Make We Dey Encourage People Like Jehovah
“Make una praise the God . . . wey dey tell us better word anytime wey we dey for wahala.”—2 COR. 1:3, 4, ftn.
1. When Adam and Eve sin, wetin Jehovah talk to give their children hope?
JEHOVAH na God wey dey use better word help person. E don dey do this one since Adam and Eve sin. After Adam and Eve do wetin God sey make dem no do, Jehovah come quick make one promise for Genesis 3:15. Wetin dey that Bible verse go give human being hope, once dem understand am. That place show sey dem go destroy Satan the Devil and all the bad things wey e don do.—Rev. 12:9; 1 John 3:8.
JEHOVAH ENCOURAGE IM SERVANTS
2. How Jehovah take give Noah strong mind?
2 Make we talk about how Jehovah take use better word help Noah. The people for Noah time no dey worship Jehovah. Dem dey put hand for sex matter wey bad for Jehovah eye and katakata full everywhere. Na only Noah and im family dey serve Jehovah. Things wey dey happen that time fit don make Noah tire. (Gen. 6:4, 5, 11; Jude 6) But Jehovah tell Noah wetin give am mind, and wey make am continue to ‘follow God waka.’ (Gen. 6:9) Jehovah tell Noah sey e want destroy all the bad people. E still tell am wetin e go do to save im and im family. (Gen. 6:13-18) Jehovah really show Noah sey im na God wey sabi make person mind strong.
3. Wetin Jehovah tell Joshua wey give am mind? (Go check the first picture.)
3 Joshua na another person wey Jehovah tell wetin give am mind. God choose am to carry im people enter Promise Land. And e go still need to fight and win the people wey dey stay the land. This work no easy for Joshua at all. Jehovah know sey e get many things wey fit make Joshua fear. Na this one make am tell Moses to make Joshua oga and encourage am, so that im mind go strong. (Deut. 3:28) Before Joshua start this work, Jehovah tell am sey: “I don tell you sey make you get strong mind. No let anything make you fear because Jehovah your God dey with you, anywhere wey you go.” (Josh. 1:1, 9) You no think sey this word go don give Joshua mind?
4, 5. (a) How Jehovah take use better word help im people? (b) How Jehovah take give im Son mind?
4 Jehovah encourage im people one one. Apart from that one, e still encourage dem together. When dem carry Jew people go Babylon, Jehovah tell dem wetin go make their mind come down. E tell dem sey: “No fear because I dey with you. No worry because I be your God. I go make you strong, yes, I go help you, I go really hold you with my right hand wey good.” (Isa. 41:10) Later Jehovah still use better word help Christians for apostle time. And na so Jehovah still dey do today.—Read 2 Corinthians 1:3, 4.
5 Jehovah tell im Son better word wey help am. When Jesus baptize, e hear one voice from heaven wey talk sey: “Na my Son be this, wey I choose. I like am well well.” (Matt. 3:17) You no think sey this word go don give Jesus mind to do the work wey im Father give am?
JESUS USE BETTER WORD HELP PEOPLE
6. How the story wey Jesus talk take help im disciples?
6 Jesus copy im Father example. E tell people better word wey help dem continue to serve Jehovah. E do this one for one of the story wey e talk. The story na about one man wey give some of im servant money. For the end of the story, the man praise the ones wey do well sey: “Well done, better slave wey dem fit trust! As you show sey dem fit trust you for small thing, I go put many things for your hand. Come follow your oga enjoy.” (Matt. 25:21, 23) This word wey Jesus talk help im disciple continue to serve Jehovah well.
7. Wetin Jesus tell im apostle, especially Peter, to help dem?
7 Many times, Jesus apostle argue with each other. Dem dey drag for who better pass. Jesus sofri use better word correct dem many times. E tell dem sey make dem no dey do like oga. Instead, make dem dey carry body down like slave. (Luke 22:24-26) Peter make mistake many times, and e do wetin for make Jesus vex for am. (Matt. 16:21-23; 26:31-35, 75) But Jesus no drive Peter comot. Instead, e tell am wetin help am, and e even send am go help other people.—John 21:16.
PEOPLE WEY USE BETTER WORD FOR BIBLE TIME
8. How Hezekiah take help im men and im people?
8 E don tey wey Jehovah people know sey dem suppose to dey use better word help each other. And dem don dey do am even before Jesus come show people how to do am. When Assyria people dey plan to attack Judah, Hezekiah tell im men and im people wetin help dem get mind. Bible tell us sey “all the people come stop to dey fear as dem hear wetin Hezekiah” talk.—Read 2 Chronicles 32:6-8.
9. Wetin Job story teach us about how to use better word help person?
9 Job na another better example. Even though sey e need person wey go encourage am, e still show other people how to encourage person. E get some people wey sey dem come encourage Job. But e tell dem wetin e for do if to sey na dem dey suffer like am. E sey: ‘I go use wetin I dey talk with my mouth take make una strong, and wetin I go talk with my mouth go make una mind come down.’ (Job 16:1-5) At last, na Elihu and Jehovah come tell Job wetin make im mind come down.—Job 33:24, 25; 36:1, 11; 42:7, 10.
10, 11. (a) Why Jephthah pikin need better word? (b) Which kind people need better word today like Jephthah pikin?
10 Jephthah pikin na another person wey need better word. Jephthah promise Jehovah sey if e help am win Ammon people, e go give am the first person wey come welcome am. E sey the person go dey serve Jehovah for im tabernacle. Jehovah help Jephthah win, but the first person wey come welcome am na im only pikin. This thing pain Jephthah reach bone. But e do wetin e promise Jehovah. E send im daughter go serve Jehovah for tabernacle wey dey Shiloh. And the pikin no go ever comot for there.—Judg. 11:30-35.
