BETTER STORY ABOUT US WEY DON HAPPEN
Dem Like Preaching Pass Before and Dem Ready to Preach More More
FOR September 1922, Jehovah people do one convention for where dem dey call Cedar Point, Ohio, wey dey U.S.A. For Friday morning, weather come dey hot small small as 8,000 people dey pack enter the hall. The chairman talk sey when that morning program don start, anybody wey want comot fit comot, but dem no go allow am enter the hall again.
Dem sing different different song for one part wey be “Praise Service.” After dem sing finish, Joseph F. Rutherford come go where person wey dey give talk dey stand. E dey hungry many people to hear wetin e want talk. Some of dem just dey waka for the hall because of the heat. Brother Rutherford come tell dem make dem sitdown listen. For where the platform dey, dem sofri fold one big cloth hang for up. As the talk start, you think sey anybody see the cloth?
The topic for Brother Rutherford talk na “The kingdom of heaven is at hand.” E talk for about one hour thirty minute, and na so dem dey hear im loud voice for everywhere for the hall. E talk how the prophet dem for Bible no fear to tell people about God Kingdom. As im talk want finish, e come ask sey, ‘Una believe sey the King wey get level don start to rule?’ Na im everybody come shout sey: “Yes!”
Brother Rutherford come halla sey: ‘Then make una go preach, una wey be children of the God wey high pass!’ E come sey: ‘See, the King don dey rule! And na una work to talk about am. So, make una advertise, advertise, advertise.’
As e talk that one finish, dem come lose the big cloth open. Wetin dem write for the cloth na: “Advertise the King and Kingdom.”
Brother Ray Bopp remember wetin happen. E sey: ‘The brothers and sisters spirit come high.’ Sister Anna Gardner come talk how the people clap take shake the building. Another brother wey im name na Fred Twarosh talk sey: ‘Everybody come stand up together.’ Brother Evangelos Scouffas talk sey: ‘E just be like sey one strong power carry us get up, and we come dey cry as we stand.’
Many people wey come the convention don already dey preach the good news about God Kingdom. But now, dem come see sey dem need to preach more more. Sister Ethel Bennecoff talk sey the brothers and sisters come like preaching pass before, and dem ready to use all their mind and power take preach more more. After the convention, Sister Odessa Tuck wey dey 18 years that time, come ready to do like prophet Isaiah wey hear as Jehovah ask sey, ‘Who go go?’ The sister talk sey: ‘I no know where I dey go, how I go take go or wetin I want go preach. The only thing wey I know be sey I want be like Isaiah wey answer sey “I dey here! Send me!”’ (Isa. 6:8) Brother Ralph Leffler talk sey that day no be day wey person dey forget. E sey: ‘Na that time Jehovah people start the real preaching work wey don reach everywhere today.’
No wonder Jehovah people dey always remember that convention; dem never do that kind convention before! Brother George Gangas talk sey, ‘That convention come make me no want miss any other convention.’ And really, e sey e no fit remember anyone wey e miss. One sister wey im name na Julia Wilcox write sey: ‘I no fit talk how body dey sweet me reach anytime wey our book dem talk about the convention for Cedar Point for 1922. I dey always thank Jehovah sey e let me dey there.’
E fit be sey, like this brothers and sisters, many of us today no go ever forget the convention wey sweet us well well. Na so e dey be, especially if the convention make us come love Jehovah and Jesus more more and make us want use all our power work for dem. As we dey remember am, we self go still talk sey, “Thank you, Jehovah, because you let me dey there.”