Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 February pp. 18-22
  • Na Jehovah Lead Israel People

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Na Jehovah Lead Israel People
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • GOD USE HOLY SPIRIT HELP DEM
  • ANGELS HELP DEM
  • NA BIBLE HELP DEM
  • JEHOVAH CHOOSE ONE SPECIAL LEADER
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 February pp. 18-22
Moses and Aaron go meet Pharaoh

Na Jehovah Lead Israel People

‘Jehovah no go stop to lead you.’​—ISA. 58:11.

SONG: 152, 22

YOU GO FIT EXPLAIN?

How Jesus and the people wey God use lead for olden days take show sey . . .

  • dem get holy spirit?

  • angels help dem?

  • Bible help dem?

1, 2. (a) How people wey dey direct Jehovah people take different from people wey dey direct for other religion? (b) Wetin we go talk about for this topic and the next one?

PEOPLE dey always ask Jehovah Witness this question: “Who be una leader?” E no surprise us because for many religion, dem get one man or woman wey be their leader. But we no be like that. We no dey shame to tell people sey our Leader no be human being. Instead, na Jesus Christ be our Leader. And Jesus dey follow Jehovah, wey be im Father and Leader.—Matt. 23:10.

2 But, e get one group wey God dey use direct im people today. Bible call this group ‘slave wey get sense and wey dem fit trust.’ (Matt. 24:45) So, how we take know sey na Jehovah dey use im Son wey dey heaven dey lead us? For this topic and the next one, we go talk about how Jehovah don use some people take lead im people. For the two topic, we go learn three things wey really show sey na Jehovah use this people lead. This one go help us see sey Jehovah never stop to lead im people today.—Isa. 58:11.

GOD USE HOLY SPIRIT HELP DEM

3. Wetin help Moses to fit lead Israel people?

3 God give people wey lead Israel holy spirit. Make we talk about Moses, the person wey God choose to lead Israel people. Wetin make am fit do this big work wey God give am? Jehovah put ‘Im holy spirit inside am.’ (Read Isaiah 63:​11-14.) So na Jehovah continue to lead Israel people, because na im give Moses holy spirit to fit do the work.

4. How Israel people take know sey Moses get holy spirit? (Go check the first picture.)

4 Since person no fit see holy spirit, how Israel people take know sey na holy spirit dey help Moses? Moses do miracle and e get mind tell Pharaoh about Jehovah. (Ex. 7:​1-3) Holy spirit still help Moses fit get better character​—⁠e get love, e gentle and e dey patient. This character help am fit lead Israel people. But, no be so the leaders for other land be, because dem wicked and dem dey think of only theirself. (Ex. 5:​2, 6-9) So e clear sey na Jehovah choose Moses to lead Im people.

5. How Jehovah take use holy spirit help other people wey later lead Israel?

5 Jehovah still give holy spirit to other people wey e later choose to lead Israel. ‘Joshua wey be Nun pikin get sense because God spirit full im body.’ (Deut. 34:9) ‘Jehovah spirit enter Gideon.’ (Judg. 6:34) And ‘Jehovah spirit come start to give David power.’ (1 Sam. 16:13) All this people put mind sey God go use im spirit help dem. The spirit come give dem power to fit do the kind things wey dem no fit use their own power do. (Josh. 11:​16, 17; Judg. 7:​7, 22; 1 Sam. 17:​37, 50) Na im make dem praise Jehovah because of the big things wey e help dem do.

6. Why God want make im people respect the leaders wey e choose?

6 Wetin Israel people for do to show sey dem support the people wey God give holy spirit? When dem complain about how Moses take dey lead dem, Jehovah come talk sey: ‘Which time this people go begin respect me?’ (Num. 14:​2, 11) True true, na Jehovah choose Moses, Joshua, Gideon, and David to lead im people. So anytime wey dem do wetin this people tell dem, dem dey show sey na Jehovah be their Leader.

ANGELS HELP DEM

7. How angels take help Moses?

7 Angels help the people wey God choose. (Read Hebrews 1:​7, 14.) Jehovah use angels tell Moses wetin E want make e do. Dem still give am wetin go make am fit do the work and dem guide am. ‘God use angel wey appear to am for the bush wey get chukuchuku, take send am to rule and save.’ (Acts 7:35) God ‘use angels’ take bring the Law wey Moses take teach Israel people. (Gal. 3:19) And Jehovah tell am sey: ‘Lead the people go the place wey I don tell you. See! My angel go dey your front.’ (Ex. 32:34) Bible no tell us sey Israel people see angel wey do this three things for Moses. But e clear for their eye sey na angel dey help Moses because of the way e take teach and guide dem.

