WHEN Zechariah see seven vision finish, many things come dey im mind. Jehovah promise am sey e go punish bad people. Wetin Jehovah tell Zechariah give am mind. But things never really change for Zechariah time. Bad people still full everywhere. And dem never build Jehovah temple for Jerusalem finish. All of dem run leave am. Wetin make the Jew people forget about Jehovah temple like that? Or dem come Jerusalem to do wetin go only favor theirself?
2 Zechariah know sey God people wey come from Babylon get faith. Bible show sey na Jehovah move dem. Na im make dem leave their house and the work wey dem dey do for Babylon. (Ezra 1:2, 3, 5) Even if dem don settle down for Babylon, dem comot go where many of dem never go before. Dem travel 1,000 miles (1,600 km) before dem reach Jerusalem. The road no good at all. If e no dey their mind to go build Jehovah temple again, you think sey dem for waka this kind waka?
3, 4. Wetin be the problem wey God people face?
3 How the journey be for dem? The road to Jerusalem far well well. So as dem dey go, dem fit dey think about Jerusalem and dey talk about how e be. Some of dem wey don old tell dem how Jerusalem and the temple fine before. (Ezra 3:12) If to sey you dey there, wetin for come your mind when you see how Jerusalem be? You for put hand for head when you see all the house wey dem scatter? You for open mouth when you see as grass cover everywhere? Since the wall for Jerusalem don scatter finish, you for dey think of the big and strong wall wey dey Babylon? Wetin you for do when you see sey the gate and where watchman dey stay don scatter? E for pain you sey you go? But e no pain God people sey dem go Jerusalem. Dem see how Jehovah take protect dem reach there. The first thing wey dem do as dem reach Jerusalem na to build altar for where the temple first dey. Dem come dey make sacrifice give Jehovah everyday. (Ezra 3:1, 2) Wetin dem do show sey dem ready to put body for God work. E just be like sey nothing fit stop dem.
4 No be only God temple dem get to build. Dem go build the city again, dem go build their house, make farm and find food for their family. (Ezra 2:70) E just be like sey the work big pass dem. E no tey their enemy come dey worry dem. Dem worry dem for 15 years. God people first stand their ground, but later dem come dey draw body comot for the work. (Ezra 4:1-4) For 522 B.C.E., Persia king stop their work. E just be like sey hope no dey again.—Ezra 4:21-24.
5. Wetin Jehovah do to help im people go back go finish im work?
5 Jehovah know wetin im people need. So Jehovah come show Zechariah one last vision to help im people. The vision help Jew people know sey Jehovah love dem and e like wetin dem don do for am before. E still help dem know sey Jehovah go protect dem if dem go back go finish im work. E tell dem sey: ‘E go happen if una do wetin Jehovah wey be una God talk.’—Zech. 6:15.
ANGELS WEY READY FOR WAR
6. (a) Wetin Zechariah see for the last vision? (Go check the first picture.) (b) Why the horse get different color?
6 The eight vision wey Zechariah see na im give God people mind pass. And na this one be the last vision. (Read Zechariah 6:1-3.) Make we sey na you and Zechariah dey see the vision as e dey happen: Four chariot ‘dey come from the center of two mountain. And na copper dem take make the mountain.’ E be like sey dem prepare the chariot (horse wey get wetin dem take dey carry person) for war. E easy to know the chariot and who dey ride am because the horse get different different color. Zechariah come ask sey, ‘wetin be this?’ (Zech. 6:4) We self want know wetin e be because this vision concern us.
Jehovah still dey use angels protect and help im people
7, 8. (a) Wetin be the two mountain? (b) Why dem use copper take make the two mountain?
7 Sometimes when Bible talk about mountain, e dey talk about kingdom or government. The two mountain wey Zechariah see still be like the one wey Daniel see. One of the mountain show sey na Jehovah be the King wey high pass and wey go rule forever. The other mountain dey show the Kingdom wey Jehovah put for Jesus hand. (Dan. 2:35, 45) Jesus start to rule for 1914. And since then, this two mountain dey work together. Dem dey make wetin God get for mind for this earth happen.
8 Why dem use copper take make the mountain? Copper get value well well. Jehovah tell Israel people sey make dem use copper take make the tabernacle (where dem dey worship am). Dem still use copper take build Jehovah temple for Jerusalem. (Ex. 27:1-3; 1 Ki. 7:13-16) So the copper wey dem take make the two mountain dey show sey Jehovah and Jesus na better King. When dem start to dey rule, dem go protect everybody and people go enjoy plenty better things.
9. Who be the chariot and the people wey dey ride dem? And which work dem give dem?
9 Wetin the chariot and the people wey dey ride dem mean? Dem be angels. And e be like sey dem dey different different group. (Read Zechariah 6:5-8.) Dem first stand for where ‘the Lord wey get the whole earth’ dey. From there, dem send dem go do one special work for different different area. Which work be that? Na to protect Jehovah people, especially from Babylon hand. Na Babylon be ‘the land wey dey north’ wey Zechariah see for vision. Jehovah go make sure sey Babylon no go take im people do slave again. When the people wey dey build the temple hear this one, their mind come down! Dem no go fear again sey their enemy go stop the work.
10. How Zechariah vision fit help us today?
10 Jehovah still dey use angels protect and help im people. (Mal. 3:6; Heb. 1:7, 14) Since 1919 when Jehovah people comot from fake religion hand, nobody don fit stop the work wey dem dey do even though sey people suffer dem. (Rev. 18:4) We no go ever enter fake religion hand again because Jehovah angels dey protect us. (Ps. 34:7) Instead, we go continue to put body for the work and belle go dey sweet us as we dey serve Jehovah. Zechariah vision make us dey sure sey the two mountain dey protect us.
