September 19-25
PSALMS 135-141
Song 59 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“The Way God Make Us Good Finish”: (10 min.)
Ps 139:14—If we dey think about the things wey Jehovah make, e go move us to dey praise am more more (w07 6/15 21 ¶1-4)
Ps 139:15, 16—All the gene and cell wey dey inside our body dey show us the kind power and the kind sense wey Jehovah get (w07 6/15 22-23 ¶7-11)
Ps 139:17, 18—Human being dey special for the way dem take sabi language and the way dem take dey think (w07 6/15 23 ¶12-13; w06 9/1 16 ¶8)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
Ps 136:15—How this Bible verse take help us sabi wetin dey the book of Exodus more more? (it-1 783 ¶5)
Ps 141:5—Wetin King David come know? (w15 4/15 31 ¶1)
Wetin I learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Wetin I learn from the place wey we read for Bible this week wey I fit use for preaching?
Bible Reading: (No pass 4 min.) Ps 139:1-24
MAKE YOU DEY PREACH WELL
First Time: (No pass 2 min.) wp16.5 16
Return Visit: (No pass 4 min.) wp16.5 16—Invite the person come meeting.
Bible Study: (No pass 6 min.) fg lesson 8 ¶8—Help the student so that e go fit practice wetin e learn.
MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Song 57
“No Enter This Trap When You Dey Conduct Bible Study”: (15 min.) After una don talk everything wey dey under this topic finish, play the two video wey show the good way and the bad way to take teach person with Bible Teach book page 29, paragraph 7. Make everybody bring their own Bible Teach book come and make dem follow as the video dey play. Remind people wey dey get assignment for meeting sey if dem no enter this kind trap, dem go fit finish their assignment before their time go finish.
Congregation Bible Study: (30 min.) kr A Letter From the Governing Body and chap. 1 ¶1-10
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (3 min.)
Song 30 and Prayer