BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | PROVERBS 27-31
Bible Talk About Woman Wey Be Better Wife
Proverbs chapter 31 get strong message wey King Lemuel mama tell am. The better advice from im mama help am know how e go take sabi better wife.
Better wife na person wey you fit trust
31:10-12
When dem want choose wetin their family go do, e dey bring better idea and e dey support wetin im husband choose
Im husband dey trust anything wey e choose to do, e no dey talk sey im wife must tell am everything before e do am
Better wife dey work hard
31:13-27
E sabi manage things and e dey live simple life so that im family go fit wear better cloth, and see food chop
E dey work hard and e dey take care of im family everytime
Better wife like to dey serve God well
31:30
E dey serve God well and e get better friendship with God