8. How angels take help Joshua and Hezekiah?

8 After Moses die Jehovah use Joshua lead Israel people. Bible tell us sey God use one angel help Joshua to fit carry Israel people go fight and win Canaan people for war. (Josh. 5:​13-15; 6:​2, 21) When King Hezekiah dey rule, Assyria army want fight with people for Jerusalem and their army plenty well well. But ‘Jehovah angel kill 185,000 men’ wey dey Assyria army for one night.—2 Ki. 19:35.

9. Israel people suppose stop to respect the men wey God choose, because dem dey make mistake? Explain.

9 Na true sey angels no dey make mistake, but the people wey dem help dey make mistake. For example, e get one time wey Moses do wetin Jehovah no like. (Num. 20:12) Joshua no ask Jehovah wetin e go do, before e do agreement with Gibeon people. (Josh. 9:​14, 15) E get one time wey Hezekiah come dey carry shoulder up. (2 Chron. 32:​25, 26) Even with their mistake, Jehovah still use dem lead and e want make Israel people respect dem. Jehovah dey use angels help dem to show sey, true true, na im dey lead im people.

NA BIBLE HELP DEM

10. How God Law take help Moses?

10 Bible help the people wey God choose. Bible call the Law wey God give Israel people ‘Moses Law.’ (1 Ki. 2:⁠3) But Bible sey na Jehovah be the Person wey really give dem the Law. Even Moses go do wetin the Law talk. (2 Chron. 34:14) After Jehovah don talk how dem go build the tabernacle, ‘Moses do everything wey Jehovah tell am make e do. E do everything.’—Ex. 40:1-16.

11, 12. (a) Wetin God sey make Joshua and the kings wey rule for Israel do? (b) How God Law take help dem?

11 From when Joshua start to lead Israel people, e write God Law with im own hand. Jehovah tell am sey: ‘Make you dey read am day and night so that you go fit put eye for ground do everything wey dem write for inside.’ (Josh. 1:8) The kings wey rule for Israel after Joshua die, still do the same thing. Dem go need to read the Law everyday. Dem go write am with their own hand and ‘do everything wey this Law and commandment talk.’—Read Deuteronomy 17:18-20.

12 How God Law take help people wey God use lead for Israel? Think of King Josiah. Im secretary start to read Jehovah Law to am after dem see one book wey dem write the Law wey Jehovah give Moses.a Wetin Josiah do? ‘As the king just hear wetin dem write for inside the Law, e come tear im cloth.’ But e do pass that one. Because e want do wetin the Law talk, e come start to destroy all the juju wey dey Israel. E still arrange make dem do the kind Passover wey dem never do before. (2 Ki. 22:11; 23:​1-23) Josiah and other people wey God use lead Israel, follow God Law. Na im make dem ready to change how dem take dey lead God people. And this one make God people that time fit do wetin God want.

13. How people wey lead for Israel take different from people wey lead for other country?

13 The kings wey rule for Israel different from the ones wey rule for other country. How? Dem do wetin God Law talk, no be wetin dey their mind. For example, people wey rule for Canaan and their people do the kind things wey Jehovah hate. Dem dey sleep with their own family person, dey sleep with animal, man dey sleep with man, dem dey sacrifice their children and dem dey serve juju. (Lev. 18:​6, 21-25) Another thing be sey, people wey dey lead for Babylon and Egypt no follow the Law wey God give Israel people about how person go dey clean. (Num. 19:13) But Israel people see sey people wey dey lead dem no be like that. Dem make sure sey Israel people clean for their worship, character and body. True true, e clear sey na Jehovah dey lead Israel leaders.

14. Wetin make Jehovah correct some people wey e use lead?

14 No be all the king wey rule for Israel do wetin God want. Dem no gree make God spirit, im angel and im Law direct dem. Sometimes Jehovah correct dem or even comot dem as leader. (1 Sam. 13:​13, 14) When the time reach, Jehovah choose person wey better pass all the people wey e don use before.

JEHOVAH CHOOSE ONE SPECIAL LEADER

15. (a) How the prophet dem take talk about one special leader wey go come? (b) Who come be this leader?

15 For many years, Jehovah use im prophet dem talk about one special leader wey go lead im people. Moses tell Israel people sey: ‘Jehovah your God go make one of una brother to be prophet like me. Make una listen to am.’ (Deut. 18:15) Isaiah still talk sey this Person go be ‘leader and commander.’ (Isa. 55:4) Jehovah spirit make Daniel write sey ‘Messiah the Leader go come.’ (Dan. 9:25) At last, Jesus Christ use im mouth talk sey na im be the ‘Leader’ wey go lead God people. (Read Matthew 23:10.) Jesus disciples believe sey na Jehovah choose am and dem use their mind follow am. (John 6:​68, 69) Wetin make dem dey sure sey na Jesus Christ Jehovah dey use lead im people?

