Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 September p. 3
  • ‘Follow Jehovah Law’

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • ‘Follow Jehovah Law’
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 September p. 3

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | PSALM 119

‘Follow Jehovah Law’

To follow Jehovah law mean sey we go bring ourself down and let Jehovah guide everything wey we dey do. For inside Bible, we get many better example of people wey trust Jehovah law and follow am, like the person wey write Psalm 119.

The person wey write psalm dey use stick waka

If we follow God law, we go dey happy

119:1-8

Joshua dey read scroll

Joshua show sey e really trust Jehovah to guide am well. E know sey e go happy and everything wey e dey do go get head, if e trust Jehovah with all im mind

When we dey face wahala, Bible fit give us the kind mind wey we need to bear am

119:33-40

Jeremiah dey pray

When Jeremiah dey for inside wahala, e show sey e get mind and trust Jehovah. E make im life simple and continue to dey do the work wey God give am

We go get mind to preach if we sabi wetin dey inside Bible well well

119:41-48

Paul dey preach to Governor Felix

Paul no fear to tell anybody about God message. E no fear to preach to Governor Felix, because e know sey Jehovah go help am

The person wey write psalm dey use stick waka

Where I fit really show sey I get mind to tell people about Jehovah?

  • School

  • Work

  • Family

  • Other

Dem arrange Psalm 119 for the way dem take dey write ABC for Hebrew. Maybe dem write am like this so that e go dey easy to remember. Dem divide am into 22 part and na 8 verse dey for each part. Since na 22 letter dey for Hebrew ABC, and na 176 verse dey for Psalm 119, e mean sey na im long pass all the chapter wey dey the Bible book of Psalms.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share