Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 December p. 3
  • ‘Come Make We Go Up to Jehovah Mountain’

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • ‘Come Make We Go Up to Jehovah Mountain’
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 December p. 3

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | ISAIAH 1-5

‘Come Make We Go Up to Jehovah Mountain’

2:2, 3

‘For last days’

Last days na this our time wey we dey live now

‘The mountain of Jehovah house’

The correct way to worship Jehovah

‘And na there people from all the different different country go dey gather theirself go’

People wey dey worship Jehovah for the correct way dey do am with one mind

‘Come make we go up to Jehovah mountain’

People wey dey worship Jehovah for the correct way dey invite other people to come join dem

‘E go teach us im way, and we go waka for im road’

Jehovah dey use im word teach us and help us to fit waka for im road

People from different different country go gather theirself for Jehovah mountain

2:4

‘And dem no go learn how to fight war again’

Isaiah talk about how the things wey dem take dey fight war go turn to wetin dem take dey work for farm, this one show sey Jehovah people go get peace. Wetin be the things wey Isaiah talk about?

‘Sword go turn to plowshare’

1 Plowshare na one part for plow wey dem dey use dig ground. Dem dey use iron make some of dem.—1Sa 13:⁠20

‘Spear go turn to pruning shear’

2 E fit be sey pruning shear na the kind knife wey curve and e get handle. Dem dey use am cut fruit wey dey on top tree.—Isa 18:5

Sword and spear
Plowshare and pruning shear
    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share