August 1-7
PSALM 87-91
Song 49 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“Stay for the Secret Place of Jehovah”: (10 min.)
Ps 91:1, 2—Jehovah “secret place” dey protect people wey dey serve am from many things wey fit make dem no serve am well (w10 2/15 26-27 ¶10-11)
Ps 91:3—As hunter wey dey catch bird dey set trap to catch am, na so Satan dey set trap to catch us (w07 10/1 26-30 ¶1-18)
Ps 91:9-14—Na Jehovah dey protect us (w10 1/15 10-11 ¶13-14; w01 11/15 19-20 ¶13-19)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
Ps 89:34-37—Which promise this Bible verse dey talk, and how Jehovah take show sey e no go fail? (w14 10/15 10 ¶14; w07 7/15 32 ¶3-4)
Ps 90:10, 12—How we go fit ‘count our days well, so that we fit get sense’? (w06 7/15 13 ¶4; w01 11/15 13 ¶19)
Wetin I learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Wetin I learn from the place wey we read for Bible this week wey I fit use for preaching?
Bible Reading: (No pass 4 min.) Ps 90:1-17
MAKE YOU DEY PREACH WELL
Prepare How You Go Take Give People Book This Month: (15 min.) Talk am together. Play the video wey show the example wey we fit follow and talk about am. Tell all the publisher sey e good make dem try write as dem go take do their own if dem go preach.
MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Song 141
Congregation matter: (5 min.)
“Wetin We Go Do to Make How We Dey Preach Better —Help Bible Student Make Dem Give Their Life to Jehovah and Baptize”: (10 min.) Talk am together. Interview publisher wey don help person grow reach to baptize. Ask am: How you take help your Bible student love Jehovah from im mind? How you take help am make sure sey e reach target wey e set to serve Jehovah well?
Congregation Bible Study: (30 min.) ia chap. 21 ¶1-12
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (3 min.)
Song 137 and Prayer