BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | ISAIAH 29-33
‘One King Wey Go Do Good Go Rule’
Jesus, wey be King, go choose people or elders wey go take care of im sheep
32:1-3
Like ‘place where person fit hide when heavy rain dey fall,’ elders dey do everything wey dem fit do to support Jesus sheep when people dey suffer dem and when life don tire dem
Like ‘river for where water no dey,’ elders dey give people wey no really know God the correct truth wey dey Bible and dem dey help dem stand well for God side
Like ‘big rock wey dey for desert,’ elders dey use the better better things for Bible take dey guide Jesus sheep and make their mind come down