Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 October p. 4
  • Wetin You Go Do If You Want Dey Give Better Answer for Meeting

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin You Go Do If You Want Dey Give Better Answer for Meeting
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • Similar Material
  • How We Go Take Ready Well Well Before We Go Our Meeting?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 October p. 4

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

Wetin You Go Do If You Want Dey Give Better Answer for Meeting

One boy dey raise im hand for Watchtower Study, one sister dey answer question for Watchtower Study

Better answer wey we dey give dey help congregation grow. (Ro 14:19) E still dey help the person wey dey talk am. (Pr 15:23, 28) Na im make e good make we dey try answer at least one question everytime wey we come meeting. Na true sey no be everytime wey we raise our hand dem go call us. So e better make we ready ourself to answer different different question.

Better answer . . .

  • dey simple, e clear and e dey short. Many times, you fit talk am finish for 30 seconds or e fit no even reach

  • dey sweet well well when you talk am as you take understand am

  • no be to dey talk wetin another person don talk before

If na you dem first call . . .

  • answer the question direct and make e dey simple

If dem don answer the question, you fit still . . .

  • show how the Bible verse wey dem write for the paragraph take match the point wey we dey talk about

  • talk how the matter take concern our life

  • explain how we go fit use wetin we don learn

  • talk one short life story wey get better point

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share