11 E no easy for Jephthah to do wetin e promise Jehovah. But e be like sey na im pikin e hard for pass. Even with this one, e ready to do wetin im papa promise. (Judg. 11:36, 37) This one mean sey Jephthah pikin no go marry, or born pikin. E no go get pikin wey go bear im papa name or inherit im property. So Jephthah pikin really need better word wey go help am and make im mind come down. Bible tell us sey four days every year, the young women for Israel dey go greet am and tell am better word. (Judg. 11:39, 40) Today, we get brothers and sisters wey never marry, and dem dey use their time put body for Jehovah work. You no think sey e good make we dey tell dem better word wey go help dem?—1 Cor. 7:32-35.
JESUS APOSTLE TELL OTHER PEOPLE BETTER WORD
12, 13. How Peter take ‘make im brothers strong’?
12 The night before dem kill Jesus, e tell Peter sey: “Simon, Simon, look! Satan want shake una as dem dey shake wheat. But I don pray for you so that you no go stop to get faith. When you come back, make your brothers strong.”—Luke 22:31, 32.
The letter wey the apostle dem write encourage the brothers for their time and e still dey encourage us today (Check paragraph 12-17)
13 Apostle Peter dey among the people wey dey direct Christian for im time. (Gal. 2:9) Wetin Peter do for the day of Pentecost and after that day, show sey e get mind. Im better example come make the brothers get strong mind. After Peter don preach for many years, e write letter give the brothers and sisters for im time. And e tell dem why e write the letter. E sey: ‘I write una this small letter to encourage una, and to really let una know sey this one na God favor true true. Make una stand well for inside.’ (1 Pet. 5:12) The letter wey apostle Peter write help brothers and sisters for im time. And e still dey help us today. As we dey wait for God to do wetin e promise, we really need to hear that kind better word to encourage us.—2 Pet. 3:13.
14, 15. How the things wey apostle John write take encourage Christian from im time come reach today?
14 Apostle John still dey among the people wey dey direct Christians for im time. The way e take write the story about Jesus dey sweet person to read. The book wey John write for Bible don encourage people for im time come reach our time. For example, John tell us wetin Jesus talk when e sey na love go make people know who really be im disciple. Na only John write this thing wey Jesus talk.—Read John 13:34, 35.
15 Other better better things still dey for the three letter wey John write. For example, when the bad thing wey we do dey worry us for mind, our mind dey come down when we read for Bible sey “the blood of . . . Jesus go make us clean from all sin.” (1 John 1:7) And if our mind still dey worry us, when we read the place for Bible wey talk sey “God know our mind pass us,” this one go make our mind come down. (1 John 3:20) Na only apostle John talk for Bible sey “God na love.” (1 John 4:8, 16) The second and third book of John dey praise Christian wey “dey follow the truth.”—2 John 4; 3 John 3, 4.
16, 17. How apostle Paul take encourage the brothers?
16 Another person wey encourage the brothers and sisters na apostle Paul. After Jesus die, many of im apostle stay for Jerusalem, and na there the governing body dey. (Acts 8:14; 15:2) The brothers wey dey Judea dey preach to people wey already believe sey na one God dey. But God use im holy spirit send Paul to go preach to Greek people, Rome people and many other people wey dey serve different different god.—Gal. 2:7-9; 1 Tim. 2:7.
17 Paul travel go preach for different place. E preach for the country wey dem dey call Turkey now. E still preach for Greece and Italy. E preach to people wey no be Jew, and e form different congregation for all this place. Life no easy for this people wey just become Christian. People for their place suffer dem well well. So this brothers need something wey go make their mind come down. (1 Thess. 2:14) Around 50 C.E., Paul write letter to the brothers for the new congregation for Thessalonica. E tell dem sey: “We dey always thank God when we mention all of una for our prayer, because we dey always remember una better work, the work wey una dey do because of love, and the way una dey endure.” (1 Thess. 1:2, 3) E still sey: “Make una continue to dey support each other and dey make each other strong.”—1 Thess. 5:11.
GOVERNING BODY ENCOURAGE BROTHERS
18. How the governing body take encourage Philip?
18 For apostle time, Jehovah use the governing body take encourage all the brothers and sisters and even people wey dey direct the work. For example, the governing body support Philip when e go preach to Samaria people about Jesus Christ. The governing body send Peter and John wey be their member to go help the brothers wey just become Christian. Peter and John pray for dem so that dem go get holy spirit. (Acts 8:5, 14-17) Philip and the brothers wey just become Christian go don happy well well sey the governing body help dem.
19. How the brothers feel when the letter wey governing body write reach their hand?
19 Later, e come get one matter wey the governing body need to handle. Dem come dey think am if the brothers wey no be Jew need to circumcise as Moses Law talk. (Acts 15:1, 2) The governing body pray about this matter and dem sofri check wetin God Word talk about am. God holy spirit come help dem see sey the brothers no need to circumcise. Dem come write this thing put for letter, and send some brothers to go give the congregation dem. How the brothers feel when the letter reach their hand? Bible sey: “After dem read am, dem happy well well sey the letter encourage dem.”—Acts 15:27-32.
20. (a) How Governing Body take dey encourage all of us? (b) Which question we go answer for the next topic?
20 Governing Body today dey encourage Bethelites, people like special pioneer, missionary, and even all of us. This one dey make us happy like the brothers for apostle time. For 2015, Governing Body release one book wey dem dey call Return to Jehovah. This book don really encourage many brothers and sisters. But na only people like elders go fit encourage other people? We go answer this question for the next topic.