11. Why Jehovah people no go fear even when government for this world gather to fight dem?
11 Government for this world go soon join hand together to destroy God people. (Ezek. 38:2, 10-12; Dan. 11:40, 44, 45; Rev. 19:19) Ezekiel talk sey all of dem wey join hand together full everywhere for this earth like cloud. Dem dey ontop horse and dem dey vex come fight God people. (Ezek. 38:15, 16)a We go shake? For where! Jehovah angels dey our back. For great tribulation, Jehovah go use angels take protect im people. But e go destroy people wey no support am as King. (2 Thess. 1:7, 8) That day go sweet! But who go dey control the angels like army?
JEHOVAH MAKE PRIEST BECOME KING
12, 13. (a) Wetin Jehovah sey make Zechariah do? (b) Explain how Jesus take be The Person wey go grow come out.
12 Na only Zechariah see the eight vision. But e come do something wey other people see. This thing wey e do go help the people continue to build the temple. (Read Zechariah 6:9-12.) Jehovah tell Zechariah make e collect gold and silver from three men wey just come from Babylon. Their name na Heldai, Tobijah, and Jedaiah. Zechariah go use the gold and silver take make ‘better crown.’ (Zech. 6:11, ftn.) Who Zechariah give the crown? Na Zerubbabel wey be governor of Judah and wey come from David family? No. Instead, Zechariah put am for Joshua head, wey be High Priest. Wetin e do fit surprise the people wey see am.
13 The crown wey dem wear Joshua make am king? No. Joshua no fit be king because e no come from David family. The crown wey dem put for im head only show wetin go happen for front. E show when Jesus Christ wey be High Priest become King. Bible talk about The Person wey go grow come out. Na Jesus be this person wey grow come out, or wey come from David family. And Jehovah go make Jesus Kingdom last.—Isa. 11:1; Matt. 2:23, ftn.
14. As Jesus be King and High Priest, which work e go do?
14 Jesus na King and High Priest. Na im dey control or direct Jehovah angels. E dey make sure sey e protect Jehovah people for this wicked world. E no dey take this im work play. (Jer. 23:5, 6) Because Jesus dey support God government, e go soon destroy bad government and save Jehovah people. (Rev. 17:12-14; 19:11, 14, 15) But before Jesus go destroy dem, e get one big work wey e go do.
E GO BUILD THE TEMPLE
15, 16. (a) How Jehovah take clean im people for our time, and who e use? (b) Wetin go happen when Jesus don rule for 1,000 years?
15 Apart from sey Jesus na King and High Priest, na im go still ‘build Jehovah temple.’ (Read Zechariah 6:13.) The work wey Jesus do for 1919, be like the work wey God people do for the temple that time. Na that year Jesus comot Jehovah people from fake religion hand (Babylon the Great). E make sure sey dem come serve God the way im want. E still choose ‘the slave wey get sense and wey dem fit trust’ make e dey direct wetin dey happen for Jehovah organization. (Matt. 24:45) Jesus never stop to clean God people, and e dey make sure sey dem continue to serve God as e want.—Mal. 3:1-3.
16 The people wey go rule with Jesus as king and priest for one thousand years, na 144,000 people. Dem go comot sin from human being body. When dem don do that one finish, na only people wey dey serve God go remain for this earth. At last, everybody go come dey serve God the way e want!
PUT HAND FOR THE WORK
17. Wetin Jehovah promise im people wey give dem hope? And how the message take help dem?
17 How Zechariah message take help God people that time? Jehovah promise dem sey e go protect and help dem so that dem fit build the temple finish. This one give dem hope. But since dem no many, how dem go take do the work? Wetin Zechariah come tell dem again, give dem mind. Apart from Heldai, Tobijah, and Jedaiah, Jehovah talk sey other people go join dem build the temple. (Read Zechariah 6:15.) The people come know sey Jehovah dey their back. Dem come continue to build the temple even though government stop the work. Jew people think sey dem no go fit build the temple finish. But Jehovah help im people, and dem finish the work for 515 B.C.E. (Ezra 6:22; Zech. 4:6, 7) But, wetin Jehovah talk still dey happen for our time.
Jehovah no go ever forget the things wey we dey do to show sey we love am! (Check paragraph 18, 19)
18. How Zechariah 6:15 take dey happen for our time?
18 Many people dey serve Jehovah today. E dey come from their heart to use the ‘better things’ wey dem get for Jehovah work. Dem dey use their time, their power, and their money take do Jehovah work. (Prov. 3:9) Wetin make us dey sure sey Jehovah value wetin we dey do for am? No forget sey na Heldai, Tobijah, and Jedaiah bring wetin Zechariah take make the crown. Jehovah talk sey dem go ‘use the crown take dey remember’ wetin dem do to support im work. (Zech. 6:14; ftn.) Na so e still be today. Jehovah no go ever forget wetin we do for am and how we take show sey we love am.—Heb. 6:10.
19. How Zechariah vision fit help us today?
19 For this last days, Jehovah people don do many things to support Jehovah work. And dem fit do this things because Jehovah dey bless dem and Jesus dey direct their work. Jehovah organization no dey shake, Jehovah go protect am and e go last forever. We happy sey we dey the organization. Everybody go soon dey worship only Jehovah and na wetin Jehovah want be that. No stop to do wetin you dey do to support Jehovah organization, and ‘do wetin Jehovah talk.’ This one go make Jesus and the angels dey protect you. Do everything wey you fit do to support Jehovah work. As you dey do like that, Jehovah go continue to protect you forever!