we think well well before we do something, because wetin we do fit make Jehovah be our friend or make am vex for us. E still good for us to dey use wetin Bible talk take do something. If we do all this things, we go dey get better sense.

The second one dey for Proverbs 18:⁠1. That place talk sey: ‘The person wey dey separate imself from other people dey do wetin only im want; e no go gree get any better sense.’ If we no dey careful, we fit leave Jehovah and im people. E good make we dey spend time with people wey dey respect God name and dey follow wetin e talk, so that this kind thing no go happen. We go try make sure sey we dey go meeting, and dey spend time with people for congregation. When we dey for Kingdom Hall, e good make we open our mind well well and allow wetin we dey hear touch us for mind.

Apart form that one, we go still dey pray to Jehovah, and tell am everything wey dey for our mind. Prayer dey make us near Jehovah well well. (Prov. 3:​5, 6) When we dey use all our mind dey read the book wey Jehovah organization dey give us, we go know wetin go come out of wetin we want do, and know the better thing to do. Make we still dey use all our mind follow the advice wey mature people for congregation dey give us. (Prov. 19:20) If we put mind do wetin this place talk, we go continue to dey get better sense.

HOW BETTER SENSE FIT TAKE HELP FAMILY?

For family to strong, dem need to get better sense. For example, Bible sey make wife dey ‘respect’ im husband well well. (Eph. 5:33) Wetin husband go do if e want make im wife dey respect am? If e force im wife to dey respect am, the respect no go last. Im wife fit just dey respect am only when e dey around, make quarrel no dey. But once e comot, the respect fit disappear. E need to think about wetin e go do for im wife to dey respect am. If e dey show the better character of God holy spirit, e go dey do wetin go make im wife respect am well well. E go dey show im wife love and get better mind for am. Woman wey dey serve Jehovah suppose to dey respect im husband whether e deserve am or no deserve am.​—⁠Gal. 5:​22, 23.

Bible still talk sey make husband love im wife. (Eph. 5:​28, 33) Some people think sey e better to hide wetin no good from their husband, make their husband no stop to dey love dem. But that one show better sense? Wetin go later happen if the husband come know? E go still love im wife? E go hard o! Wetin better pass, na for the woman to find better time to sofri explain the matter to im husband. The man go happy sey im wife tell am the truth. That one go make im husband love am well well.

One papa dey think of two different way e go take teach im pikin and the result

How you take correct your pikin today go affect how dem go take talk to you tomorrow

Make children dey hear word for their papa and mama, and make papa and mama dey teach their pikin wetin Jehovah want. (Eph. 6:​1, 4) That one no mean sey dem go write wetin the pikin go do and wetin e no go do for one long paper. No be just for pikin to know wetin dem tell am or to punish am when e do bad. Papa and mama wey get better sense go help their pikin know why e good to dey hear word.

For example, wetin mama or papa go do if im pikin talk to am anyhow? If the papa or mama use e as e take vex am, curse the pikin or punish am, the pikin fit come dey shame or stop to dey talk to dem. And pikin wey get bad belle for im papa or mama no go like to near dem.

Papa and mama wey get better sense go think how dem go take correct their pikin and wetin go come out of am. If the pikin do wetin pain dem, make dem no use as e take pain dem punish am. E go better make dem sofri call the pikin and talk to am, tell am why Jehovah want make e dey hear word and wetin e go gain if e dey hear word. The pikin go come know sey na Jehovah e dey obey, if e dey hear word for im papa and mama. (Eph. 6:​2, 3) This one go touch the pikin for mind. The pikin go come know sey im papa and mama really like am and this one go make am dey respect dem. The pikin no go dey fear to come meet im papa and mama when e get problem.

Some papa and mama no dey correct their pikin because dem no want make the pikin vex. Wetin go happen to the pikin as dey grow? The pikin go fit fear Jehovah and know sey e good to do wetin e talk? That one go help am use all im mind follow Jehovah, or e go make am stop to dey serve Jehovah?​—⁠Prov. 13:1; 29:⁠21.

Person wey dey carve something, dey first sitdown think about wetin e want carve before e carve am. Na so e still be for papa and mama. Papa and mama wey get better sense dey sitdown study Bible and follow wetin e talk, and dey respect God name. When papa and mama no leave Jehovah and im organization, dem go get better sense wey dem fit use help their family.

Everyday, we dey choose things wey we go do. And wetin we choose fit affect our life tomorrow. So no hurry, make you stop, think am well. Think about wetin go come out of wetin you want do. Pray make Jehovah help you, and do wetin e want make you do. If we do all this things, we go get better sense wey go give us life.​—⁠Prov. 3:​21, 22.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share