16. Wetin show sey holy spirit help Jesus?

16 Holy spirit help Jesus. When Jesus baptize, John the Baptizer see ‘sey heaven open and holy spirit come on top Jesus like dove.’ After, ‘the spirit come make am go inside wilderness.’ (Mark 1:​10-12) All the time wey Jesus take preach for this earth, God holy spirit help am. E help am fit do miracle and tell people wetin God send am. (Acts 10:38) Holy spirit still help Jesus get better character like love, joy, and strong faith. (John 15:9; Heb. 12:2) No leader be like Jesus. Na im make us believe true true sey na Jehovah choose Jesus.

Angels come help Jesus

How angels take help Jesus after e baptize? (Check paragraph 17)

17. How angels take help Jesus?

17 Angels help Jesus. Small time after Jesus baptize, ‘angels come begin dey help am.’ (Matt. 4:11) Before the time wey dem kill Jesus, ‘one angel from heaven come meet am, tell am wetin go make am strong.’ (Luke 22:43) Jesus dey sure sey Jehovah go send angels make dem help am anytime wey e need help to do wetin God want.—Matt. 26:53.

18, 19. How Bible take direct wetin Jesus do and teach?

18 Bible help Jesus. From the time wey Jesus start to preach, e let God Law direct am. (Matt. 4:4) E do wetin God want even though sey e go die. The things wey dem write for God Law about wetin go happen to Messiah, dey among the last things wey e talk before e die. (Matt. 27:46; Luke 23:46) But no be so the people wey dey teach the Law that time be. Dem ready to trowey wetin dey Bible if e no match wetin dem dey do. Na wetin make Jesus talk wetin prophet Isaiah talk about dem, when e sey: ‘Na mouth this people take dey respect me, but their mind no dey my side at all. Dem dey worship me for nothing, because dem dey teach wetin people talk.’ (Matt. 15:​7-9) You think sey Jehovah go really choose any of this people to lead im people?

19 Jesus let Bible direct am for wetin e do and wetin e teach. When some people come ask am question about wetin e dey teach, e no use im own sense or wetin e don see for life, answer dem. Instead, e use wetin dey God Law. (Matt. 22:​33-40) Another thing be sey, e no start to tell people story about im life for heaven or how e join God make things. But e ‘open their eye make dem fit understand wetin God Law talk.’ (Luke 24:​32, 45) Jesus like Bible, and e sweet am to tell people wetin dey inside.

20. (a) How Jesus take show sey na God be im Leader? (b) As Jehovah choose Jesus instead of Herod Agrippa I, wetin that one teach us?

20 Even though sey people wey Jesus teach happy to hear the better things wey dey come from im mouth, Jesus no let that one enter im head. Instead, e praise Jehovah, the Person wey teach am. (Luke 4:22) When one rich man call Jesus ‘Good Teacher,’ Jesus no carry shoulder up. Instead e tell the man sey: ‘Wetin make you sey I good? Na only God good, no other person.’ (Mark 10:​17, 18) See how Jesus take different from Herod Agrippa I, wey come be king for Judea! Na im dem make leader around eight years after Jesus die. For one special meeting, Herod come wear ‘king cloth.’ When the people wey gather hear am dey talk, dem come dey shout: ‘Na god dey talk, no be human being!’ Herod like wetin the people dey talk about am. Wetin come happen? ‘At once Jehovah angel hit am, because e collect the praise wey be God own, and worm come chop am and e die.’ (Acts 12:​21-23) True true, nobody wey dey judge matter well go talk sey na Jehovah choose Herod to be leader. But Jesus no be like that. E do wetin show sey na Jehovah choose am. E do everything to show sey na Jehovah be the main person wey dey lead im people.

21. Wetin we go talk about for the next topic?

21 Jesus no go lead for only small time. After Jehovah resurrect am, e talk sey: ‘Dem don give me all the power for heaven and for this earth. And see! I dey with una everytime go reach when the world go end.’ (Matt. 28:​18-20) But as Jesus dey heaven now, how e go take dey lead God people for earth? Who Jehovah go use direct Im people for our time? How we go take know sey na dem Jehovah dey use? We go talk about the answer for the next topic.

a This one fit be the book wey Moses write by imself.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share