January 9-15
ISAIAH 29-33
Song 123 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“One King Wey Go Do Good Go Rule”: (10 min.)
Isa 32:1—The King wey go do good as e dey rule na Jesus Christ (w14 2/15 6 ¶13)
Isa 32:2—Jesus wey be King go choose people wey go take care of im sheep (ip-1 332-334 ¶7-8)
Isa 32:3, 4—Jehovah dey train and teach im people so that dem go fit dey do good (ip-1 334-335 ¶10-11)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
Isa 30:21—How Jehovah take dey talk to im people? (w14 8/15 21 ¶2)
Isa 33:22—When and how Jehovah take be Judge, Person wey dey give Law and King for Israel people? (w14 10/15 14 ¶4)
Wetin I learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Wetin I learn from the place wey we read for Bible this week wey I fit use for preaching?
Bible Reading: (No pass 4 min.) Isa 30:22-33
MAKE YOU DEY PREACH WELL
First Time: (No pass 2 min.) wp17.1 cover—How you go take answer person wey dey vex.
Return Visit: (No pass 4 min.) wp17.1 cover—Read Bible from phone or small computer.
Bible Study: (No pass 6 min.) lv 31-32 ¶12-13—Show how person fit reach Bible student mind.
MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Song 119
‘Place Wey Person Fit Hide From Heavy Breeze’ (Isa 32:2): (9 min.) Play this video ‘Place Wey Person Fit Hide From Heavy Breeze’.
Listen When You Dey Meeting: (6 min.) Play this video Listen When You Dey Meeting. After, call some children wey you don choose come platform and ask dem this question: Wetin fit make you no listen for meeting? Wetin for happen to Noah if to sey e no listen when Jehovah dey tell am how e go take build the ark? Why e good make children dey listen when dem dey meeting?
Congregation Bible Study: (30 min.) kr chap. 6 ¶16- 24 and the box “How Real Is the Kingdom to You?”
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (3 min.)
Song 40 and Prayer