Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 July pp. 7-11
  • Jehovah Blessing Better Pass Money

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jehovah Blessing Better Pass Money
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • THE STORY ABOUT THE CARETAKER
  • USE THIS WORLD PROPERTY WITH SENSE
  • NO TOO PUT BODY FOR BUSINESS
  • WHEN THE PROPERTY NO DEY AGAIN
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 July pp. 7-11
Different different way wey dem take dey use the money wey we contribute to support our work

Jehovah Blessing Better Pass Money

‘Use this world property take make friend.’​—LUKE 16:9.

SONG: 32, 154

YOU GO FIT EXPLAIN?

  • How we fit show sey we dey use our money and property well?

  • Wetin we go do so that business for this world no go control us?

  • Why you don make up your mind to pursue Jehovah blessing instead of money?

1, 2. Before God Kingdom come, why poor people go always dey this world?

LIFE no easy at all for this world. Many people dey suffer, but some dey enjoy. For example, young people dey find work, but dem no see. Many people ready to do anything to fit travel go country wey money dey. Even for this country wey dem dey go, many poor people still dey there. Rich man dey get money more more, and poor man dey poor more more. Some people don see sey, for the whole world, money wey only one person get, plenty reach 99 people own! Whether this number correct, we no know. But the truth be sey, many people poor well well. And some people over get money, sotey e go reach to take care of their great great grand pikin wey dem never born. No wonder Jesus talk sey: ‘Poor people go always dey with una.’ (Mark 14:7) Why Jesus talk sey poor people go always dey?

2 This world wey Satan dey control, get three part. Dem be: politics, religion, and business. Na this business part Revelation 18:3 dey talk, when e talk about ‘business men.’ Jesus know sey na only God Kingdom fit comot poverty. Jehovah people no dey put hand for politics and fake religion. But e fit hard many of dem to comot hand finish from business.

3. Which question we go answer for this topic?

3 Because we be Christian, e good make we check wetin dey our mind about how people dey do business today. We fit ask ourself this kind question: ‘How I fit use my money and property take serve God? Wetin go help me make I no too put body for this world business, whether na to buy or sell? Which example show sey God servant really trust am, even when things hard?’

THE STORY ABOUT THE CARETAKER

4, 5. (a) Wetin happen to the caretaker wey Jesus talk about? (b) Which advice Jesus give im disciples?

4 Read Luke 16:1-9. This story wey Jesus talk suppose make us think well well. Na about one caretaker wey do wetin no good. Dem report this caretaker sey e no dey take care of im oga property well. Wetin e come do as im oga want collect the work from im hand? Bible sey e ‘use im sense’ plan wetin e go do. E ‘make friend’ with people wey go help am when dem comot am for work.a Jesus no talk this story so that im disciples go begin play wayo or do wetin no good to survive. E even talk sey na ‘people for this world’ get that kind character. So, e tell dem the story because e want make dem learn better thing from am. Wetin be this better thing?

5 Things no go easy for the caretaker when dem comot am from work. Jesus know sey na so e go still be for many of im disciples. For this world wey mago-mago full, e go hard many of dem to see work wey dem go take feed theirself and their family. E come advise dem sey: ‘Use this world property take make friend.’ E talk am because, one day the property no go dey again. So when e happen, Jehovah and Jesus wey be our friend, ‘go fit let us enter place wey go last.’ Wetin we fit learn from this advice?

6. How we take know sey for us to do business and make money no be wetin dey Jehovah mind from beginning?

6 When Jesus sey ‘this world property,’ e no tell us why e talk like that. But Bible let us know sey when Jehovah make human being, e no get am for mind make dem dey do business to make money. For example, when Adam and Eve dey garden of Eden, Jehovah give dem pass wetin dem need. Dem no pay money. (Gen. 2:15, 16) Later for apostle time, when God give im people holy spirit, ‘nobody feel sey the property wey e get, na im own. But dem share their property together.’ (Acts 4:32) Our earth dey produce many better things. Prophet Isaiah talk sey time dey come when everybody go enjoy am together. Nobody go pay money. (Isa. 25:6-9; 65:21, 22) But before that time, we go need to ‘use our sense’ work so that we go survive. Even if we dey use ‘this world property,’ make we still dey do wetin go make God happy.

USE THIS WORLD PROPERTY WITH SENSE

7. Wetin Jesus talk for Luke 16:10-13?

7 Read Luke 16:10-13. Because of wetin e go gain, the caretaker for Jesus story make friend with people. But Jesus no want make im disciples make friend with im and im Father because of wetin dem go gain. Wetin dey Luke 16:10-13 show sey we fit use ‘this world property’ take serve Jehovah. So, to show sey ‘dem fit trust us,’ we go use our money and property well. How we go take do am?

