Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 October pp. 7-11
  • Dey Show Real Love

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Dey Show Real Love
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • REAL LOVE DIFFERENT FROM FAKE LOVE
  • HOW TO SHOW REAL LOVE ‘FOR WETIN WE DEY DO’
  • Love—Na Better Character
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • No Stop to Get Love
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 October pp. 7-11
Jehovah Witness people dey work together for Kingdom Hall

Dey Show Real Love

‘Make we love, no be for mouth, but make e show for wetin we dey do and make e dey real.’​—1 JOHN 3:18.

SONG: 72, 124

YOU REMEMBER THE ANSWER?

  • Which love better pass?

  • When Bible sey make the ‘love wey we get no be for mouth,’ wetin e mean?

  • Wetin go make us know sey we get real love?

1. Which love better pass, and wetin make am better pass? (Check the first picture.)

E GET love wey dey make person do wetin Bible talk. The name of this love na a·gaʹpe. This love na gift from Jehovah. (1 John 4:7) E no get any other love wey better pass am. This love dey make people near each other well well. E dey make person think of wetin e fit do wey go favor the other person. E still dey make person do good things for other people. This kind love dey make our life get head. And e dey make us happy.

2, 3. How Jehovah don take show sey e really love us?

2 Jehovah show sey e love us even before e make Adam and Eve. E put different things wey go make us enjoy life finish. Jehovah do all this things because e really love us. E no do am because of wetin e go gain. And e still want make we get life wey no go end for Paradise. This one show sey the love wey Jehovah get for us get weight.

3 Adam and Eve later do wetin Jehovah no like. But Jehovah know sey some of their children go love am. Na this one make am send im Son to come die for us. Love wey big pass this one no dey. (Gen. 3:15; 1 John 4:10) From the time when Jehovah first talk sey Person go come save us, e know sey wetin e talk must happen. So, to am e just be like sey e don happen already. Jesus come die for our sin about 4,000 years after Jehovah don talk am. E pain Jehovah well well when e Son die. (John 3:16) We happy well well sey Jehovah get this kind love for us!

4. Wetin make us know sey we go fit show real love?

4 We go fit show real love even as we get sin for body? Yes we go fit because Jehovah make us to fit dey copy im character. Na true sey e no easy but we go fit do am. For example, Abel give Jehovah the better thing wey e get. This one show sey e really love Jehovah. (Gen. 4:3, 4) Noah get real love for people. Na this one make am no tire to dey preach even when the people no want hear. (2 Pet. 2:5) Abraham ready to sacrifice im pikin for Jehovah. Why? Na because e love Jehovah pass any other thing. (Jas. 2:21) Make we dey show love like this people even if e no easy.

REAL LOVE DIFFERENT FROM FAKE LOVE

5. How we go take show sey we get real love?

5 Bible show sey real love ‘no be for mouth.’ E dey ‘show for wetin we dey do.’ (1 John 3:18) This one no mean sey we no fit tell person sey we love am. (1 Thess. 4:18) But make we no dey talk sey we love people only for mouth when we know sey we suppose do something. For example, wetin you go do if you see sey brother or sister no get food to chop or cloth to wear? Make we no just tell dem sey “e go better!” No be “e go better” the person go chop. Make we do something. (Jas. 2:15, 16) How we go take show Jehovah and other people sey we love dem? Make we no only dey beg Jehovah to bring more people wey go preach. But make we dey put body for the preaching work.​—Matt. 9:38.

6, 7. (a) How person fit show sey im love ‘no be for mouth’? (b) Wetin be some example of fake love?

6 Apostle John talk sey make our love dey ‘show for wetin we dey do and make e dey real.’ This one go show sey our love ‘no be for mouth.’ (Rom. 12:9; 2 Cor. 6:6) Person fit dey pretend sey e get love. But that one no be real love. The person fit get another thing for mind. Person wey get real love no dey pretend or carry something for mind. Wetin person dey use fake love do? Na love be that?

