Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 November pp. 4-8
  • ‘Continue to Dey Tell Each Other Better Word Everyday’

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • ‘Continue to Dey Tell Each Other Better Word Everyday’
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • EVERYBODY NEED WORD WEY GO MAKE DEM STRONG
  • BETTER EXAMPLE FOR BIBLE
  • BETTER WORD WEY DEY MAKE PEOPLE STRONG TODAY
  • HOW TO TALK WORD WEY GO MAKE PERSON STRONG
  • Make We Dey Encourage People Like Jehovah
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
  • Make We Dey Encourage Each Other, Especially Now
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 November pp. 4-8
The night before dem kill Jesus, one angel come make am strong

‘Continue to Dey Tell Each Other Better Word Everyday’

‘If una get any word wey go make the people strong, make una talk am.’​—ACTS 13:15.

SONG: 121, 45

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • Why e good to dey tell people word wey go make dem strong?

  • Wetin we fit learn from the way Jehovah, Jesus and apostle Paul take tell people word wey make dem strong?

  • How we go take talk word wey go make person strong?

1, 2. Why e good to dey tell people word wey go make dem happy?

CRISTINA wey dey 18 years talk sey: “E dey hard before my papa and mama go talk wetin go make me happy, na so so complain dem dey complain. And wetin dem dey talk dey pain well well.[1] Dem talk sey I be small pikin, I no go ever get sense and sey I too fat. Many times, na so so cry I dey cry and I no dey like to talk to dem at all. I feel sey I dey useless.” Life fit really tire person if nobody dey tell am better word wey go make am happy!

2 But, e good to dey tell people better word. Rubén talk sey: “For many years now, I dey feel sey I dey useless. But one day, I dey preaching with one elder wey see sey I no happy. E open im ear well as I dey tell am how I dey feel. E come help me remember the better things wey I dey do. E still help me remember wetin Jesus talk; sey one person better pass many bird wey dey fly. I dey remember the Bible verse where Jesus talk am every time, and e still dey touch me. Wetin the elder talk help me well well.”​—Matt. 10:31.

3. (a) Wetin apostle Paul talk about word wey dey make person strong? (b) Which question we go answer for this topic?

3 Bible let us know why we suppose dey tell people better word every time. Apostle Paul write to Christians wey be Hebrew sey: ‘Brothers, make una take time, so that any of una no go come get bad mind wey no get faith, wey go make una leave God; but make una continue to dey tell unaself better word every day, so that sin no go deceive any of una come make una stubborn.’ (Heb. 3:12, 13) You go know why e good to dey talk word wey dey make person strong, if you remember how that kind word don help you before. So make we answer this three question: Why e good to dey tell people word wey go make dem strong? Wetin we fit learn from the way Jehovah, Jesus and Paul take tell people word wey make dem strong? How we go take talk word wey go make person strong?

EVERYBODY NEED WORD WEY GO MAKE DEM STRONG

4. Who need better word, and why people no dey talk better word today?

4 All of us need word wey go make us strong especially as we dey grow. One teacher wey im name na Timothy Evans talk sey: “Small small pikin need word wey go make dem strong the way plant need water. If you tell small pikin better word, e go make am know sey you love am and e go sweet am well well.” But now, things don bad well well. People dey think of only theirself, dem no too get pity again, and e hard for people to talk wetin go make other people happy and strong. (2 Tim. 3:1-5) Some papa and mama no dey praise their pikin if dem do better thing because their own papa and mama no praise dem. Many people wey dey work dey complain sey e dey hard before people go praise dem for their work.

5. Wetin e mean to talk wetin go make person strong?

5 Many times, to talk wetin go make person strong na to praise am for the better thing wey e do. We fit still make person strong if we let am know sey e get better character or if we ‘talk word wey go make people wey life tire strong.’ (1 Thess. 5:14, ftn.) The Greek word wey dem translate as “to make person strong” mean “to call person come your side.” As we dey serve Jehovah with our brothers and sisters, we get the chance to talk better word wey go make dem happy and strong. (Read Ecclesiastes 4:​9, 10.) We dey use the correct time tell people why we love dem and wetin dem dey do? Before we answer this question, e good make we first think about this proverb for Bible, e sey: ‘Word wey person talk for the correct time, good well well!’​—Prov. 15:⁠23.

6. Why Satan want make us tire? Give example.

6 Satan want make us tire because e know sey that one fit make us stop to serve Jehovah. Proverbs 24:10 talk sey: ‘If you tire when wahala dey, you no go too get power.’ For example, Satan use wahala and lie to try make Job weak as e dey serve Jehovah, but im plan no work. (Job 2:3; 22:3; 27:⁠5) If we dey tell people for our family and our congregation wetin go make dem strong, we dey spoil Satan work. This one go make everybody for our house and for congregation happy and continue to serve Jehovah.