8, 9. How some people take dey use their money and property?

8 E good make we dey contribute to support the preaching work wey Jesus talk about. E go show sey we dey use our money and property well. (Matt. 24:14) One young girl for India get box wey e dey save money put. E even add the money wey im want take buy toy put for the box. When the box don full, e come use all the money support preaching work. One brother for India get coconut farm. E come carry plenty coconut go give the brothers wey dey Malayalam remote translation office. The brother see sey dem need coconut. So e feel sey dem go value the coconut pass the money wey e for contribute. The young girl and the brother ‘use their sense.’ Na so brothers for Greece still dey do. Dem dey contribute olive oil, cheese, and other food for Bethel family.

9 E get one brother wey come from Sri Lanka. E get land and house for there, but e dey stay another country. E give brothers im property make dem dey use am do meeting and assembly. E still give people wey dey full-time service place to stay. The brother no dey collect money, but wetin e do really help the brothers wey no too get money. For place wey dem no dey let us preach, brothers dey use their house take do Kingdom Hall. This one dey help many pioneers and other brothers wey no too get money. Dem dey see free place to do meeting.

10. How we take dey gain, if we get open hand?

10 All this example don show sey dem fit trust God people ‘for small thing.’ Dem dey use their money and property well. (Luke 16:10) Because dem use wetin dem get take help other people, dem be Jehovah friend. How this one dey make dem feel? E dey make dem happy. Dem know sey Jehovah blessing better pass money or property. (Luke 16:11) One sister wey dey always contribute to support Jehovah work talk about the better thing wey dey happen to am for some years now. E talk sey: “I don see sey the more I dey give, the more I come dey treat other people well. I dey fit forgive people more, and I dey patient with dem pass before. E don easy for me to dey bear things wey people do me, and to dey take people advice.” Many people don see sey if dem get open hand, Jehovah dey bless dem.​—Ps. 112:5; Prov. 22:9.

11. (a) If we dey support other people with wetin we get, how e take show sey we dey ‘use our sense’? (b) Wetin dey happen among us today? (Go check the first picture.)

11 Make we still dey help people wey dey full-time service. This one go show sey we dey ‘use our sense.’ E fit be sey we no dey full-time service, and we no fit go preach for where Jehovah Witness no too many. But belle still sweet us sey, wetin we contribute dey help people wey dey do am. (Prov. 19:17) E get some country wey money no too dey. But many people for there dey enter Jehovah organization. Na wetin we contribute dey help us fit carry our book dem go this kind place. We still dey use am support our preaching work for there. For place like Congo, Madagascar, and Rwanda, Bible cost well well. Sometimes, e cost reach their salary for one week or one month. For many years, brothers dey choose if na Bible dem want buy, or food wey their family go chop. But, because of the money wey other brothers dey contribute, everything dey ‘balance.’ Jehovah organization don use wetin we contribute well. Dem don translate and carry Bible go meet different different family and Bible student for there. (Read 2 Corinthians 8:13-15.) So, whether na people wey contribute or people wey dem use the contribution help, all of dem fit be Jehovah friend.

NO TOO PUT BODY FOR BUSINESS

12. How Abraham take show sey e trust Jehovah?

12 We fit still do another thing to be Jehovah friend. Make we no too put body for business, whether na to buy or sell things. Instead, make we use our time do ‘better thing’ wey go make Jehovah bless us. Na wetin Abraham do be that. Bible talk sey Abraham get faith. Jehovah tell am make e comot from one city wey dem dey call Ur. Even though money dey the place, Abraham do wetin Jehovah talk because e want be Im friend. E come dey stay for tent (house wey dem do with cloth or animal skin). (Heb. 11:8-10) E no put mind for money or property. Instead, e trust Jehovah. (Gen. 14:22, 23) Na this kind example Jesus sey make we copy. Na im make e tell one man wey get money, sey: ‘If you want make wetin you dey do complete, go sell your property. Give poor people the money. You go come get better thing for heaven. Then, make you come be my disciple.’ (Matt. 19:21) That man no get faith like Abraham. But, e get other people wey don show sey dem get faith.

13. (a) Which advice Paul give Timothy? (b) How we go take follow Paul advice?

13 Timothy na person wey get faith. Paul call am ‘Jesus better soldier.’ E come still tell am sey: ‘Nobody wey be soldier dey put hand for other business for life to get money, so that the person wey choose am as soldier go happy with am.’ (2 Tim. 2:3, 4) Among people wey dey follow Jesus today, e pass one million people wey dey full-time service. All of dem dey do wetin dem fit do to follow Paul advice. Dem no dey let advert or people make dem buy wetin dem no need. Dem dey remember wetin Bible talk, when e sey: ‘Person wey dey owe, na slave to who e dey owe.’ (Prov. 22:7) Devil want make we put all our body for business. E want make we use all our time dey find money. Some things wey we want do fit make credit full our neck. For example, some people dey borrow big money to build house, train person for school, buy motor, or even do big wedding. Even after many years, dem fit never pay the money finish. But e good make we live simple life. Make we no too dey owe or spend money. If we do like that, we go fit put body for God work instead of business. This one go show sey we dey use our sense.​—1 Tim. 6:10.