7 Make we talk about some example of fake love. For garden of Eden, Satan do like sey e get better thing for mind for Eve. But na pretend e dey pretend. Na bad thing e get for mind. (Gen. 3:4, 5) Bible talk about Ahithophel wey be King David friend. But later, Ahithophel take pepper rub David eye because of wetin e want gain. No be better love e get for David. (2 Sam. 15:31) Today, some people dey lie about Jehovah organization. So that people go think sey dem be better person, dem ‘dey use sweet mouth and wayo talk.’ But, the truth be sey dem get plan.​—Rom. 16:17, 18.

8. Which question we go ask ourself?

8 Fake love no be character wey we suppose get at all. Na so because that kind love dey deceive people. We fit deceive human being, but we no fit deceive Jehovah. Jesus talk sey dem go punish this kind people well well. (Matt. 24:51) E no good make we get that kind character because we dey serve Jehovah. But e good make we ask ourself, ‘My love dey real? I dey love people because of wetin I want gain from dem? Na pretend I dey pretend?’ Make we talk about nine things wey we fit do to show sey our love ‘no be for mouth.’

HOW TO SHOW REAL LOVE ‘FOR WETIN WE DEY DO’

9. Wetin real love go make us do?

9 Make your work dey sweet you even if people no dey see you. Make we ready to do good things for our brothers even if nobody see us. E go show sey we love dem. (Read Matthew 6:1-4.) Ananias and Sapphira fail for that one. Because dem want show theirself, dem lie about wetin dem contribute. Jehovah come punish dem for wetin dem do. (Acts 5:1-10) If we really love our brothers, we no need to “broadcast” wetin we do for dem. Even with that one, e go still sweet us sey we do am for dem. For example, e get some brothers wey dey help Governing Body dey arrange wetin we dey learn from Bible. This brothers no dey do “notice me.” Even if dem follow write any of our book, dem no dey tell people.

10. Wetin go help us no think sey we better pass other people?

10 No dey do like sey you better pass other people. (Read Romans 12:10.) Jesus show sey e dey carry body down when e wash im disciples leg. (John 13:3-5, 12-15) If we want be like Jesus, make we do everything to make sure sey we no carry body up. This one go make us no think sey we better pass other people. E hard Jesus disciples to follow im example because dem no understand everything wey e do. Na after e give dem holy spirit, dem come understand well. (John 13:7) Sometimes, person fit dey think sey e better pass other people because e go school, e get money, or who e be for Jehovah organization. But make we no get that kind character. (Rom. 12:3) If dem dey praise person for wetin e do, make we no jealous am. But make we happy for the person even if we think sey dem suppose praise us like am.

11. Why e good make we dey praise people from our mind?

11 Use your mind praise people. Make we dey always look for way to praise our brothers and sisters. Wetin we tell dem ‘go fit help dem stand well’ for Jehovah side. (Eph. 4:29) But e good make we dey praise dem from our mind. If e no come from our mind, we fit just dey tell dem only wetin go make their head big. And we fit no correct dem even when we suppose correct dem. (Prov. 29:5) E no good make we dey praise person and dey talk bad about am for back. That one no be real love. Apostle Paul no be like that. E show sey na real love e get for people. For example, e praise the brothers for Corinth for some of the better character wey dem get. (1 Cor. 11:2) But when dem no do well, e sofri correct dem. E no hide anything from dem.​—1 Cor. 11:20-22.

One sister put money inside envelope and e drop am for another sister wey need money

If we dey give things to our brothers, e go show sey we really love dem (Check paragraph 12)

12. How we go take show sey we get real love when we dey help people?

12 Do good things for people. Jehovah want make we dey do good things for our brothers and sisters. E no want make we dey tight hand. (Read 1 John 3:17.) But e no good make we do am because of wetin we go gain. Make we ask ourself sey: ‘Who I dey do good things for? Na only my tight friend, people wey I dey take better eye look for congregation, or people wey fit pay me back? What of other brothers and sisters wey I no too know, or wey no fit pay me back? I still dey help dem?’ (Luke 14:12-14) Sometimes, our brothers and sisters fit need something because wetin dem put mind no work. E fit even happen sey dem no thank us for wetin we do for dem. If e happen like this, wetin e good make we do? Bible tell us sey: ‘Dey do good to unaself and no complain.’ (1 Pet. 4:9) If you follow wetin this Bible verse talk, you go happy as you no carry something for mind do good.​—Acts 20:35.

