Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 October p. 5
  • Good Sense Better Pass Gold

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Good Sense Better Pass Gold
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 October p. 5

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | PROVERBS 12-16

Good Sense Better Pass Gold

Printed Edition
Scale wey get scroll wey heavy pass gold

Wetin make the kind sense wey God dey give good well well? E dey help person make e no dey do bad things and e dey protect im life. E dey show for the person body, im character, the way e dey talk, and the way e dey do things go better.

Good sense dey help person make e no dey carry shoulder up

16:18, 19

  • One man wey dey carry shoulder up

    Person wey get sense sabi sey na only Jehovah dey give people sense

  • We suppose dey sofri watch ourself make we no start to dey carry shoulder, especially people wey the things wey dem dey do dey get head or people wey get many work for congregation

Good sense dey help person talk better word

16:21-24

  • One man dey talk and another one dey listen

    Person wey get sense dey use im deep sense to see the good things wey other people dey do and e dey talk good things about dem

  • Word wey person use sense talk dey move people to do wetin dem hear, e dey sweet like honey, no be the kind word wey dey pain or wey fit cause quarrel

YOU KNOW?

A honeycomb

Honey dey quick work for our body, and e dey quick give us power. People like am well well because e sweet for mouth and e dey cure sickness.

Better word dey help person get power more more to fit dey serve God, just as honey take dey give our body power.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share