14. Wetin e good make we ready to do? Give example.

14 Person wey want live simple life go put God Kingdom first for im life. E get one husband and wife wey get one big business. Dem dey see money for the business, no be small. But e dey their mind to enter full-time service again. This one come make dem sell their business, their boat, and other property. When we dey build our headquarters for Warwick, the brother and im wife go join do the work for there. Their belle really sweet dem sey dem work for Bethel. Their daughter and im husband still join dem. Even the brother papa and mama follow do the work for some weeks. One sister wey be pioneer for Colorado, wey dey U.S.A., dey use some days work for bank. Dem come like the way the sister dey work sotey dem want make e work everyday wey dem dey work. Dem tell am sey im salary go be times three. But e no gree take the work, even if dem go pay am better money. E do like that because the work no go let am put mind for Jehovah work. This one na just some example of people wey don leave many things to do Jehovah work. Other example still dey. If we do like dem, e go show sey we ready to put God Kingdom first. E go still show sey we like to be Jehovah friend, and we value im blessing pass money or property.

WHEN THE PROPERTY NO DEY AGAIN

15. Wetin dey make person happy pass?

15 No be money dem take dey know person wey God bless. But, na when we dey do the many ‘better work’ wey Bible talk about, God go bless us. (Read 1 Timothy 6:17-19.) For example, e get one sister wey im name na Lucia.b E hear sey dem need people wey go preach for Albania. For 1993, e come travel from Italy go there. The sister no get work, but e know sey Jehovah go take care of am. E come sabi Albania language well well. And e don use am help pass 60 people come serve Jehovah. All of us fit never help people reach like that. But we fit don do something wey help people come know Jehovah and continue to serve am. Anything wey we do for dem na better thing. We and dem no go ever forget am.​—Matt. 6:20.

16. (a) Wetin go happen to the business wey dem dey do for this world? (b) Wetin this one go make us do?

16 Wetin Jesus talk na ‘when this world property no dey again,’ no be ‘if this world property no dey again.’ This one mean sey dem no go last forever. (Luke 16:9) For this last days, some bank don stop work and some country no get money like before. But the one wey go soon happen, go strong pass wetin dey happen now. Everything wey Satan dey control​—politics, fake religion, and business​—no go dey again. For many years now, people don dey use gold and silver do business. But prophet Ezekiel and Zephaniah talk sey this things go useless. (Ezek. 7:19; Zeph. 1:18) Instead of things wey get value for God eye, many people dey gather money and property reach old age. How we go feel if na we be this people? We fit come be like person wey don use all im life gather money, only to see sey na fake money. (Prov. 18:11) The truth be sey, this world property go end one day. So, make we use dem now ‘take make friend’ for heaven. If we do anything to support Jehovah work, e go bless us.

17, 18. Which better things God friend go enjoy for front?

17 When God Kingdom come, nobody go pay rent or borrow money again. Food go plenty, and we no go need to buy am. Doctor and medicine no go dey. People wey be God friend go enjoy the better things wey this earth go produce. People no go dey use things like, gold and silver do business. Instead, we go use dem dey do fine fine things. Na better wood, stone, and other things wey dem take dey build house we go dey use. We no go buy dem, and na fine fine house we go use dem build. Our friends go use their mind help us work. We no go pay dem. Everything wey our earth produce, we go share am together.

18 This one na just some things wey Jehovah and Jesus friend go enjoy. Everybody wey dey serve Jehovah for this earth, go happy well well when Jesus go tell dem sey: ‘Make una come, una wey my Father don bless. Make una take the Kingdom wey God don arrange for una since the world start.’​—Matt. 25:34.

a Jesus no tell us whether wetin dem talk about the caretaker na true or lie. E fit be sey na lie dem lie for the caretaker head. We know this one because of the Greek word wey dem use for Luke 16:1. But Jesus want make we put mind for wetin the caretaker do, no be wetin make dem want pursue am.

b Lucia Moussanett story dey for June 22, 2003, Awake!, pp. 18-22.

HOW TO USE INTERNET CONTRIBUTE MONEY

Our jw.org website

Na money wey people dey donate na im we take dey support the work wey we dey do to help people for the whole world. To use internet contribute, go jw.org. Make you press “Contribute to Support the Work Wey We Dey Do for the Whole World” wey dey down of any page for our website.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share