13. (a) When we need to dey patient? (b) Wetin we fit do to help people wey no too strong?

13 Help people wey no too strong. Bible talk sey make we ‘support weak people and dey patient with everybody.’ This one go show whether we really love our brothers and sisters. (1 Thess. 5:14) Many people wey their faith no too strong dey later stand well for Jehovah side. But some never still stand well. Make we dey patient with dem and still dey help dem. We fit show dem any Bible verse wey go help dem. We fit tell dem to join us for preaching. And make we listen well when dem dey talk to us. Make we no just dey look our brothers and sisters sey some ‘strong’ and some ‘weak.’ Instead, we go remember sey all of us get where we dey try and where we no dey try. Even apostle Paul talk sey e get where e no dey try. (2 Cor. 12:9, 10) So, make all of us dey help each other.

14. Wetin we fit do to make sure sey peace dey?

14 Make peace dey where you dey. We go do everything wey we fit do to make sure sey we no get problem with our brothers. We go try, even when we feel sey people no understand us, or dem no treat us well. (Read Romans 12:17, 18.) When we make person vex, if na to tell am sorry go settle the matter, make we tell am sorry. But make e come from your mind. For example, no talk sey, “Abeg, no vex o! I no know sey you go take the matter like that!” But talk wetin go show sey you still get hand for wetin make am vex. So you fit sey, “Abeg, no let wetin I talk vex you.” Husband and wife need to do wetin go make peace dey their marriage. Make dem no dey do like sey dem love each other for where people dey. But when only dem dey, dem dey fight, dey quarrel, and dem no dey talk to each other.

15. Wetin go show sey e come from our mind to forgive our brothers?

15 Forgive people from your mind. If we sey we don forgive person, we no go carry wetin e do us for mind. Person fit no know sey e do wetin make us vex. But make we still forgive am from our mind. Bible talk sey make we ‘dey take love bear wetin people do us.’ This one go make us get one mind and peace go dey. (Eph. 4:2, 3) If we want really forgive person, we no go dey ‘count how many times e do us bad.’ So, e good make we no dey think about wetin person do us. (1 Cor. 13:4, 5) If we dey carry wetin our brothers do us for mind, e go scatter we and dem as friend. And even Jehovah self fit no be our friend again. (Matt. 6:14, 15) Make we still try dey pray for people wey make us vex. This one go show sey we forgive dem from our mind.​—Luke 6:27, 28.

16. Which kind eye we go take look the work wey dem give us?

16 No put eye for only wetin go favor you. Some of us get special work wey we dey do for Jehovah organization. Make we no dey use am ‘find wetin go favor only ourself, but make we dey find wetin go favor another person.’ This one go show sey we get real love. (1 Cor. 10:24) For example, e get brothers wey dey give people seat for assembly or convention. Na true sey na dem dey first reach there. Dem fit want use the chance keep better chair for theirself and family people. But many of dem ready to sitdown for any chair even if e no fine. This one show sey dem no dey put eye for wetin go favor only dem. Make we dey do like dem.

17. Wetin person wey get real love suppose do when e do wetin bad well well for Jehovah eye?

17 No hide bad thing and comot hand. Some people dey try to cover the bad thing wey dem don do because of shame. Another reason be sey dem no want be disgrace to other people. (Prov. 28:13) The bad thing wey person do fit cause trouble for am and other people. How? E fit make Jehovah stop to dey use im spirit direct the congregation. And if Jehovah spirit no dey congregation, peace no go dey. So when person do wetin bad well well for Jehovah eye, e no good make e hide am. If the person no hide am e go show sey e get real love. (Eph. 4:30) E go sofri go meet elders and tell dem the bad thing wey e don do. And this elders ready to help am.​—Jas. 5:14, 15.

18. Why e good make we dey show real love?

18 E no get any other better character wey big pass love. (1 Cor. 13:13) Na love dey make people know sey we really dey follow Jesus. E go still show sey we dey do like Jehovah the God wey love come from. (Eph. 5:1, 2) Paul talk sey: ‘If I no get love, I no be anything.’ (1 Cor. 13:2) So make all of us continue to show love ‘no be for mouth, but make e show for wetin we dey do and make e dey real.’

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share