BETTER EXAMPLE FOR BIBLE

7, 8. (a) Which example for Bible show sey Jehovah want make we dey tell people wetin go make dem strong? (b) Wetin papa and mama go do to copy Jehovah example? (Go check the first picture.)

7 Jehovah. One of the people wey write psalms talk sey: ‘Jehovah near people wey their mind don scatter; e dey save people wey life don tire.’ (Ps. 34:18, ftn.) The time wey Jeremiah dey fear and when life tire am, Jehovah help am get strong mind. (Jer. 1:6-10) When Daniel don old, think about how e feel when God send one angel come give am power. The angel call am ‘special person’ or person wey dem respect well well. (Dan. 10:8, 11, 18, 19; ftn.) You go fit do the same thing for publishers, pioneers and old brothers and sisters for congregation wey no dey fit do as dem dey do before?

8 God and im special Son don work together for many years, but that one no make God talk sey no need to praise am or make im mind strong when e come this earth. Instead, na two times Jesus hear im Father voice from heaven when e talk sey: ‘Na my Son be this, wey I choose. I like am well well.’ (Matt. 3:17; 17:5) God let Jesus know sey e dey happy with am and sey e dey try well well. This word wey Jesus hear two times sweet am well well. The first time wey Jesus hear this word na before e start im preaching work and the second time na the year wey e die. When things hard for Jesus the night before dem kill am, Jehovah still send angel to make am strong. (Luke 22:43) Papa and mama, make una dey do like Jehovah. Dey tell your pikin better word wey go make dem strong and dey praise dem anytime dem do better thing. Make una dey help dem more more, if e get anything wey want make their faith weak for school.

9. Wetin we fit learn from the way Jesus treat im apostles?

9 Jesus. The night wey Jesus start the Memorial, one bad character wey e see for im apostle body be sey dem dey carry shoulder up. Even when Jesus carry imself down wash their leg, dem no stop to dey argue about who big pass. And Peter come dey make mouth. (Luke 22:24, 33, 34) Upon all this one, Jesus still praise im apostles sey dem no run leave am when e get problem. E talk sey the work wey dem go do, go pass im own. And e still let dem know sey God love dem well well. (Luke 22:28; John 14:12; 16:27) We fit ask ourself, ‘Like Jesus, I dey praise my pikin and other people if dem do better thing instead of to dey put mind for their mistake?’

10, 11. How apostle Paul take show sey to talk word wey dey make people strong na better thing?

10 Apostle Paul. Paul talk better things about Christians for the letter wey e write. As e be sey e don travel with some of dem for many years, e know their mistake, but e still talk better things about dem. For example, Paul sey Timothy na pikin wey e love and wey dey follow wetin the Lord talk, and na person wey dey help other Christian well well. (1 Cor. 4:17; Phil. 2:19, 20) E still talk better thing about Titus. E sey na im partner and person wey dey follow am work to help the brothers. (2 Cor. 8:23) We know sey Timothy and Titus go happy well well for the better word wey Paul talk about dem.

11 Paul and Barnabas put their life for danger when dem go back to where people want kill dem before. For example, even though sey Jew people wey dey Lystra give dem problem, dem still go back so that dem go fit help new disciple get strong faith. (Acts 14:19-22) For Ephesus, apostle Paul meet many people wey dey vex for am. Acts 20:1, 2 sey: ‘When the katakata don come down, Paul sey make dem call the disciple dem and after e don talk wetin make dem strong, and tell dem bye bye, e come start to dey go Macedonia. After e don waka for all this area and don talk many things wey go make the people wey dey there strong, e come enter Greece.’ Paul like to dey tell people better word wey dey make dem strong.

BETTER WORD WEY DEY MAKE PEOPLE STRONG TODAY

12. How our meeting take dey help us and other people to dey strong?

12 One reason why Jehovah arrange make we dey go meeting every time na because, we dey hear better word wey dey make us strong for there. (Read Hebrews 10:24, 25.) Like Jesus disciple that time, we dey gather together to learn so that we go dey strong. (1 Cor. 14:31) Cristina wey we talk about for paragraph one talk sey: “Wetin I like pass for our meeting na the love and the better word wey people dey talk for there to make me strong. Sometimes I no dey happy when I reach Kingdom Hall. But sisters dey come meet me, hold me join body and tell me sey I fine well well. Dem dey tell me sey dem love me and sey dem dey happy to see sey I dey try well well. The better word wey dem dey tell me dey make my mind come down!” E go good if all of us fit ‘make each other faith strong well well.’​—Rom. 1:11, 12.

