You Know?
E good as Jesus call people wey dey sell for Jerusalem temple that time ‘thief’?
FOR book of Matthew, Bible talk sey: ‘Jesus enter the temple and e drive all the people wey dey sell and buy things comot from the temple. E trowey the table of people wey dey change money and the bench of people wey dey sell bird wey dem dey call dove. E come tell dem sey: “Dem write am sey, ‘Na prayer house dem go call my house,’ but una don turn am to where thief dey stay.”’—Matt. 21:12, 13.
Wetin dem write about Jew people show sey, people wey dey sell for temple really cheat their customer. Their price na times two or three of wetin dem suppose sell. For example, one book wey write about the matter talk sey, for the apostle dem time, before person go fit buy two small bird wey dem dey call pigeon, e go work for 25 days. Na pigeon or dove poor people fit use do sacrifice. But because e too cost, dem no come fit buy am again. (Lev. 1:14; 5:7; 12:6-8) This thing vex one man wey im name na Rabbi Simeon ben Gamaliel no be small, sotey e come reduce all the sacrifice wey dem first dey do. Na that one come make the price of two pigeon come down well well. And na only three hours person go work to fit buy am.
From wetin we don see, e make sense sey Jesus call this people wey dey sell for temple ‘thief’ because of their longthroat and how dem take cheat people.