Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 16 p. 42-p. 43 par. 8
  • Jesus Show Im Love for True Worship

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Show Im Love for True Worship
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Jesus Drive People Wey Dey Do Business for Temple
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Jesus Second Miracle for Cana
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Jesus Do Im First Miracle
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Jesus Preach Reach Many Place for Galilee
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 16 p. 42-p. 43 par. 8
Jesus dey pursue people wey dey change money comot from temple

CHAPTER 16

Jesus Show Im Love for True Worship

JOHN 2:12-22

  • JESUS PURSUE PEOPLE WEY DEY SELL FOR TEMPLE COMOT

After the wedding for Cana, Jesus go Capernaum. Im mama and im brothers; James, Joseph, Simon, and Judas go with am.

But why Jesus go Capernaum? Na because of the kind city wey Capernaum be. Because of where Capernaum dey, e dey easy for people to reach am, and e big pass Nazareth or Cana. No be only that one. Many of this people wey Jesus newly choose as im disciple come from Capernaum or dey live near there. So, e go dey easy for Jesus to train dem for their area.

For Capernaum, Jesus do miracle. So plenty people for the area and other city wey near Capernaum hear wetin Jesus do for there. Jesus disciples na Jew people wey dey use all their mind serve God. So, for this year wey be 30 C.E., dem go soon go Jerusalem for the Passover.

As dem dey inside the temple for Jerusalem, wetin dem see about Jesus surprise dem. Dem never see Jesus like this before.

For the law wey Jehovah give Israel people, e sey make dem dey do sacrifice for temple. And people wey come the temple go need food. And for the law, the people fit carry money come so that dem fit use am buy things like cattle, sheep, goat and other things wey dem go need for Jerusalem. (Deuteronomy 14:24-26) This one make some people come dey sell animals or birds for one big area for inside the temple. And some of dem dey cheat the people wey come buy things because the price wey dem dey sell the things too much.

As Jesus see am, e vex. E trowey the coins of people wey dey change money, e trowey their table and pursue the men comot. Jesus tell dem sey: “Make una carry all this things comot from here! No turn my Father house to market!”—John 2:16.

As dem see this thing wey Jesus do, dem remember the things wey dem talk about God Son, sey: “The love wey I get for your house go burn inside me like fire.” The Jew people come ask Jesus sey: “Which sign you fit show us, to show sey all this things wey you dey do na true?” Jesus tell dem sey: “Make una destroy this temple reach ground, and I go use three days build am back.”—John 2:17-19; Psalm 69:9.

Jew people think sey na the temple wey dem dey see Jesus dey talk about, na im dem ask am sey: “Na temple wey dem use 46 years build, you want use three days build?” (John 2:20) But the temple wey Jesus dey talk about na im body. Three years later when God bring Jesus come back to life, im disciples remember this thing wey Jesus talk.

  • After the wedding for Cana, where Jesus go?

  • Why Jesus vex for wetin e see for temple, and wetin e do?

  • When Jesus sey “this temple,” wetin dey im mind, and wetin e mean?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share