13. Why people wey don dey serve God tey tey need word wey go make dem strong?

13 Even people wey don dey serve God tey tey still need word wey go make dem strong. For example, even though sey Joshua don dey serve God well for many years, Jehovah still tell Moses sey make e tell am better word wey go make am strong. God tell Moses sey: ‘Make Joshua oga, tell am wetin go help am and make am strong because, na im be the person wey go first cross come dey this people front, and na im go make dem get the land wey you go see.’ (Deut. 3:27, 28) Big work dey wait for Joshua because e go carry Israel people go war make dem fit collect the Promise Land. As dem dey go, e go get problem because e go lose like one fight. (Josh. 7:​1-9) Na im make Joshua need word wey go make am strong! So make we by ourself dey do wetin go make elders and even circuit overseer strong, as dem dey try well well to dey care for God sheep. (Read 1 Thessalonians 5:12, 13.) One circuit overseer talk sey: “Sometimes, brothers dey give us letter to thank us because dem enjoy our visit. We dey keep all the letter and we dey read dem if things hard for us. Dem dey really make us strong.”

Papa dey tell im pikin wetin go make am strong

Our pikin go do well if we dey tell dem better word (Check paragraph 14)

14. Wetin show sey to dey praise and tell person better word fit help am follow Bible advice?

14 Papa, mama and elders for congregation don see sey if dem praise and tell person better word, e go easy for the person to take Bible advice. When Paul praise the brothers and sisters for Corinth sey dem follow im advice, we dey sure sey that one help dem continue to dey do more. (2 Cor. 7:8-11) Andreas wey get two pikin talk sey: “Better word dey help small small pikin behave well and serve Jehovah as dem dey grow. If you want make person take your advice, use better word wey good for ear. Even though sey our pikin know the correct thing, if we dey tell dem better word every time, to dey do the correct thing go dey part of their life.”

HOW TO TALK WORD WEY GO MAKE PERSON STRONG

15. Wetin be one thing wey we fit do to make people strong?

15 Show sey you value your brothers and sisters. (2 Chron. 16:9; Job 1:⁠8) Even though sey wetin we take dey support God kingdom small because things hard, Jehovah and Jesus value am. (Read Luke 21:​1-4; 2 Corinthians 8:12.) For example, some of our old brothers and sisters dey try well well make dem fit dey go meeting and preaching every time. No be better thing to dey tell dem word wey go make dem strong and to praise dem?

16. If we get word wey go make people strong, why e no good to close mouth?

16 Use any chance wey you get to talk wetin go make people strong. If we see sey person do wetin we suppose praise am for, why we no go praise am? See wetin happen when Paul and Barnabas dey Antioch for Pisidia. The people wey dey lead for synagogue tell dem sey: ‘Men, brothers, if una get any word wey go make the people strong, make una talk am.’ This one make Paul give one sweet talk. (Acts 13:13-16, 42-44) If we get better word wey fit make people strong, make we no close our mouth! If we dey talk better word wey dey make people strong every time, we go see sey other people go dey tell us better word wey go make us strong.​—⁠Luke 6:⁠38.

17. Which way better pass to talk wetin go make person strong?

17 Talk about one thing and make e be true. E dey help well well to praise and tell people better word wey fit make dem strong. But wetin Jesus tell Christians for Thyatira show sey e go better to talk about one good thing wey dem do. (Read Revelation 2:18, 19.) For example, if we be papa or mama, we fit tell our pikin wetin we like about the way dem dey do for Jehovah work. We fit tell sister wey no get husband again wetin we like about how e take dey train im pikin even though sey things no easy for am. To dey praise people and dey tell dem better word wey go make dem strong fit help dem well well!

18, 19. Wetin we go do to help people wey need word wey go make dem strong?

18 Jehovah no go tell us by imself sey make we go tell person wetin go make am strong the way e tell Moses make e do for Joshua. But, God dey happy when we tell our brothers and sisters word wey go make dem strong. (Prov. 19:17; Heb. 12:12) For example, we fit tell the brother wey give talk about wetin we learn from im talk and how the talk take help us understand Bible verse wey hard us before. After one brother wey come from another congregation give talk finish, one sister write sey “na small time we talk, but you see wetin dey worry my mind and you make my mind come down. I want make you know sey that time wey you dey give the talk from platform and when I follow you talk, e touch me and I see sey na gift from Jehovah.”

19 Paul sey: ‘Continue to dey support each other and dey make each other strong, as una dey do now.’ If we put this advice for mind, we go use every chance wey we get to talk wetin go make people strong. (1 Thess. 5:11) And Jehovah go really happy with us, if we ‘continue to dey tell each other better word everyday.’

^ [1] (paragraph 1) No be im real name be that.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share